Nigerian Pidgin Bible
Mark 10
1 Jisos kon komot for dat place go Judea and Jordan Riva aria. Plenti pipol stil gada kom mit am. E kon bigin tish dem as e dey du evritaim.
2 Den, som Farisi pipol wey won test am kon ask am, "E bad mak man driv en wife at-all?"
3 Jisos ask dem, "Wetin Mosis komand una?"
4 Dem ansa, "Mosis sey mak man rite leta to daivos en wife."
5 Bot Jisos tel dem, "E tel una to du so, bikos una heart strong wel-wel.
6 "Bot from di taim God kreate di wold, na man and wuman naim E mak.
7 "Na dis mak man dey liv en papa and mama go join en wife
8 and di tu of dem go bikom won. So dem nor go bi tu again, bot dem go bi won bodi.
9 "So, wetin God don join togeda, mak nobodi seprate am."
10 Wen dem enta di haus again, en disaipols kon ask am abaut di mata.
11 Jisos ansa dem, "Enibodi wey driv en wife, den e go mari anoda wuman, don komit adultri.
12 "And eni wuman wey liv en husban, den e go mari anoda man, don komit adultri tu."
13 Pipol kon dey bring shildren kom mit Jisos mak e tosh dem, bot en disaipols dey shaut for di pipol wey bring dem kom.
14 Bot wen Jisos si wetin dey hapun, e ves kon tel en disaipols, "Mak una alow smol-smol shildren kom mit mi, nor stop dem, bikos na pipol laik dem, go enta God Kindom.
15 "I tel una tru wod, enibodi wey nor risiv God Kindom laik smol shildren, nor go eva enta insaid."
16 Afta, Jisos draw di shildren near bodi kon bless dem.
17 As Jisos dey waka for road, won man run kom mit am sey, "Gud Tisha, wetin I go du mak I for get life wey nor dey end?"
18 Jisos ansa am, "Why yu dey kol mi gud? Nobodi gud esept God.
19 "Yu no di komandment; nor kil pesin, nor slip wit pesin wey yu nor mari, nor tif, nor lai for pesin head, nor shit pesin, respet yor papa and mama."
20 Di man kon tel Jisos, "Tisha, I dey obey all dis law wit all my heart since I bi smol pikin."
21 As Jisos luk am, e kon feel for am, den e tel am, "E get won tin wey yu neva du. Go sel all wetin yu get, giv poor pipol di moni and yu go get plenti propati for hevun. Den mak yu kom folo mi."
22 Wen di man hear dis wod, e ves komot der, bikos e get plenti moni.
23 Den Jisos luk roun kon tel en disaipols, "E go hard wel-wel for pipol wey get moni wel-wel to enta God Kindom!"
24 Di disaipol sopraiz for wetin Jisos tok. Bot Jisos tel dem again, "My shildren, e go hard wel-wel to enta God Kindom o-o!
25 "E go dey eazi for kamel to pas needo hol, dan for pipol wey get moni wel-wel to enta God Kindom."
26 Dem sopraiz more-more kon dey ask ish oda, "Den, hu God go save?"
27 Jisos luk dem kon ansa, "Dis tins hard wel-wel for humanbin, bot nor bi for God, bikos evritin dey posibol for God."
28 Pita kon tel am, "Si! Wot of wi wey don liv evritin wey wi get, kon folo yu?"
29 Jisos ansa, "I tel una tru wod, e nor get enibodi wey liv en haus, brodas, sistas, papa, mama, shildren or land bikos of di gospol,
30 wey nor go risiv ondred taims more dan di haus, brodas, sistas, papa, mama, shildren and land wey e liv for dis wold. Aldoh e nor go eazi for dem, bot di life wey nor go end for di wold wey dey kom, go bi dia own.
31 "Bot meni pipol wey bi first naw, go bi last and pipol wey bi last naw, go bi first."
32 Jisos and en disaipols kon dey go Jerusalem. As Jisos dey waka for dia front, di disaipols konfuz and doz wey dey folo dem kon dey fear, bikos dem nor no wetin go hapun for der. Jisos kol en twef disaipols go kona again kon bigin tel dem wetin go hapun to am.
33 "Si, wi dey go Jerusalem and dem go sel Man Pikn giv di prist oga dem and di law tishas. Dem go kondem am and dem go giv am to di Gentai pipol.
34 "Dem go laff am, spit for en bodi, flog am wel-wel kon kil-am, bot afta tiri days, e go wak-up."
35 Zebedi shildren, James and Jon, kom mit Jisos sey, "Tisha, wi wont mak yu du wetin wi won beg yu."
36 Jisos kon ask dem, "Wetin una wont mak I du for una?"
37 Dem ansa, "Mak yu alow us sidan wit yu for yor kindom, won for yor rite and di oda for yor left hand."
38 Jisos ask dem, "Una no wetin una dey ask for so? Una go fit drink from di cup wey I go drink from? Abi una go fit bear di baptism wey dem go baptaiz mi?"
39 Dem ansa, "Wi go fit." Den Jisos tel dem, "Una go rili drink from di cup wey I go drink from and una go fit bear di baptism wey dem go baptaiz mi,
40 bot nor bi mi go tok hu go sidan for my left or rite side, bikos e get di pipol wey God priper am for."
41 Wen di oda ten disaipols hear wetin Zebedi shildren tel Jisos, dem kon dey ves for dem.
42 Jisos kon kol and tel dem, "Una no sey pipol wey dey rule di Gentai pipol dey du oga for dem and pipol wey dey high place dey yuz dia posishon dey opres pipol.
43 "Bot nor bi so e sopoz bi among una. Enibodi wey won bi oga among una, must bi una savant
44 and enibodi wey won bi first among una, must bi evribodi savant.
45 "Bikos ivun Man Pikin nor kom mak dem serv am, bot e kom serv pipol and to giv en life mak meni pipol for dey save."
46 Dem kon go Jeriko. As Jisos and en disaipols wit plenti pipol dey komot for der, Bartimaeus wey bi Timaeus pikin, won begga wey blind, sidan for road dey beg.
47 Wen e hear sey na Jisos wey kom from Nazaret dey pas, e kon bigin shaut, "Jisos Kraist, David pikin, mak yu sori for mi o-o!"
48 Meni pipol kon dey shaut for am mak e kwayet, bot e kon dey shaut more-more sey, "David pikin, sori for mi o-o!"
49 Jisos stop kon sey, "Kol am kom." So, dem tel di blind man, "Mak yu hapi! Get up bikos Jisos dey kol yu."
50 Bartimaeus trowey di klot wey e tak kova bodi kon jump-up go mit Jisos.
51 Den Jisos ask am, "Wetin yu wont mak I du for yu?" Di blind man ansa, "Tisha, mak my eye opun, mak I for fit si again."
52 So, Jisos tel am, "Go, yor fate don heal yu." At wons, di man kon dey si and e kon folo Jisos.