Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Acts 27

1 Wen dem don gri sey wi go travol insaid ship go Itali, dem kon kari Pol and som oda prizinas giv Julius, won komanda wey dey Augustan grup.

2 Wi enta won ship from Adramyttium wey won travol go difren place for Asia sea kon bigin travol go Aristakus and won Masidonia man wey dey stay Tesalonika, folo us.

3 Di next day, wi enta Sidon and Julius kon du gud giv Pol, e alow am go mit en frends mak dem giv am all di tins wey e nid.

4 From der, wi enta wota travol again face Syprus island, bikos briz dey blow di ship.

5 Afta wi don travol enta di opun sea wey dey insaid Silicia and Pamfilia, wi kon stop for Myra, wey dey Lycia.

6 For der, di soja komanda kon si won ship wey kom from Alexandria dey driv go Itali and e kon put us for insaid.

7 Wi dey go smol-smol for meni days and nor bi smol wahala bifor wi fit rish Cnidus. Bikos di briz nor mak us fit go front again, wi kon driv smol-smol dey go Krete, wey dey oposite Salmone.

8 Bifor wi rish Krete wotasaid, e hard us wel-wel and wi kon rish won place wey dem dey kol, "Fair Havens" wey dey near Lasea tawn.

9 As e bi sey taim don go wel-wel and di joni don hard laik dis, bikos di taim wey dem dey fast don pas, Pol kon advise dem sey,

10 "My pipol, I dey si sey dis joni na wit wahala e go tak end and nor bi onli di load and di ship go loss, bot meni pipol go die tu."

11 Bot di komanda nor listin to am and na wetin di kaptain and di ship owna tok, naim e biliv.

12 Bikos di place wer ship dey park put wen dem si, nor gud for kold weda; som of di pipol kon gri sey mak wi dey go. Dem dey hope sey wi go fit rish Finix, wey dey Krete, wey face soutwest and nortwest, so dat wi go fit spend kold season for der.

13 Wen won kaind kwayet briz blow kom from sout, dem tink sey dem go fit du wetin dem plan, so dem kon dey go smol-smol pas Krete wotasaid.

14 Afta di kold briz, won strong briz wey dem dey kol, "Hurricane", kon dey blow kom from di Island.

15 Wen dis briz trap di ship and wi nor fit si wel-wel again, wi liv di ship giv di briz and e kon dey kari us go wer e laik.

16 As wi dey run go hide unda won smol island wey dem dey kol Kauda, nor bi smol wahala, bifor wi fit kontrol di ship.

17 Afta dem don drag di ship komot from di wota, dem kon tak rope tie am. Wi dey fear sey wi go run aroun for Syrtis, so wi hook di ship for groun kon liv di briz mak e kari us go.

18 Di next day, bikos di briz wori us wel-wel, wi kon dey trow awa load put for wota

19 and wen di ted day rish, dem yuz dia hand trow wetin dem tak dey kontrol di ship put for wota.

20 Wen wi nor si sun or star for meni days and di briz stil dey wori us, wi kon luz hope sey wi don die bi dat.

21 Afta dem don stay witout fud for meni days, Pol stand for dia front kon sey, "My pipol, if to sey una listin to mi wen I sey mak wi nor komot for Krete, wi for nor si all dis wahala.

22 "Naw, I won mak una heart strong, bikos nobodi go die among us, bot na onli di ship go skata.

23 "Bikos yestiday nite, God wey I dey serv, en angel apier to mi

24 kon sey, 'Mak yu nor fear Pol! Yu must face Caesar and God go save yu and evribodi wey dey folo yu travol.'

25 "So, my pipol, mak una heart strong, bikos I biliv sey na as God tel mi, na so e go bi.

26 "Bot wi go sureli rish land."

27 Afta fortin days, as di briz dey kari us pas di Adriatic Sea for midnite, di sailors kon dey suspet sey wi don dey near land.

28 Dem trow long rope wey dem tie somtin put insaid di wota to measure haw e deep rish and dem si sey di wota stil deep rish 40 metres. Afta e don tey smol, dem trow am again kon si sey e don bi 30 metres.

29 Dem dey fear sey di ship go jam rock for di land, so dem trow for big-big chain from di ship bak kon dey pray mak day kwik break.

30 Den di sailor trai to run liv di ship, dem tak di smol boat for di ship, put am for wota kon dey play wayo sey dem won go put big chain dan for di ship front,

31 bot Pol tel di ofisa and sojas, "Unles all dis men stay insaid di ship, all of us go die."

32 So di sojas kon kut di rope for di boat mak e float go.

33 As day won break, Pol enkorage dem mak dem chop kon sey, "Today mak am fortin days wey una dey wori, sotey una nor gri chop.

34 "So naw, I dey beg una to chop, bikos una nid am to sovaiv. And nobodi among una go luz ivun won hair for en head."

35 Wen Pol tok finish, e tak bread kon tank God for dia front mak all of dem si and e start to chop.

36 All of dem get strong heart kon tak fud chop.

37 (Wi bi 276 wey dey insaid di ship.)

38 Wen dem don chop beleful, dem kon trowey all di rimainin bread insaid di wota mak di ship nor for heavi again.

39 Wen day break, dem nor no wer dem dey, bot dem si won smol land wey near di sea and dem tok for dia maind sey, if e dey posibol dem go yuz di ship tak enta.

40 So dem kut all di chains wey hol di ship kon let dem fal insaid di sea. Dem stil luz di wons wey dey hol wetin dey kontrol di ship. Dem let briz blow di ship go front and wi kon move face land.

41 Bot dem mit san-san for di sea. So di ship front kon hook and e nor fit move again, di bak skata, bikos of di way di wave dey blow am.

42 Di sojas kon plan to kil all di prizinas mak dem nor for fit swim kon eskape.

43 Bot bikos di soja ofisa won save Pol life, e nor kon let dem du wetin dem plan. E komand di pipol wey fit swim, mak dem first jump komot from di ship swim go land

44 and di res pipol kon folo for bak, som hol di wud and odas hol di ship bodi wey break. Na so all of dem tak rish land and nobodi die.

Open Bible reader