Nigerian Pidgin Bible
Luke 8
1 Afta som taim, Jisos kon travol go all di tawn and vilage dey prish di Gud News abaut God Kindom. Di twef apostols
2 and som wimen wey Jisos driv evil spirit and difren siknes komot for dia bodi, go wit am: Mary (wey dem dey kol Magdalene), wey Jisos driv sevun dimon komot for en bodi,
3 Joanna, Shuza wife (wey bi managa for Herod haus), Susanna and meni oda wimen wey dey yuz dia own moni sopot Jisos and en disaipols.
4 Meni pipol gada roun Jisos and som stil dey kom from difren place, so e kon tel dem dis parabol:
5 "Won man go plant sid for en farm. As e dey plant, som fal for road, pipol mash dem pas and birds kon chop dem.
6 "Som wey fal for wer stones dey kon grow and die, bikos wota nor dey dat groun.
7 "Odas fal for wer shuku-shuku dey and wen dem grow, di shuku-shuku grow tu, kon shuk dem die.
8 "Bot di wons wey fal for beta groun, grow kon bear pas ondred sid." Den Jisos sey, "Enibodi wey get ear, mak e hear!"
9 Den en disaipols ask am wetin di parabol min.
10 Jisos ansa dem, "Una get di shanse to no God Kindom sikrit, bot dis oda pipol, na onli parabol dem go tak hear am, so dat as dem dey luk, dem nor go si and as dem hear, dem nor go undastand.
11 "Na wetin di parabol min bi dis: Di sid na God wod.
12 "Di won wey fal for road, na di pipol wey hear God wod, bot devol kon tif am from dia heart, so dat dem nor go biliv and God nor go save dem.
13 "Di won wey fal for wer stones dey, na di pipol wey hear God wod kon risiv am wit hapines, bot dem nor get root. Dem biliv smol, bot wen wahala kom, dem nor biliv again.
14 "Di sid wey fal for shuku-shuku, na di pipol wey hear God wod, bot wahala, plenti propati and jolli-jolli for dis wold kon shuk dem, so di frut nor ivun ripe.
15 "Bot di sid wey fal for beta groun, na di pipol wey hear God wod, hol am wit beta maind, dey obey God and bear wahala, so dem kon bear plenti frut."
16 "Pesin nor go lite kandol kon tak bucket kova am or hide am unda bed, bot e go put am for wer pipol go si-am wen dem enta di haus.
17 "Bikos e nor get wetin pipol hide naw, wey God nor go bring out and wetin dey sikrit naw, God go bring am out for wer lite dey.
18 "So mak una listin wel-wel, bikos pesin wey get, God go gi-am more, bot pesin wey nor get, ivun di smol won wey e tink sey e get, God go tak am from en hand."
19 Jisos mama and en brodas kom mit am, bot dem nor fit go near am, bikos pipol plenti for der.
20 So pipol tel am, "Yor mama and brodas dey outsaid, dem won si yu."
21 Jisos ansa, "My mama and brodas na pipol wey dey hear and obey God wod."
22 Won day, Jisos and en disaipols enta kenu, den e tel dem, "Mak wi kros go di oda side for di riva." So dem kon go.
23 As dia kenu dey move for di wota, Jisos dey slip den strong briz start to dey blow and dem kon dey fear, bikos wota dey enta di kenu.
24 Dem kon tel Jisos, "Oga! Oga! Na die wi dey so!" Jisos get up, kon komand di briz mak e stop and di wota wey rof bifor, stop and evriwer kon kwayet.
25 Den Jisos ask dem, "Wer una fate dey?" Bot dem dey fear and sopraiz dey tel ish oda, "Wish kaind man bi dis sef? Ivun briz and wota dey obey am!"
26 Dem kon rish Gerasenes aria wey face Galili.
27 As Jisos kom dan from di kenu, won man wey get dimon wey dey di tawn kom mit am. E don tey wen dis man stop to wear klot or stay insaid haus, bot e dey stay for beria groun.
28 Wen e si Jisos, e fal for en front kon shaut, "Mak yu liv mi! Jisos, God Pikin, I beg yu, nor ponish mi!"
29 E shaut, bikos Jisos don first komand di evil spirit mak e komot for en bodi (bikos di evil spirit don disturb di man wel-wel and dem dey chain and gaid am. Bot e dey break di chain and di dimon go driv am go insaid desert.)
30 Jisos ask am, "Wetin bi yor name?" E ansa, "Na Legion, bikos wi plenti insaid am."
31 Di dimons bigin beg Jisos mak e send dem go insaid di riva.
32 Near di riva, meni pig dey togeda dey chop and di evil spirits beg Jisos mak dem enta insaid di pigs. So Jisos alow dem.
33 Di dimons komot for di man bodi go enta di pigs and all of dem kon rush enta di riva go die.
34 Wen di pipol wey dey kip di pigs si wetin hapun, dem run go insaid tawn bigin spread di news.
35 So di pipol run kom si wetin dey hapun and dem mit Jisos for der. Di man wey Jisos driv dimon komot for en bodi, don wel and e wear klot sidan near Jisos leg, so fear kon kash di pipol.
36 Pipol wey si wetin hapun, tel di tawn pipol haw Jisos heal di man wey get dimon bifor.
37 Den all di pipol for Gerasenes and di aria wey near der, kon tel Jisos mak e liv dem, bikos dem dey fear wel-wel. So Jisos and en disaipols enta kenu kon komot for der.
38 Di man wey dimon komot for en bodi beg Jisos mak e folo am, bot Jisos tel am,
39 "Mak yu go yor haus go tel dem wetin God don du for yu." So di man kon go, dey tel pipol for di tawn wetin Jisos du for am.
40 Wen Jisos go bak for di oda side for di riva, pipol welkom am for der, bikos e don tey wey dem dey wait for am.
41 Den Jairus wey bi oga for di sinagog kon kom. E fal for groun near Jisos leg, dey beg am mak e kom en haus,
42 bikos e onli dota wey don rish twef years, dey die. As Jisos dey go di man haus, pipol kon dey waka jam am enihaw bikos dem plenti.
43 Won wuman dey among dem wey don dey mestrate for twef years naw, bikos nobodi fit heal am.
44 E waka kom Jisos bak kon tosh Jisos klot kona and at wons, di blood kon stop.
45 Den Jisos ask, "Na hu tosh mi?" Wen evribodi sey dem nor no, Pita kon tel Jisos, "Oga, plenti pipol gada roun yu and all of dem bodi dey tosh yu!"
46 Bot Jisos sey, "Sombodi tosh mi, bikos pawa komot for my bodi."
47 Wen di wuman si sey e nor go fit hide again, e kom out dey shake kon fal for Jisos front. For evribodi present, e tok wetin mak am tosh Jisos and haw e kon wel at wons.
48 Jisos kon tel di wuman, "My pikin, yor fate don heal yu. Mak peace folo yu."
49 As Jisos stil dey tok, sombodi run kom from Jairus haus, kon tel Jairus sey, "Yor pikin don die, so mak yu nor wori di tisha again."
50 Bot wen Jisos hear am, e tel Jairus, "Mak yu nor fear, jos biliv and yor pikin go wel."
51 Wen dem rish di haus, Jisos nor let enibodi folo am enta, esept Pita, Jon and James wit di pikin papa and mama.
52 Evribodi for der dey krai tak bodi nak groun, bot Jisos tel dem, "Mak una nor krai, bikos di girl neva die, na slip e dey slip."
53 Dem kon bigin laff am, bikos dem no sey di girl don die.
54 Bot Jisos hol di girl hand kon sey, "My pikin, get up."
55 Naim di girl spirit enta di bodi bak and e kon get up at wons. Den Jisos tel dem mak dem giv di pikin fud chop.
56 Di papa and mama sopraiz wel-wel, bot Jisos komand dem mak dem nor tel enibodi wetin hapun.