Nigerian Pidgin Bible
John 8
1 Den Jisos waka enta Mount Olives.
2 For earli mornin, e enta di Tempol. Plenti pipol gada for der and e kon sidan dey tish dem.
3 Di pipol wey sabi di law and di Farisi pipol kon bring won wuman wey dem kash, sey e slip wit man wey nor bi en husban. Dem kon mak am stand for dia front,
4 den dem tel Jisos, "Tisha, wi kash dis wuman wen e dey slip wit won man wey nor bi en husban.
5 "Mosis law sey, 'Mak dem stone dis kaind wuman til e die.' Wetin yu get to tok for dis mata?"
6 (Dem ask am dis kweshon to set trap for am, mak dem for fit kash am). Bot Jisos bend dan kon tak en finga dey rite somtin for groun.
7 Wen dem kontinu to dey wori am, e kon get up tel dem, "Eni of una wey neva komit sin bifor, mak e bi di first pesin to stone dis wuman."
8 E kon bend dan again bigin rite for groun.
9 Wen dem hear wetin e tok, dem kon dey komot for der won by won. Na di old pipol first start to komot, til e kon rimain onli Jisos and di wuman wey stand for en front.
10 Den Jisos stand-up kon ask am, "Wuman, wer di pipol wey bring yu? Nobodi rimain to kondem yu?"
11 Di wuman ansa, "Oga, nobodi rimain." Den Jisos tel am, "Mi tu nor go kondem yu. Bot from naw go, mak yu nor sin again."
12 Den Jisos kon sey, "Na mi bi di lite wey dey di wold, enibodi wey folo mi, nor go waka for daknes lai-lai, bot e go get di lite wey go gi-am life."
13 Di Farisi pipol kon dey argue wit am dey sey, "Yu dey tok abaut yorsef and wetin yu tok, nor bi tru".
14 Jisos ansa dem, "Ivun if I dey tok abaut mysef, wetin I dey tok na tru, bikos I no wer I from kom and wer I dey go. Bot una nor no wer I from kom or wer I dey go.
15 "Una dey joj pesin wit wetin una si wit una eye, bot I nor dey joj pipol laik dat.
16 "Bot, if I sey pesin du bad, di tins wey I si and tok abaut, na tru, as e bi sey nor bi onli mi dey tok am. Na mi and my Papa wey send mi, dey tok am togeda.
17 "God wod sey, 'Wetin tu pipol bear witnes abaut, na tru.'
18 "I dey bear witnes abaut mysef and my Papa wey send mi, dey bear witnes abaut mi tu."
19 Dem kon bigin kweshon am, "Hu bi yor Papa sef?" Jisos ansa dem, "Una nor no mi or my Papa, if to sey una no mi, una for no my Papa tu."
20 Jisos dey tok to dem near di box wer dem dey put ofrin moni, wey dey insaid di Tempol. Nobodi fit kash am, bikos en taim neva rish.
21 Den Jisos kon tel dem again, "I dey go and una go luk for mi, bot una go die insaid una sin. Wer I dey go, una nor go fit kom der."
22 So di Ju oga dem kon dey ask, "Abi e won go kil ensef? As e dey tok sey, 'Wer I dey go, una nor go fit kom der?'"
23 Jisos ansa dem, "Na groun una from kom, bot mi, na hevun I from kom. Una kom from dis wold, bot I nor kom from dis wold.
24 "Na dis mak mi sey una go die insaid una sin. Unles una biliv sey, 'Na mi bi di pesin wey I tok sey I bi', una go die insaid una sin."
25 Den dem ask am, "Hu yu bi sef?" Jisos ansa, "Na wetin I tel una from di biginin.
26 "I get plenti tins to tok abaut wetin una dey du, bot my Papa wey send mi, nor dey lai and na wetin E tel mi I dey tel pipol wey dey dis wold."
27 (Bot dem nor undastand sey e dey tok abaut en Papa for hevun).
28 Den Jisos sey, "Wen una don kari mi put for kros, una go no hu I bi. I nor jos dey du enitin wey I laik, bot I dey always du wetin my Papa tel mi.
29 "And di Pesin wey send mi dey wit mi. E nor dey liv mi, bikos I dey always dey du di tins wey E wont."
30 As e dey tok, meni pipol kon biliv am.
31 Jisos kon tel di pipol wey kom from Judea wey biliv am, "If una obey wetin I dey tish una, den una go bi my disaipols
32 and una go no di trut and di trut go fri una."
33 Dem tel am, "All of us na Abraham pikin, wi neva bi slave to enibodi bifor. Why yu dey sey, wi go dey fri?"
34 Jisos kon ansa dem, "Na tru wod I dey tel una, enibodi wey dey komit sin, na sin bi di masta wey dey rule am.
35 "Pesin wey bi slave nor dey stay for insaid dat famili foreva, bot pesin wey bi pikin for di famili, naim dey stay foreva.
36 "So wen Man Pikin fri una, una don dey fri bi dat.
37 "I no sey una kom from Abraham famili, bot una won kil mi bikos una nor won hear wetin I dey tok.
38 "Na wetin I si wen I dey wit my Papa, naim I dey tel una, so mak una dey du di tins wey una hear from my Papa."
39 Dem tel am, "Abraham naim bi awa papa." Den Jisos ansa dem, "If una bi Abraham pikin, una for dey du di tins wey Abraham du.
40 "Bot una won kil mi, bikos I tel una di ril trut wey I hear from God. Abraham nor du wetin una dey du so -o-o.
41 "Una dey du di tins wey una papa du." Dem kon tel Jisos, "Awa papa nor born us for outsaid marage. Na God ensef bi di papa wey wi get."
42 Den Jisos ansa, "If to sey na God bi una Papa, una for laik mi, bikos I kom from God and as I dey so, I nor kom du my own tins, bikos na-im send mi.
43 "Na bikos una nor won asept wetin I dey tish, naim mak una nor fit undastand wetin I dey tok.
44 "Na devol bi una papa and na di tin wey una papa wont, naim una dey du. E dey kil pipol from di biginin and e nor dey sopot wetin gud, as e nor get eni gud tin insaid am. Enitaim e dey tok, na di lai wey dey insaid am, na-im e dey tok, e bi lai-lai pesin, bikos naim bi lai-lai papa.
45 "Na bikos I dey tel una tru wod, naim mak una nor gri biliv mi.
46 "Eni of una go fit show sey I komit sin? Since I dey tel una tru wod, why una nor won biliv mi?
47 "Di pesin wey bi God pikin, dey listin and du wetin dem rite for God wod. Una nor dey listin and una nor dey du wetin dem rite for God wod, bikos una nor bi God Pikin."
48 So di pipol kon sey, "E bi laik sey yu bi Samaria pesin and dimon dey insaid yu."
49 Jisos kon tel dem, "I nor get dimon. I dey respet my Papa, bot una nor gri respet mi.
50 "I nor wont mak una praiz mi, bot God, di Won wey dey hevun, na-im wi sopoz praiz and E go joj evribodi for di koret way.
51 "I dey tel una tru wod, if enibodi folo wetin I dey tish, e nor go die again."
52 Den di pipol kon sey, "E-hen! Wi don no naw sey dimon dey insaid yu. Abraham and di profets don die, yu kon dey tel us sey, 'Enibodi wey folo wetin I dey tish nor go die.'
53 "Yu big pas awa papa Abraham and all di profets wey don die? Hu yu tink sey yu bi sef?"
54 Jisos ansa, "If I dey praiz mysef, my praiz na yeye won. Di pesin wey dey praiz mi na my Papa, wey una dey sey, 'Na-im bi awa God.'
55 "Una nor no am, bot I no am and if I sey I nor no am, I dey lai laik una. I no am and I dey folo wetin e dey tok.
56 "Una papa Abraham hapi wel-wel wen e hear sey I dey kom. E si-am and e hapi wel-wel."
57 Den di pipol ask am, "Yu neva old rish fifti years and yu sey yu don si Abraham?"
58 Jisos ansa dem, "Na tru wod I dey tel una so, bifor dem born Abraham, I don alredi dey!"
59 Den, dem kon dey pick stone to stone am, bot Jisos hide kon komot from di Tempol aria.