Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Mark 6

1 Jisos kon komot for dat place go en home tawn wit en disaipols.

2 Wen Sabat Day rish, e kon start to tish for di sinagog. Meni pipol wey hear am sopraiz, dey sey, "Wer e for get dis kaind sense? Wish kaind wisdom God gi-am? And wetin bi all dis mirakol wey e dey doh so?

3 "Nor bi di kapinta pikin, wey bi James, Joses, Judas and Saimon broda? Nor bi en sistas dey wit us so? Nor bi Mary bi dia mama?" So dem kon dey ves for am.

4 Den Jisos kon tel dem, "Na onli for profet tawn, among en own pipol and for en own famili na-im di profet nor dey get respet."

5 Jisos nor fit doh eni mirakol for der, so e onli tosh som sik pipol kon heal dem.

6 Jisos sopraiz, bikos dem nor biliv am. So e komot from der go oda vilage wey near der kon tish dem.

7 Jisos kol di twef disaipols kon send dem tu-tu go out. E giv dem pawa to driv evil spirits komot from pipol bodi.

8 E tel dem mak dem onli tak dia wokin stick for di joni. E sey mak dem nor kari bread, bag or moni folo bodi.

9 E stil sey, "Una fit wear shu, bot mak una nor kari extra klot

10 and eni haus wey una enta, mak una stay der ontil una komot for di place.

11" If dem nor welkom una or listin to wetin una dey tok for eni place, mak una shake di sand komot from una leg as una dey liv der, to show sey dem rejet di mesage."

12 So, dem go out kon prish sey mak evribodi turn from sin kom mit God .

13 Dem driv meni dimon komot from pipol bodi and pour oil for meni pipol wey nor wel head kon heal dem.

14 King Herod kon hear wetin dey hapun, bikos pipol don no Jisos name wel-wel. Som pipol sey, "Jon wey dey baptaiz don wak-up from deat and bikos of dis, e don get pawa to doh mirakols."

15 Odas sey, "Na Elija e bi." Som kon sey, "E bi laik won profet wey dey bifor."

16 Bot wen Herod hear am, e sey, "Jon wey I sey mak dem kut en head komot, don wak-up from deat!"

17 Na Herod send men go arres Jon put for prizin, bikos of Herodias, en broda Filip wife wey e mari.

18 Bikos Jon don tel Herod plenti taims sey, "E nor gud as yu mari yor broda wife."

19 So Herodias kon get bad bele for Jon and e won kil-am, bot e nor fit.

20 Herod dey fear Jon wel-wel, so e dey protet am, bikos e no sey Jon na holi man wey dey du wetin God laik. Enitaim Herod hear Jon dey prish, en maind go dey wori am, bot e stil dey laik to listin to am.

21 Bot won day wen Herod dey du en betday, en ofisas, en sojas oga dem and di lidas for Galili, dey der wit am.

22 Wen Herodias dota kom dance, Herod and di pipol wey e invait kon dey hapi wel-wel. So di king kon tel di girl, "Mak yu ask mi for enitin wey yu wont and I go giv yu."

23 Herod kon swear sey, "Mak yu ask mi for enitin wey yu wont and I go giv yu, ivun if e go rish haf of my kindom."

24 So di girl go outsaid go ask en mama, "Wetin I go ask for?" Di mama ansa am, "Mak yu ask for Jon di Baptist head."

25 Kwik-kwik e rush go mit di king kon tel am wetin e wont, "I wont Jon di Baptist head for plate naw."

26 Ivun doh e pain di king wel-wel, e nor won rejet wetin di girl ask, bikos e don swear for di present of di pipol wey e invait.

27 So di king send di soja wey dey kil kriminas, mak e go bring Jon head kom. So di man go insaid di prizin, go kut Jon head komot.

28 E put di head for plate kon giv di girl and di girl go gi-am to en mama.

29 Wen Jon disaipols hear wetin hapun, dem kom kari en bodi go bere.

30 Den di disaipols gada roun Jisos kon tel am evritin wey dem don du and tish.

31 Jisos kon tel dem, "Mak una folo mi mak wi go res for somtaim", (Bikos meni pipol dey-kom-dey-go and taim nor dey to chop).

32 So onli dem kon enta boat go won place wer pipol nor dey.

33 Bot meni pipol si dem wen dem dey go, so di pipol kon run wit leg from all di tawns kon first Jisos and en disaipols rish di place.

34 Wen Jisos kom dan from di boat, e si plenti pipol and e kon sori for dem, bikos dem bi laik anima wey nor get hu dey luk afta dem. So e kon tish dem meni tins.

35 Wen day don dey dak, en disaipols kom mit am sey, "Dis na place wey pipol nor dey stay and day don dey dak.

36 "Mak yu send dis pipol go buy wetin dem go chop for di tawn and vilage wey near here."

37 Bot Jisos ansa, "Mak una giv dem somtin chop." Dem kon sey, "Mak wi go tak tu ondred silva koins buy bread giv dem chop?"

38 Jisos kon ask dem, "Haw meni bread una get? Mak una go shek." Wen dem don shek, dem kon ansa, "Na faiv bread wit tu fish."

39 Jisos kon tel di pipol mak dem share diasef into grup, sidan for grass.

40 So dem sidan for difren-difren grup, ondred-ondred, fifti-fifti.

41 Jisos tak di faiv bread and tu fish, e luk hevun kon tank God, den e divide di bread. E giv en disaipols mak dem-share am for di pipol and e kon divide di tu fish among dem tu.

42 All of dem chop beleful

43 and wen dem gada di fish and bread wey rimain, twef basket ful.

44 Di pipol wey chop di bread, rish faiv tazon men.

45 So Jisos tel en disaipols mak dem enta boat kros go di oda side for Betsaida, den e send di pipol go haus.

46 Afta e don tel dem bye-bye, e kon go pray for won mountin.

47 Wen evenin rish, di boat don rish di sea senta, bot Jisos stil dey alone for land.

48 E si en disaipols dey yuz all dia pawa dey padol di boat, bikos di briz strong wel-wel. As mornin won rish, Jisos waka kom mit dem, laik sey e won pas dem.

49 Wen dem si-am dey waka on-top di wota, dem tink sey na ghost. Dem kon dey shaut,

50 bikos as dem si-am, fear kash dem. Bot Jisos tel dem, "Mak una heart nor shake! Na mi. Mak una nor fear."

51 Den Jisos enta di boat wit dem, den di briz kon stop. Dem kon sopraiz wel-wel,

52 bikos dem konfuz and dem nor undastand haw Jisos tak fid faiv tazon pipol.

53 Afta Jisos and en disaipols don kros di riva, dem kon rish Genesaret, den dem tie dia boat for der.

54 As dem kom dan from di boat, pipol kon si sey na Jisos bi dat.

55 Di pipol run pas all di aria, kari di pipol wey nor wel for mat go wer dem hear sey Jisos dey.

56 Eniwer wey Jisos go, weda na vilage or tawn or farm, dem go kari di pipol wey nor wel for dia market place kon ask Jisos weda dem go fit tosh en klot and evribodi wey tosh am, kon wel.

Open Bible reader