Nigerian Pidgin Bible
John 21
1 Afta dis, Jisos show ensef again to en disaipols near Tiberias Sea. Dis na haw e du-am.
2 Saimon Pita and Tomas (wey bi twins), wit Nataniel (wey en tawn bi Kana for Galili), wit Zebedi pikin and tu oda Jisos disaipols, kon gada togeda.
3 Saimon Pita kon tel dem, "I dey go kash fish." Dem sey, "Wi tu go folo yu go." Den dem komot go enta won kenu. Bot dat nite dem nor kash eni fish.
4 Wen day break, Jisos stand for di wotasaid, bot di disaipols nor no sey naim dey der.
5 Jisos kon ask dem, "My shildren, una kash eni fish?" Dem ansa, "No o-o."
6 E kon tel dem, "Mak una trow una net go di rite side for di kenu and una go kash som fish." Wen dem don trow dia net insaid di riva, dem nor fit draw am komot from di wota, bikos di fish wey dem kash, plenti wel-wel.
7 Den, Jon, di disaipol wey Jisos luv kon tel Pita, "Dis man na Jisos o-o." Wen Saimon Pita hear sey di man na Jisos, e kon kwik-kwik tie en klot wel (bikos e nor wear enitin unda), den e kon jump insaid di riva.
8 By dis taim, di oda disaipols dey insaid di kenu dey pul di net wit di plenti fish go rish groun for di wotasaid (bikos wer dem dey, na abaut won ondred yard from di wotasaid).
9 Wen dem don kom dan from di kenu, dem kon si shakol fire wit fish and som bread on-top am.
10 Jisos tel dem, "Mak una bring som of di fish wey una kash kom."
11 Den Saimon Pita enta di kenu kon pul di net kom groun. Di net kash plenti big-big fish wey rish won ondred and fifti-tiri and di net nor tear.
12 Jisos kon tel dem, "Mak una kom chop." Bot dem nor fit ask am, "Hu yu bi"? bikos dem biliv sey na Jisos e bi.
13 Den Jisos kon giv dem bread and fish.
14 Dis mak am di ted taim wen Jisos show ensef to en disaipols, afta e don kom out from grave.
15 Wen dem don chop finish, Jisos kon ask Saimon Pita, "Saimon, Jon pikin, yu luv mi pas all dis tins?" E ansa, "Yes, Oga! Yu no sey I luv yu". Jisos kon tel am, "Mak yu fid my ship."
16 Jisos ask am again, "Saimon, Jon pikin, yu rili tink sey yu luv mi?" Pita ansa, "Yes, oga! Yu no sey I luv yu." Jisos kon tel am, "Mak yu kare for my ship."
17 Jisos ask am di ted taim, "Saimon, Jon pikin, yu sure sey yu luv mi so?" Pita heart kon heavi, bikos e pain am wel-wel, as Jisos ask am di same kweshon tiri taims, "Yu sure sey yu luv mi so?" Den Pita kon sey, "Oga, yu no evritin, yu no sey I rili luv yu." So, Jisos kon sey, "Mak yu fid my ship.
18 "I tel yu tru wod, wen yu dey smol, yu dey du as yu laik, dey dress as yu laik and dey go eniwer wey yu wont, bot wen yu go kon old, yu go spread yor hand and oda pipol go help yu tie yor klot and kari yu go wer yu nor won go."
19 (Jisos tok dis to show haw Pita go die, so dat God go get onor). Afta Jisos tok finish, e kon tel Pita, "Mak yu folo mi."
20 Wen Pita turn roun, e kon si Jon, (di disaipol wey Jisos luv wel-wel), dey folo dem. (Dis na di disaipol wey bend en head near Jisos chest wen dem dey chop kon ask am, "Oga, hu bi di pesin wey go sel yu giv yor enemi?")
21 Wen Pita si-am, e kon ask Jisos, "Oga, wot abaut dis man?"
22 Jisos ansa am, "Mak yu maind yor own biznes. If I wont sey mak e stay ontil I kom bak, wish won konsan yu insaid? Mak yu yorsef folo mi."
23 Den di rumor kon dey spread among di brodas and sistas sey, di disaipol nor go die. Bot Jisos nor rili tel Pita sey di oda disaipol nor go die, bot e tok sey, "If I wont sey mak e stay ontil I kom bak, wish won konsan yu insaid?"
24 Na dis bi di disaipol wey bear witnes abaut all dis tins and wey rite dem and wi no sey wetin e rite, na tru.
25 Jisos du meni oda tins wey dem nor rite dan. If to sey dem rite all of dem, di wold nor go get space wey go kontain all di books, wer dem rite dem put.