Nigerian Pidgin Bible
Acts 16
1 Pol kon stil go Derbe and Lystra. Won disaipol wey dem dey kol Timoti dey der. En mama na Ju wey biliv Kraist, bot en papa, na Greek.
2 Di brodas wey dey Lystra and Ikonium dey tok gud abaut am.
3 Pol wont mak Timoti folo am, so e sekonsaiz am, bikos di Ju pipol wey dey for di aria, no sey en papa na Greek.
4 As dem dey go from tawn to tawn, dem kon dey pas di mesage wey di apostols and eldas for Jerusalem send to all di Gentai pipol wey biliv Kraist sey, mak dem obey.
5 So di pipol for di shosh dey strong more-more for fate and dem kon dey plenti evriday.
6 Dem pas tru Frigia and Galatia aria, bikos di Holi Spirit warn dem sey mak dem nor prish di mesage for Asia.
7 Wen dem rish Mysia, dem kon trai to enta insaid Bitinia, bot Jisos Kraist Spirit nor alow dem enta,
8 naim dem pas tru Mysia kon face Troas.
9 Pol si dis vishon for nite: Won man wey kom from Masidonia stand dey beg am sey, "Mak yu kom help us for Masidonia!"
10 Wen Pol si dis vishon finish, wi kon trai to go Masidonia. Wi kon biliv sey God don kol us mak wi go prish di Gud News to di pipol wey dey der.
11 Wi travol for wota from Troas and awa ship kon from der go Samotrace and di next day, wi go Neapolis
12 and from der, to Filipai wey bi numba won tawn for Masidonia, wey Rome dey rule. Wi stay for dis tawn for som days.
13 Wen Sabat Day rish, wi komot from di tawn go di wotasaid, wer wi tink sey wi go si wer dem for dey pray, naim wi sidan kon start to dey tok to di wimen wey gada for der.
14 E get won wuman wey dey listin to us, en name na Lydia and e kom from Tiatira. E dey fear God wel-wel and dey sel purpol klot. God opun en heart to biliv evritin wey Pol tok.
15 Afta en and en famili don baptize, e kon beg us sey, "If una don asept mi as pesin wey biliv Kraist, mak una kon stay for my haus." So e beg us ontil wi gri.
16 Won day, as wi dey go di place wer dem for dey pray, won slave girl wey get spirit wey dey mak am si vishon, kon si us. Di girl oga dey yuz am mak plenti moni, enitaim e tel pipol wetin go hapun.
17 Di girl kon dey folo mi and Pol for bak kon dey shaut sey, "Dis pipol na God savants -o-o, dem dey prish to una abaut haw una go tak dey save."
18 E kontinu to dey shaut laik dis for meni days. So di tin ves Pol wel-wel, naim e turn face di girl kon tel di spirit, "I komand yu wit Jisos Kraist name, komot for dis girl bodi!" At wons, di spirit komot from di girl bodi.
19 Bot wen di pipol wey get di girl si sey wetin dem tak dey mak moni done go, dem seize Pol and Silas kon drag dem go mit di tawn oga dem for di market senta.
20 Den dem drag dem go mit di joj dem kon sey, "All dis men dey kause wahala for dis tawn. Dem bi Ju21and dem dey tish law wey nor bi awa own, since wi bi Rome pipol."
22 All di pipol wey gada for der kon join put mout against dem and di joj dem kon giv orda sey, mak dem rimov Pol and Silas klot komot for dia bodi and flog dem wit heavi stick.
23 Afta dem don flog dem wel-wel, dem put dem for prizin kon tel di warda mak e gaid dem wel-wel.
24 Bikos of dis strong orda, di warda put dem for insaid-insaid di prizin kon hook dia leg wit big-big chains..
25 Wen mid nite rish, Pol and Silas kon dey pray and sing song giv God and all di pipol wey dey di prizin dey listin to dem.
26 At wons, di groun start to shake, sotey all di wall and pilas wey dey di prizin kon dey shake tu. Na wons di door opun and di chains wey dem tak hook di pipol wey dey di prizin, kon luz.
27 Wen di warda wak-up kon si sey all di doors for di prizin opun, e bring en sword kom out, won kon kil ensef, bikos e tink sey all di prizinas don run.
28 Bot Pol kon shaut, "Mak yu nor kil yorsef, all of us stil dey for here!"
29 Naim di warda sey mak dem bring lite and e rush enta insaid di prizin kon fal for Pol and Silas front dey shake.
30 E bring dem kom outsaid kon ask, "My oga dem, wetin I go du to dey save?"
31 Dem ansa am, "Biliv Jisos Kraist and yu go dey save, both yu and all yor famili."
32 Den, dem prish God wod giv en and all di pipol wey dey en haus.
33 Dat nite, di warda kon wosh all dia sore; den en and en famili kon baptaiz.
34 Di warda bring dem enta en haus kon put fud for tabol mak dem chop. E hapi wel-wel sey en and en famili don biliv God.
35 Wen day break, di joj dem kon send polis men sey, "Mak una go riliz doz men."
36 Di warda kon tel Pol, "Di joj dem don giv orda sey mak wi fri una. So mak una kon dey go."
37 Bot Pol tel di polis men, "Dem sey mak dem beat us for publik ivun wen dem neva joj awa kase, ivun doh sey wi bi Rome pipol, dem stil trow us for prizin. Naw, dem won fri us from bak mak pipol nor for no? Wi nor gri! Mak dem kom here by demsef kon riliz us!"
38 Di polis men kon ripot wetin Pol tok giv di joj dem. Fear kash dem wen dem hear sey Pol and Silas na Rome pipol,
39 so dem kon beg dem sey mak dem nor ves. Afta dem bring dem kom out, dem kon beg dem wel-wel sey mak dem liv di tawn.
40 Wen dem don komot for prizin, dem enta Lydia haus and wen dem si di brodas, dem enkorage dem bifor dem liv di tawn.