Nigerian Pidgin Bible
Acts 21
1 Afta wi don liv dem, wi enta ship kon travol go Kos. Di next day, wi go Rhodes and from der, wi kon go Patara.
2 Wi si won ship dey kros go Fonicia, so wi kon enta am.
3 Afta wi rish Syprus, wi kon liv der travol go Syria, kom stop for Tyre, bikos di ship won put load dan.
4 Wi kon go faind di disaipols wey dey for di tawn, wen wi si dem, wi stay wit dem for sevun days. Dem kon tel Pol meni taims sey mak e nor go Jerusalem.
5 Wen wi don stay der for somtaim, wi kon travol komot der. All of dem wit dia wife and pikin eskot us go outsaid di tawn. Wi nil dan pray for di riva
6 kon tel dem bye-bye and as wi enta ship, dem kon go bak to dia haus.
7 Wi kontinu awa joni from Tyre go rish Ptolemais and wen wi don grit di brodas, wi stay wit dem for won day.
8 Di next day, wi liv der kon go Sizeria. For der, wi enta Filip haus. Dis Filip na evangelist and e dey among di sevun dikins wey dem shuz for Jerusalem, den wi kon stay der wit am.
9 (E get for dotas wey neva mari, wey dey profesai.)
10 As wi stay der for som days, won profet wey en name na Agabush kom from Judea.
11 E waka kon mit us, tak Pol belt tie en hand and leg kon sey, "Di Holi Spirit sey, 'Na so di Ju pipol wey dey Jerusalem go tie di man wey get dis belt kon kari am giv Gentai pipol.'"
12 Wen wi hear wetin e tok, wi and di pipol wey dey der kon beg Pol sey mak e nor go Jerusalem.
13 Bot Pol ansa, "Wetin una dey du so, una dey krai dey won break my heart? I redi, nor bi onli mak dem tie mi, bot to die for Jerusalem, bikos of Jisos Kraist name."
14 Bikos wi nor fit stop am again, wi kon kip kwayet and onli en kon sey, "Wetin God wont mak e hapun, go hapun."
15 Afta dat day, wi priper kon go Jerusalem.
16 Som disaipols from Sizeria folo us go, dem kon bring us kon Mnason for Syprus haus, wey bi won of di first disaipols and wi stay der wit am.
17 Wen wi rish Jerusalem, di brodas welkom us wit hapines.
18 Di next day, Pol kon folo us go si James and all di eldas wey dey der.
19 Wen Pol don grit dem, e kon start to tok di stori abaut wetin God don du for Gentai pipol tru en ministri.
20 Wen dem hear dis, dem kon dey praiz God. Den, dem tel am, "Yu si, awa broda, haw meni tazon Ju don biliv and dem stil dey obey di law?
21 "Dem hear sey yu dey tish Ju pipol wey dey stay wit Gentai pipol, sey mak dem trowey Mosis law; mak dem nor sekonsaiz dia shildren again and mak dem nor folo awa laws again.
22 "So, wetin wi go du? Bikos dem go rili hear sey yu don kom.
23 "So mak yu du wetin wi won tel yu: For men dey wit us here wey mak vow;
24 tak dem folo bodi mak una go du wetin Mosis law tok and mak yu pay all di moni wey dem spend tak shave dia head. Den, evribodi go no sey all di stori wey dem hear abaut yu, nor bi tru and dem go si sey yu yorsef dey obey di law.
25 "Bot konsanin Gentai pipol wey don biliv, wi don rite leta go giv dem sey, mak dem forbid meat wey dem sakrifais giv juju, anima wey dem kil and e blood nor tosh groun and mak dem nor slip wit hu dem nor mari."
26 Di next day, Pol tak di men and afta e don join dem du wetin Mosis law tok, e go di Tempol kon sey, dem don obey di law and dem redi to offa di sakrifais.
27 Wen di sevun days don dey finish, di Ju pipol wey kom from Asia kon si-am for di Tempol, naim dem start wahala and pipol kon gada. Dem seize Pol
28 dey shaut sey, "Izrel pipol, mak una kom o-o! Dis na di man wey dey tish pipol for evriwer, abaut tins wey dey against awa pipol, awa law and against dis Tempol. Ivun sef e don bring Greek dem enta insaid di Tempol kon mak dis holi place dirti."
29 (Bikos dem si Trofimus wey kom from Efisos for di tawn wit am bifor, so dem kon tink sey, Pol don kari am enta di Tempol.)
30 Di hol tawn start to shake and all di pipol kon gada. Dem seize Pol, drag am komot from di Tempol kon klose di door.
31 As dem dey trai to kil-am, news kon rish di komandin ofisa for di Roman armi wey dey gaid di tawn sey, di hol Jerusalem don skata.
32 At wons, e kari plenti sojas and offisas kon run go wer di pipol gada. Wen dem si di komandin ofisa and di sojas, dem kon stop to beat Pol.
33 Den di komandin ofisa arres am kon giv orda sey mak dem tie am wit tu chain. E ask am hu e bi and wetin e du.
34 Som pipol for di crowd kon dey tok difren-difren tins and wen di komandin ofisa nor fit no wetin kause di wahala, e kon giv orda sey, mak dem kari Pol go barrak.
35 Wen e rish di step for di Tempol, di sojas kon kari Pol, bikos of di crowd wey won kil-am.
36 So dem folo di sojas for bak kon dey shaut, "Kil am!"
37 As dem won kari Pol enta di barrak, e kon ask di komandin ofisa, "I go fit tok to yu first?" Di ofisa ansa, "So yu dey hear Greek language?
38 "So nor bi yu bi dat Egypt man wey start wahala kon kari for tazon men wey dem dey kol 'Assasins' go insaid desert?"
39 Pol ansa, "I bi Ju wey kom from Tarsus wey dey Silicia. I bi citizin for dis tawn and dem no mi wel-wel. Abeg alow mi folo di pipol tok."
40 Wen di komandin ofisa alow am, Pol kon stand for di step, wave en hand sey mak dem kwayet. Wen evriwer don kwayet, e kon yuz Aramaic language folo dem tok.