Nigerian Pidgin Bible
Mark 4
1 Again, Jisos kon bigin tish pipol for di wotasaid. Since pipol wey gada roun am meni, e kon enta boat dey tish di pipol as dem sidan for groun near di wota.
2 E kon tish dem meni tins for parabol sey:
3" Mak una Listin! Won farma go plant sid for en farm.
4" As e dey plant, som sid fal for road and birds kom chop dem.
5" Odas fal for wer stones and sand dey. Dem kwik grow kom out, bikos gud soil nor dey der.
6" Wen sun kom out, e burn di plant, bikos dem nor get deep root, dem kon die.
7" Odas fal for wer shuku-shuku dey and wen dem grow kom out, di shuku-shuku, shuk dem die.
8" Bot odas fal for beta groun. Dem grow wel kon bear oda sids, som bear rish tati, som sisti and som ondred."
9 Jisos kon sey, "Enibodi wey get ear, mak e hear wetin I dey tok!"
10 Wen Jisos dey alone, pipol wey dey wit am and en twef disaipols kon ask am abaut di parabol.
11 E kon tel dem, "God don show una di kindom sikrit. Bot doz wey dey outsaid God Kindom, na parabol e bi for dem,
12 so dat dem go dey luk, bot dem nor go si, dem go dey hear, bot dem nor go undastand and dem nor go fit turn from dia sin kom mit God mak E forgiv dem."
13 Jisos kon ask dem, "Una nor undastand dis parabol? Den haw una go tak undastand eni oda parabol?
14" Na God wod di farma dey plant.
15" Som pipol bi laik di sid wey fal for road: enitaim dem hear God wod, Satan go kom tif-am from dem kwik-kwik.
16" Som bi laik di sids wey fal for wer stones and sand dey: as dem hear God wod, dem go risiv am wit hapines,
17 and bikos dem nor get root and patient, wen trobol or wahala kom bikos of di wod, dem go forget God wod.
18" Odas bi laik di sids wey fal for wer shuku-shuku ful: dem hear di wod,
19 bot trobol for life, big eye for moni and di way dem dey run folo oda tins, go kon blok di wod and e nor go bear enitin for dia life.
20" Bot di wons wey fal for beta groun, na doz wey hear di wod kon risiv am and bear meni fruts, som bear rish tati, som sisti and som ondred."
21 Jisos stil ask dem, "Pipol dey hide lamp for unda basket? Nor bi on-top di place wer dem dey kip lamp, dem sopoz put am?
22" E nor get wetin pipol hide wey God nor go show and e nor get wetin dey for sikrit naw, wey nor go kom out for opun.
23" If enibodi get ear, mak e hear wetin I dey tok!"
24 Jisos kon tel dem, "Mak una dey kareful for wetin una dey hear, bikos na wetin yu yuz tak measure giv oda pipol, na-im God go tak measure for yu tu and E go add join am.
25" Bikos enibodi wey get, God go gi-am more, bot enibodi wey nor get, ivun di smol won wey e get, God go tak am from am."
26 Jisos kon sey, "God Kindom bi laik pesin wey skata sid for groun.
27" Di pesin go dey slip and dey wak-up day and nite, di sid kon grow kom out, ivun doh di man nor no haw e hapun.
28" As plant dey grow from groun, di bodi go first kom out, den di head go bear frut and sid go kom out from insaid.
29" Wen e ripe, di farma go kut am, bikos di taim to plok wetin e plant, don rish."
30 Jisos kon ask dem, "Wetin wi go tak kompare God Kindom? Wish parabol wi go fit yuz tak show as e bi?
31" E bi laik mustard sid wey bi di sid wey smol pas for di wold, wey pesin plant for groun.
32" Afta dem don plant am, e go grow kon big pas all di oda plants and en bransh go big and birds go land kon build dia nest for der."
33 Na wit meni parabol laik dis won, Jisos tak prish God wod to dem, so dat dem go fit undastand.
34 E nor get wetin e tel dem wey e nor yuz parabol. Bot wen onli en and di disaipols dey, e dey explain evritin giv dem.
35 Wen evenin rish dat day, Jisos kon tel en disaipols, "Mak wi kros go di oda side for di riva."
36 So afta dem liv di pipol, dem kon enta di boat wey Jisos sidan and oda boats stil dey der wit dem.
37 Den, strong briz kon dey blow and wota dey enta di boat, so di boat kon dey won sink.
38 Bot Jisos put en head for pilow dey slip insaid di boat. Dem kon kol am dey sey, "Tisha, yu nor ivun kare sey wi won die?"
39 So Jisos get up kon komand di briz, den e tel di riva, "Mak yu kwayet!" Di briz stop and evriwer kon kwayet at wons.
40 Den Jisos tel dem, "Why una dey fear? Una stil nor get fate?"
41 Fear kash dem wel-wel and dem kon dey ask ish oda, "Hu dis man bi sef? Ivun briz and riva dey obey am!"