Nigerian Pidgin Bible
Romans 4
1 Na wetin Abraham awa gran papa learn from dis mata?
2 If na di gud tins wey e du mak am dey gud for God eye, den e sopoz to dey boast for pipol, bot e nor go eva fit boast for God.
3 Wetin dem rite for God wod? "Abraham biliv God tru fate and God kon si-am as raitious pesin."
4 Wen pesin wok, dem must pay am en moni, nor bi dash e bi, bot na moni wey e wok for.
5 Doz wey nor depend on wetin dem dey du, bot dem get fate and biliv sey God dey forgiv sinas, na dis fate God dey yuz tak forgiv dem dia sins.
6 David tok di same tin wen e tok abaut di blessin wey pesin dey get wen God don asept am, ivun doh dem nor deserv dat kaind blessin. David stil sey,
7" God don bless pipol wey E forgiv kon tak dia sins komot.
8" God don bless di pesin wey E don forgiv en sins!"
9 Dis blessin wey David dey tok abaut so, na onli Ju pipol e tok am for, bikos dem sekonsaiz dem? No! Na stil for Gentai pipol wey dem nor sekonsaiz. Bikos wi read for God wod sey, "Abraham biliv God and bikos of en fate, God kon asept am as raitious pesin."
10 Na wen all dis tins tak hapun? Na bifor dem sekonsaiz Abraham or afta dem sekonsaiz am? Na bifor, nor bi afta dem sekonsaiz am!
11 Bot lata, dem kon sekonsaiz am. Dis sign show sey, bikos of en fate, God don si-am as raitious pesin, so dat e go bi papa to evribodi wey biliv God, pipol wey God don asept, ivun doh dem neva sekonsaiz.
12 Doz wey don sekonsaiz, na Abraham bi dia papa and dia fate bi laik en own, afta dem sekonsaiz am.
13 Wen God promis Abraham and en shildren sey dem go inherit di hol wold, E du-am, nor bi bikos Abraham dey obey di law, bot bikos e biliv God and God si-am as raitious pesin.
14 If God promis na for onli doz wey dey obey di law, den fate nor min enitin and God promis go dey yuzles.
15 Di law dey bring God vesnashon, bikos wer sin nor dey, law nor go dey.
16 Na dis won mak God promis dey kom by fate and wi dey get-am tru favor. Nor bi onli pipol wey dey obey di law bi Abraham shildren, bot pipol wey biliv God laik Abraham, na en shildren dem bi tu, bikos na Abraham bi awa spiritual papa.
17 God wod sey, "I don mak yu papa for meni nashons." So for God eye, Abraham na awa papa, bikos e get fate for God wey get pawa to raiz pipol wey don die and to komand tins wey nor dey bifor, laik sey dem dey.
18 Ivun wen tins hard, Abraham stil biliv God and e hope sey God go du-am, ivun wen e bi laik sey, nor-tin go hapun. Bot naw, e don bikom, "Papa for meni nashons." Jos as God tel am, "Yor shildren go meni laik di stars wey dey hevun."
19 Abraham nor komplain for won day, ivun wen e don old nearli rish ondred years. Ivun doh E no sey en bodi don nearli die and en wife Sarah nor go fit born again,
20 e nor doubt God promis. En fate mak am strong and e tank God for evritin.
21 E dey sure sey God go du wetin E promis.
22 Na dis mak God kol am raitious pesin.
23 Ivun doh God kol am 'Raitious pesin', E tok dis wod bikos of onli Abraham?
24 No! E tok am for wi tu wey God go stil asept as raitious pipol; wi wey biliv sey God raiz Jisos Kraist from deat.
25 Na awa sins mak God giv Jisos Kraist to dem mak dem kil-am and God raiz-am from deat, so dat e go mak us raitious pipol.