Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Mark 4:2

E kon tish dem meni tins for parabol sey: 3" Mak una Listin! Won farma go plant sid for en farm. 4" As e dey plant, som sid fal for road and birds kom chop dem. 5" Odas fal for wer stones and sand dey. Dem kwik grow kom out, bikos gud soil nor dey der. 6" Wen sun kom out, e burn di plant, bikos dem nor get deep root, dem kon die. 7" Odas fal for wer shuku-shuku dey and wen dem grow kom out, di shuku-shuku, shuk dem die. 8" Bot odas fal for beta groun. Dem grow wel kon bear oda sids, som bear rish tati, som sisti and som ondred."

Open Bible reader