Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Matthew 21

1 As Jisos and en disaipols near Jerusalem, dem kom rish Betpage for Mount Olives, so Jisos kon send tu disaipols

2 kon tel dem, "Mak una go di vilage wey dey una front. Una go si won donkey and en pikin wey dem tie for der. Luz dem and bring dem kon mit mi.

3 “If enibodi ask, 'Why una dey luz di donkey dem?' Mak una ansa, 'Di oga nid dem and e go riton dem bak naw naw.' “

4 Dis hapun so dat wetin di profet tok go bi tru:

5 “Tel Zion pipol, 'Si! Una king dey kom mit una, e humbol ensef kon sidan on-top donkey.' “

6 Di disaipols kon go du as Jisos tel dem.

7 Dem bring di donkey kon put dia klot mak Jisos for sidan on-top.

8 Meni pipol spread dia klot for di road. Odas kut palm leaf kon spread dem for di road tu.

9 Pipol wey dey go for Jisos front and dem wey dey folo am kon dey shaut, "Praiz David Pikin! Di pesin wey kom wit God name, God go bless am! Mak wi praiz God wey dey hevun! “

10 As Jisos enta Jerusalem, di tawn skata and pipol kon dey ask, "Hu bi dis? “

11 Pipol wey dey folo Jisos kon sey, "Dis na Jisos, di profet from Nazaret for Galili. “

12 Den Jisos enta di Tempol aria kon driv all di pipol wey dey buy and sel insaid di Tempol, e skata di tabol and chair wey di pipol dey tak shange moni and sel dove.

13 Jisos kon tel dem, "God wod sey, 'Dem go kol my haus, 'Praya Haus', bot una don turn am to wer tif dey hide put! “

14 Jisos heal pipol wey blind and doz wey nor fit waka insaid di Tempol yard.

15 Bot wen di prist oga dem and di law tishas si di wondaful tins wey Jisos dey du and hear shildren dey shaut, "Praiz, David Pikin “for insaid di Tempol, dem kon dey ves.

16 So di prist oga dem and di tishas kon ask Jisos, "Yu dey hear wetin dem dey tok? “Jisos ansa dem, "Yes! Una neva read sey, 'Na shildren and smol pikin wey dey suck breast go praiz God? “

17 Jisos kon liv dem go Betani kon stay der til day break.

18 For earli mornin, as Jisos dey go bak to di tawn, e kon dey hungri.

19 E si won fig tri for di road kon waka go wer e dey, bot e nor si enitin plok, bikos na onli leaf di tri get. So e kon tel di tri, "Yu nor go eva bear frut again! “At wons, di fig tri kon bigin die.

20 Wen di disaipols si wetin hapun, dem sopraiz kon sey, "Haw dis fig tri kwik die laik dis? “

21 Jisos ansa dem, "I tel una tru wod, if una get fite and una nor doubt, una nor go onli du wetin hapun to dis fig tri, bot if una tel dis mountin, 'Mak yu move go insaid di sea, e go-go.'

22 “If una biliv, una go get enitin wey una ask for, wen una pray. “

23 Afta Jisos enta di Tempol, di prist oga dem and di eldas kon ask am wen e dey tish sey, "Na wish pawa yu tak dey du all dis tins and hu giv yu di pawa? “

24 Jisos ansa dem, "I won ask una won kweshon. If una ansa mi, den misef go tel una wish pawa I tak dey du dis tins.

25 “Wer Jon baptism from kom? Na from hevun or pipol? “Dem kon dey tok abaut di mata among demsef sey, "If wi sey, 'Na from hevun,' E go sey, 'Den why una nor biliv am?'

26 Bot if wi sey, 'Na from man,' wi dey fear di pipol, bikos dem biliv sey na profet Jon bi. “

27 So dem kon ansa Jisos, "Wi nor no. “Jisos kon tel dem, "Misef nor go tel una wish pawa I tak dey du all dis tins.

28 Wetin una tink? Won man get tu boys. E tel won, 'My pikin, go wok for my farm today.'

29 “Di boy ansa, 'I nor go-go.' Bot afta, e shange en maind kon go.

30 “Di papa kon tel di oda boy di same tin. Dis won kon ansa, 'I go-go sir,' bot e nor go.

31 “Wish of di tu shildren du wetin dia papa wont? “Dem ansa, "Di first won. “Jisos kon tel dem, "I tel una tru wod, tax koletors and ashawo dem go first una enta God Kindom!

32 “Jon di Baptist kom show una di tru road and una nor biliv am. Bot tax koletors and ashawo dem biliv am. Ivun wen una si all dis tins wey I du, una stil nor shange una maind kon biliv God. “

33 “Mak una hear anoda parabol: Won man plant vine for en farm, fence am round, dig pit wer dem go for press di frut wey dem go tak mak wine and build wer securiti go stay. Den e rent di farm giv farmas kon travol go far place.

34 “Wen havest taim don rish, e send en savants go mit di farmas mak dem gi-am en own share.

35 “Bot di farmas seize di savants, beat won, kil won and stone di oda won.

36 “Den di man kon send oda savants wey plenti pas di first one go mit di farmas and dem du di same tin to dem.

37 “At last, e send en own pikin go, dey tink sey, 'May-bi dem go respet my pikin.'

38 “Bot wen di farmas si di boy, dem kon tel ish oda, 'Di landlord pikin wey go inherit en papa propati, afta e don die, na-im dey kom so. Mak wi kil-am and kolet wetin go bi en own.'

39 “So dem seize am, trow am komot from di farm kon kil-am.

40 “Wen di owna of di farm go kom, 'Wetin una tink sey e go du doz farmas?' “

41 Dem kon ansa Jisos, "E go distroi doz evil pipol! Den e go hire di farm giv oda farmas wey go gi-am wetin bi en own, wen havest taim rish. “

42 Jisos kon tel dem, "Una neva read God wod wey sey: 'Di stone wey di buildas rejet don bikom di pila? Dis na God wok and e dey wondaful for awa eye.'

43 “Na dis mak mi tel una sey, 'Dem go tak God Kindom from una and dem go gi-am to pipol wey go bear di kaind frut wey E wont.'

44 “Di pesin wey fal for dis stone go skata and di pesin wey dis stone go fal on-top, go grind to powda.

45 “Wen di prist oga dem and di Farisi pipol hear Jisos parabols, dem kon no sey e dey tok abaut dem.

46 “So dem kon dey trai to arres Jisos, bot dem dey fear, bikos di pipol biliv sey na profet e bi."

Open Bible reader