Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Mark 14

1 Tu days bifor Passova and di Bread wey nor get yist Fist, di prist oga dem and di law tishas kon dey faind as dem go tak arres Jisos, mak dem for kil-am.

2 Dem sey, "Mak wi nor du-am naw wen dem dey du di Fist, so dat pipol nor go rayot."

3 Wen Jisos dey Betani for Saimon haus (wey get leprosi bifor), e sidan wit dem to chop, naim won wuman bring oil insaid alabasta box kom, di oil dear wel-wel and dey sent fine. Afta e don opun di kontena, e pour di oil for Jisos head.

4 Bot som pipol wey dey der kon dey ves, dey tel ish oda, "Why dis wuman dey waste oil wey dear wel-wel laik dis?

5 "Dem for sel am pas tiri ondred (300) silva koins and giv di moni to poor pipol!" So, dem kon ves dey tok to di wuman enihaw.

6 Bot Jisos ansa dem, "Mak una liv di wuman alone. Why una dey wori-am? Na gud tin e du for mi so -o-o!

7 "Poor pipol go always dey wit una and una go fit du gud for dem enitaim una laik. Bot mi, I nor go dey wit una always!

8 "Dis wuman don du wetin e fit du. E anoint my bodi to priper mi for beria, bifor di taim go rish.

9 "I tel una tru wod, eniwer wey dem go prish dis gospol for di hol wold, pipol go tok abaut dis tin wey dis wuman don du so."

10 Den Judas Iskarot, wey dey among Jisos disaipols, kon go mit di prist oga dem sey e won sel Jisos giv dem.

11 Wen dem hear am, dem hapi wel-wel kon promis am moni. So, Judas kon bigin faind haw e go fit tak sel Jisos giv dem.

12 Di day wen dem start di Bread wey nor get yist fist and wey dem dey sakrifais smol ship, Jisos disaipols kon ask am, "Wer yu wont mak wi priper for yu to chop Passova fud?"

13 Jisos send tu disaipols go for front kon tel dem, "Wen una enta di tawn, una go si won man wey kari wota kontena. Mak una folo am.

14 "Di haus wey e go enta, mak una tel di pesin wey get-am sey, 'Di Tisha sey mak wi ask, "Wer di room wey mi and my disaipols go for chop Passova fud?"'

15 "E go show una won big room for upstair wer tabol and chairs dey. Mak una priper evritin for der."

16 So en disapols go di tawn and dem si evritin jos as Jisos tel dem sey e go bi, dem kon priper di Passova fud for der.

17 Wen evenin rish, Jisos kon go di haus wit en twef disaipols.

18 As dem dey chop for di tabol, Jisos kon sey, "I tel una tru wod, won of una wey dey chop wit mi, go sel mi giv my enimis."

19 Wetin Jisos tok kon dey wori di disaipols for maind, so dem kon dey ask am won by won, "Oga! Na mi?"

20 Jisos ansa, "Na won of una wey dey folo mi chop for di same plate.

21 "Man Pikin go die as dem rite for God wod abaut am, bot kos dey di pesin head wey go sel am. E for beta sey dem nor born dat pesin at-all."

22 As dem dey chop, Jisos tak bread, tank God, den divide am giv en disaipols kon sey, "Mak una tak and chop, bikos dis na my bodi."

23 Afta, e tak cup, tank God, den e giv en disaipols and all of dem, drink from insaid.

24 E kon tel dem, "Dis na my blood, di kovenant blood wey I pour for evribodi.

25 "I tel una tru wod, I nor go drink wine again, ontil di day wen I go drink di new wine for God Kindom."

26 Afta dem don sing won hymn, dem kon enta insaid Mount Olives.

27 Jisos kon tel en disaipols, "Una go run liv mi, bikos God wod sey, 'I go kil di pesin wey dey luk di ship and di ship go skata.'

28 "Bot afta God don wak mi up from deat, I go-go una front, go wait una for Galili."

29 Pita kon sey, "Ivun if odas run liv yu, I nor go run liv yu-o-o!"

30 Jisos ansa am, "I tel yu di trut, today, for dis nite, bifor fawo go du 'Kukuruku' tu taims, yu go don denai mi tiri taims."

31 Bot Pita stil sey, "Ivun if I go die wit yu, I nor go eva denai yu." All of dem stil tok di same tin.

32 Jisos and en disaipols kon go won place wey dem dey kol Getsemani and Jisos tel dem, "Mak una sidan for here, bikos I won go pray."

33 E tak Pita, James and Jon folo bodi. E maind kon dey trobol am and e nor dey hapi.

34 E kon tel dem, "My heart dey heavi wel-wel laik sey I won die. So, mak una stay here dey wosh."

35 E waka go front smol kon fal face groun, bigin pray, "Papa! If yu wont, mak yu let dis sofa pas mi."

36 Jisos kon pray, "My Papa, e nor get wetin Yu nor fit du. Mak Yu tak dis sofa cup from mi. Bot nor bi as I wont am, bot na as Yu wont."

37 Wen Jisos kom bak, e mit en disaipols dey slip, so e tel Pita, "Saimon, yu dey slip? Yu nor fit stay mak yu nor slip for won hour?

38 "Mak yu nor slip, bot dey pray mak yu nor for fal enta temtashon. Man spirit won pray, bot en bodi dey wik."

39 E komot again, go pray as e pray bifor.

40 Wen e kom bak again, e si sey dem stil dey slip; dem nor dey pray, so dem nor no wetin to tel am.

41 E kom di ted taim kon ask dem, "Una stil dey slip? Di slip don du, bikos taim don rish! Mak una si, dem don sel Man Pikin giv sinas.

42 "Mak una get up mak wi dey go. Si, di pesin wey won sel mi, dey kom!"

43 As Jisos stil dey tok, Judas, won of di twef disaipols, kon kom wit plenti pipol wey di prist oga dem, di law tishas and di eldas send and all of dem kari sword and big-big stik.

44 (By dis taim, di man wey won sel Jisos don giv dem sign sey, "Di pesin wey I go kiss, naim bi di man. Mak una arres and hol am wel-wel.")

45 Wen Judas kom, e go mit Jisos kon sey, "Tisha!", Den e kiss am.

46 So, di pipol kon seize and arres Jisos.

47 Won pesin wey stand for der kon tak en sword kut di High Prist savant ear komot.

48 Jisos kon tel dem, "Na mi una kari sword and big-big stik kom arres laik sey I bi tif?

49 "I dey wit una evriday for di Tempol dey tish, bot una nor arres mi den." Dis tin hapun so dat wetin dem rite for God wod, go bi tru.

50 Den all en disaipols kon run liv am.

51 Won young man wey tie smol klot for waist, dey folo Jisos. So dem won kon arres di man join,

52 bot e kon run komot wit nakednes and liv en klot for der.

53 Den, dem tak Jisos go mit di High Prist, so all di prist oga dem, di eldas and di law tishas kon gada.

54 Pita folo Jisos from far til e rish di High Prist varanda. E sidan wit di gaids dey warm en bodi near fire.

55 Di prist oga dem and di Sanhedrin dey faind wetin dem go tak akuiz Jisos, so dat dem go fit kil-am, bot dem nor si enitin.

56 Meni pipol lai for Jisos head and dem dey tok difren-difren tins, bot dia stori nor agri wit ish oda.

57 Som pipol stand-up kon lai against am sey,

58 "Wi hear wen e sey, 'I go distroi dis Tempol wey dem build wit hand and afta tiri days, I go build anoda won wey dem nor yuz hand build.'"

59 All dia stori nor mak sense, bikos dem nor agri wit ish oda.

60 Den di High Prist stand for dia front kon ask Jisos, "Yu nor get ansa? Wetin bi dis wey dem dey tok against yu so?"

61 Bot Jisos kwayet and e nor ansa dem. Den di High Prist kon ask am again, "Na yu bi Kraist wey bi God Pikin?"

62 Jisos ansa, "Na mi and yu go si Man Pikin sidan for God rite hand, wen e dey kom insaid di kloud from hevun."

63 Den di High Prist tear en own klot kon sey, "Why wi dey faind more pipol to tok for dis mata?

64 "Una don hear di wod wey e tok against God! Wetin una tink sey mak wi du-am?" Dem kon ansa, "E sopoz to die."

65 Den som bigin spit for Jisos bodi, dem tie en eye kon dey nak am dey sey, "Profesai naw!" Di pipol wey dey gaid di place stil join beat am.

66 For dis taim, Pita dey for di varanda, den di High Prist girl savant kom der.

67 Wen e si Pita sidan dey warm ensef, e luk am wel-wel kon sey, "Yu sef dey folo dat man wey kom from Nazaret, wey dem dey kol Jisos Kraist."

68 Bot Pita denai kon sey, "I nor ivun no wetin yu dey tok abaut!" Den e waka go di gate and fawo kon du, 'Kukuruku'

69 Wen di savant girl si-am, e kon dey tel di pipol wey stand der sey, "Dis man dey among dem."

70 Bot e denai again. Smol taim, di pipol wey stand for kona kon tel Pita, "Tru-tru, yu dey among dem, bikos na Galili yu from kom."

71 Pita kon bigin kos and swear sey. "I nor no dis man wey una dey tok abaut so-o-o!"

72 At wons, fawo kon du, 'Kukuruku' di sekon taim. So Pita kon rimemba wetin Jisos tel am sey: "Bifor fawo go du 'Kukuruku' tu taims, yu go denai mi tiri taims." Den Pita kon bigin krai wel-wel.

Open Bible reader