Nigerian Pidgin Bible
Romans 11
1 I dey ask, God don rejet Izrel, en pipol? No! Mi tu, na Izrel pesin, I bi Abraham pikin wey kom from Benjamin tribe.
2 God nor rejet en pipol wey E shuz from di biginin. Dem rite for God wod abaut haw Elija beg God for Izrel pipol sey,
3" Oga, dem don kil all yor profets. Dem don skata yor alta, na onli mi rimain and dem dey trai to kil mi tu!"
4 Na wish ansa God gi-am? E tel am, "I stil get sevun tazon men wey neva woship Baal juju at-all."
5 Na so e bi naw tu, som Izrel pipol stil dey woship God bikos of en grace.
6 If na by grace God shuz dem, dat min sey, nor bi by pesin pawa: bikos if na by pesin pawa, den grace nor min enitin again.
7 Dis min sey, na onli few pipol for Izrel fit get wetin all of dem dey faind. Di res nor gri listin to God, bikos of dia stubornes,
8 jos as God wod sey, "God mak dem foolish sotey dia eye nor dey si and dia ear nor dey hear til today."
9 Bot David sey, "Mak di fud wey dem dey chop, kause trobol for dem kon fal laik stone for dia head and mak God ponish dem.
10" Mak dia eye blind, so dat dem nor go fit si. Mak wahala bend dia bak foreva."
11 I dey ask again, Izrel pipol wey fal nor go get up again? No! Bot bikos of dia sins, Gentai pipol don get salvashon and dis tin, dey mak Izrel pipol jelos.
12 If Izrel pipol sin fit mak Gentai pipol dey save, dat min sey, wen Izrel pipol turn go mit God, pipol wey go dey save, go plenti wel-wel.
13 Naw, I dey tok to una wey bi Gentai pipol and as long as I bi una apostol, I dey hapi wit di wok wey I dey du,
14 so dat my pipol go dey jelos, bikos of wetin God dey du for Gentai pipol. Dis go mak dem turn from sin kom mit God and E go save dem.
15 Bikos wen God rejet Izrel pipol, di hol wold kon get savalshon. Na haw e go kon bi, wen God asept dem bak? E go giv life to pipol wey won die.
16 If dem giv God di first part for bread, den na God get all di bread and if dem giv God tri root, den di hol tri don bi en own tu.
17 Gentai pipol, una bi laik bransh wey dem add join olive tri. Una don tak di place for som bransh wey God first kut komot. So una dey enjoy di blessins, wey di root dey giv.
18 So mak una nor boast, bot mak una rimemba sey, nor bi una dey mak di root stand, bot na di root dey sopot una.
19 So una go sey, "God break di bransh komot, mak E for fit si place wey E go put us."
20 Tru-tru, God break Izrel pipol komot from di tri, bikos dem nor biliv am. Bot una dey wer una dey, bikos una get fate. So, mak una nor dey boast, insted, mak una dey fear wetin God fit du.
21 If God nor sori for Izrel pipol wey bi di natura bransh, una tink sey E go sori for una if una sin?
22 Naw, una don si haw God dey gud and harsh. Ivun doh E dey ves for doz wey fal, E stil dey kaind to una. And E go always dey kaind to una, as long as una dey du wetin E wont. If not, E go rejet una tu.
23 If Izrel pipol turn bak kon mit God, E go put dem bak for di tri, bikos E get pawa to du-am.
24 Una wey bi Gentai pipol bi laik olive tri bransh wey dem kut for bush kon go put for anoda beta olive tri (and e nor sopoz bi laik dat). Na Ju pipol bi di beta olive tri; so e go eazi for God to join dem bak to di origina tri again.
25 My frends, I nor won mak una dey boast abaut unasef. So I go tel una wetin hapun to Izrel pipol. Som of dem stuborn wel-wel and na so dem go bi ontil di numba of Gentai pipol wey God wont, don komplit.
26 Na so God go save all Izrel pipol jos as en wod sey, "Di pesin wey go save Izrel pipol go kom from Zion, den, Jacob shildren nor go dey du bad tins again.
27" And na dis go bi my agriment wit dem wen I don forgiv dem dia sins."
28 As e bi sey Ju pipol rejet God wod, dem don turn to God enemi, bikos of una wey bi Gentai pipol. Bot as God wont am, dem bi pipol wey E luv, bikos of dia gran-gran papa dem.
29 God nor dey tak bak wetin e don alredi giv pipol or shange en maind abaut di pipol wey E don shuz.
30 As for una wey bi Gentai pipol, una don disobey God bifor, bot naw, God don sori for una, bikos Ju pipol nor gri obey am.
31 Bikos God don sori for una, E go stil sori for dem tu.
32 God trit evribodi as prizinas, bikos wi nor gri du wetin E tel us. Bot E du-am laik dat, so dat E go fit sori for all of us.
33 Hu fit no haw God big rish? Hu fit no haw God wisdom and undastandin bi? Hu fit esplain why God dey du wetin E dey du!
34 Na hu no wetin dey God maind? Hu go fit advise God?
35 Wish pesin don boro God somtin kon sey God go pay am bak?
36 Bikos na God kreate evritin and na tru am evritin dey. Mak praiz bi en own foreva and eva! Amen.