Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

John 20

1 For di first day for di wik, wen day neva break wel, Mary Magdalin kon go wer di grave dey. E si sey dem don rimov di stone wey dem tak kova di grave mout.

2 Den e run go mit Saimon Pita and Jon kon tel dem, "Sombodi don kari Jisos bodi komot from di grave and wi nor no wer dem put am."

3 So Pita and Jon kon go wer di grave dey.

4 Di tu of dem kon dey run togeda, bot Jon run pas Pita kon first am rish di grave.

5 E nor enta insaid di grave, bot e bend dan kon si di linen klot wey dem tak wrap Jisos bodi for groun insaid di grave.

6 Wen Saimon Pita rish der, e enta insaid di grave kon si di linen klot for groun tu.

7 Bot di smol klot wey dey for Jisos head nor dey for di same place wer di oda klot dey, e dey on en own for won kona.

8 Den Jon kon enta insaid and wetin e si kon mak am biliv.

9 (Bikos dem undastand God wod wey sey, Jisos go wak-up afta e die).

10 So di tu disaipol kon go bak to dia haus.

11 Bot Mary stand for outsaid di grave dey krai. As e stil dey krai, e kon bend dan luk insaid di grave.

12 Den e si tu angel wey wear white klot sidan for wer dem put Jisos bodi. Won dey for wer di head dey and di oda dey for wer di leg dey.

13 Dem kon ask am, "Wuman, why yu dey krai?" Mary ansa, "Dem don kari my oga komot and I nor no wer dem kari am go."

14 Afta e tok finish, e turn roun kon si Jisos stand for der, bot e nor no sey na Jisos bi dat.

15 Jisos tel am, "Wuman, why yu dey krai? Na hu yu dey faind?" Bikos Mary tink sey naim bi di gardina, e kon sey, "Oga, if na yu kari am komot, mak yu tel mi wer yu kari am go, so dat I go-go kari am."

16 Den Jisos kon kol am, "Mary". So, Mary turn roun face am kon kol am for Hebrew language, "Raboni" (wey min Tisha).

17 Jisos ansa am, "Mak yu neva tosh mi, bikos I neva go mit my Papa for hevun. Go mit my brodas, tel dem sey, "I dey go hevun go mit my Papa, wey bi yor Papa tu, my God, wey bi yor God tu."

18 Den Mary Magdalin go mit di disaipols for wer dem dey kon tel dem, "I don si di Oga!" Den e tel dem wetin Jisos tel am.

19 Dat evenin, for di first day for di wik, en disaipols kon gada togeda. Dem lock di door for di haus wey dem dey, bikos dem dey fear di Ju oga dem. Jisos stand among dem kon sey, "Mak peace dey wit una."

20 Wen e don tok finish, e show dem en hand and di kona of en bele wey dem tak spear shuk. Den di disaipols kon hapi wel-wel, wen dem si Jisos.

21 Den Jisos tel dem again, "Mak peace dey wit una. As my Papa send mi, na so I send una tu."

22 Wen e tok finish, e breat for dia bodi kon sey, "Mak una risiv di Holi Spirit.

23 "If una forgiv enibodi en sin, God go forgiv am, bot if una nor forgiv enibodi en sin, God nor go forgiv am."

24 For dis taim, Tomas (wey bi twins), won of di twef disaipols, nor dey der wen Jisos show ensef to dem.

25 Di oda disaipols kon tel am, "Wi don si Jisos." Bot e ansa dem, "Unles I si en tu hand wey dem nail kon put my finga insaid di hol wey di nail mak and shuk my hand insaid di hol wey dey en bele, I nor go eva biliv una."

26 Afta ate days, wen all di disaipols gada again insaid di haus and Tomas dey der wit dem dis taim, aldo dem lock all di doors, Jisos show ensef stand among dem sey, "Mak peace dey wit una."

27 Den e tel Tomas, "Put yor finga for my hand, mak yu tosh am. Stresh yor hand put insaid di kona for my bele. Mak yu nor dey doubt again, bot mak yu biliv."

28 Tomas kon ansa am, "O! My Oga and my God."

29 Den Jisos tel am, "So yu biliv naw, bikos yu don si mi? God go bless pipol wey neva tak eye si mi, bot dem biliv mi."

30 Jisos du meni mirakols wen e dey wit en disaipols wey dem nor rite for dis book.

31 Bot dis tins wey dem rite so, na mak una for biliv sey na Jisos bi di Kraist and naim bi Man Pikin and if una biliv am, una go get life tru en name.

Open Bible reader