Nigerian Pidgin Bible
Jude 1
1 Dis leta na from Jude, Jisos Kraist savant and James broda. To di pipol wey God don kol, wey Papa God luv don wrap laik klot for Jisos Kraist bodi.
2 Mak mesi, peace and luv dey wit una!
3 My frends, ivun doh e don dey hungri mi since to rite giv una abaut di salvashon wey wi dey share togeda, naw e strong wel-wel for my maind to rite, so dat una maind go dey strong. So una go fit stand fite for wetin wi biliv; di tins wey God don giv en pipol and nor-tin go fit shange am.
4 Som pipol don hide join una and God don mark dem for distroshon. So I won tel una abaut dis tins sey, dis pipol nor dey fear God. Dem don dey yuz God grace as eskuze to dey du bad-bad tins. Dis pipol nor gri asept Kraist as dia Masta and Oga.
5 So I won rimaind una ivun doh una don alredi no dis tins. Afta God don first save Izrel pipol from Egypt, e kon distroi doz wey nor biliv am.
6 And I stil dey rimaind una abaut di angels wey nor stay for wer God put dem, bot kon komot for wer dem sopoz dey. God don chain dem tie for daknes ontil wen E go joj di wold.
7 Mak una yuz Sodom and Gomora and di tawns wey dey near dem, as exampol. God ponish dem wit fire wey nor dey end, bikos both men and wimen dey slip wit ish oda enihaw, dem ivun dey slip wit animas and dem dey du oda wiked tins wey dey dia maind.
8 Laik dis tu, dis men wey sey dem dey dream, dey liv bad life, dem nor dey obey God autoriti and dem ivun dey kos angels wey get glori.
9 Bot wen Michael, di big angel dey kworel wit devol bikos of Mosis bodi, e nor kos am, bot insted, e sey, "Na God go joj yu!"
10 Bot dis pipol nor undastand wetin dem dey tok and dis na wetin dem sopoz to undastand witout sey pesin tish dem. As animas nor dey tink bifor dem du tins, na so dis pipol dey bihav.
11 Kos dey dia head! Bikos dem dey bihav laik Kain and bikos of long-trot, dem dey du di mistak wey Balaam du. So dem go must die laik Kora, wey disobey God.
12 Wen dis pipol dey folo una chop di feloship fud wey God don bless, dem bi laik shuku-shuku for una bodi. Dem bi laik shepad wey nor dey shame, wey kare for onli ensef. Dem bi laik kloud wey jos dey blow, bot rain nor dey fal. Dem bi laik tri wey nor get fruts and God don root dem komot from groun.
13 Dem bi laik wave for sea wey dey foam kom out. Dem bi laik star wey nor dey stay won place and God don kip di place wey deep pas for daknes, dey wait dem.
14 Enok wey bi di numba sevun pesin afta Adam, profesai abaut dis pipol. E sey, "Listin! Di Oga dey kom wit en holi pipol wey nobodi fit kount and
15 e dey kom joj evribodi, so dat pipol go no di bad tins wey dem dey du and di wiked wods wey sinas don tok against God.
16 Dis pipol dey komplain waka and dey faind fault. Dem dey go eni wer wey dia bodi kari dem go and dem dey boast. Dem dey tok wetin pipol laik to hear, so dat odas go praiz dem.
17 Bot my frends wey I luv, mak una rimemba wetin awa Oga Jisos apostols tel una.
18 Dem sey, "For di taim wen dis wold won end, som pipol go dey laff una and di tins wey God hate wey dey hungri dem to du, naim go dey push dem."
19 Dis kaind pipol dey divide God pipol; dem laik dis wold tins and dem nor get God Spirit.
20 My frends, mak una dey build unasef up wit fate wey holi wel-wel and dey pray wit di Holi Spirit.
21 Mak una kip unasef insaid God luv as una dey wait for awa Oga Jisos Kraist, wey go bring life wey nor go end.
22 And mak wi help doz wey dia fate dey shake.
23 Mak una help odas mak dem nor enta hell fire, so dat una go fit save dem and as una dey help odas, mak una dey fear God kon hate di tins wey go mak una sin.
24 Naw, mak all glori bi God own, bikos E nor let una fal and E go bring una kom en present wit beta joy and witout fault.
25 Mak all glori, majesti, pawa and autoriti, bi God own, naw and foreva tru Kraist wey bi awa Oga. Amen!