Nigerian Pidgin Bible
Jeremiah 49
1 Na wetin God don talk about Ammon be this: Where men of Israel dey? Shey nobody dey wey fit defend their land? Why dem don allow people wey dey worship Molech take the territory of Gad tribe and settle for there?
2 But the time dey come when I go make people of the capital city of Rabbah hear noise of battle, and e go destroy am and go burn hin village to ground. Then Israel go take hin land back from those wey take am from them.
3 People of Heshbon, make una cry out! Ai don destroy! Women of Rabbah, make una start to dey cry! Make una wear sackcloth and cry. Make una run around in confusion. Dem go take una god Molech go foreign country, together with him priest and prince.
4 Why you people wey no get faith dey boast? Una strenght dey fail. Why una dey trust in una power and talk say no one fit try attack una?
5 I go bring fear on una from every side. All of una go run away. Each one go run for him life, and no one go dey wey go bring una army together again.
6 But later on I go make Ammon prosper again. I, the LORD, don talk.
7 Na wetin the LORD Almighty talk about Edom be this: Shey people of Edom don lost their good judgement? Shey their adviser no fit tell them wetin dem go do again? Shey all their wisdom don disappear?
8 People of Dedan, make una turn and run! Make una hide! I go destroy Esau descendant, because the time don come for me to punish them.
9 When people dey pick grape, dem dey leave few on top the vines, and when robbers come for night, na only wetin dem want dem dey take.
10 But I don naked Esau descendants completely and I don expose where dem dey hide, so that dem no go fit hide again. All people of Edom don destroy. None of them remain.
11 Make una leave una orphan with me, and I go take care of them. Una widow fit depend on me.
12 Even if those wey I no suppose punish come drink from the cup of punishment, shey una think say una no go get punished? No, una must drink from the cup!
13 I myself don swear say the city of Bozrah go become place wey dey bring fear and turn desert, people go laugh am and dem go use hin name as a curse. All nearby villages go perish forever. I, the LORD, don talk.
14 I talk say, Edom, I don receive message from the LORD. He don send message to tell the nations make them gather their armies and make dem get ready to attack una.
15 God go make una weak, and nobody go respect una.
16 Una pride don deceive una. Nobody dey fear una reach as una dey think say dem fear. Una dey live on top rock face, wey high on top mountain; but even though una dey live for high place like eagle, God go bring una down. God, don talk.
17 God talk say, The destruction wey go come on top Edom go dey terrible so tey shock and fear go catch everybody wey dey pass.
18 The same thing wey happen to Sodom and Gomorrah go happen to Edom, wey be say them and towns wey near them go perish. Nobody go live for there again. I, the LORD, don talk.
19 Like lion wey dey come out of the thick wood along Jordan up along the green pasture land, I go come and make Edomite run away from their country. Then the leaders wey I choose go rule the nation. Who be like me? Who fit try challenge me? Which kind ruler fit stand against me?
20 So make una hear the plan wey I don make against people of Edom, and wetin I wan do to the people of the city of Teman. Dem go even drag their children commot and everybody go fear.
21 When Edom fall, noise go dey wey go make all the earth shake, and dem go hear the cry of the alarm from far away Gulf of Aqaba.
22 The enemy go attack Bozrah like an eagle wey dey speed down with hin wings. On that day the soldier of Edom go dey shocked like woman wey dey labour.
23 Na wetin God say about Damascus be this: The people in the cities of Hamath and Arpad dey worry and their mind no dey at rest because dem don hear bad news. Worry dey roll on top them like sea, and dem no fit rest.
24 The people of Damascus dey weak and dem don run in fear. Dem dey for pain and suffering like woman wey dey labour.
25 The popular city wey dey happy before don empty totallly.
26 On that day her young men go die for city street, and all her soldier go destroy.
27 I go set wall of Damascus on fire and I go burn king Benhadad palace. I, the LORD Almighty, don talk.
28 Na wetin God say about tribe of Kedar and the district wey Hazor dey control, wey king Nebuchadnezzar of Babylonia defeat be this: Make una attack the people of Kedar and destroy that tribe of eastern people!
29 Make una take their tent and their animals, their tent curtain and everything for their tent. Make una take their camels and tell the people say, Fear dey all round una!
30 People of Hazor, I, the LORD, warn una say make una run away and hide. King Nebuchadnezzar of Babylonia don plan against una, and na wetin he say be this,
31 Come on! We go attack those people wey dey feel safe and secured! Their city no get gate or lock and e no dey protected at all.
32 Make una take their Camel and all their livestock! I go scatter those people wey cut their hair short in every direction, and I go bring disaster on them from every side.
33 Hazor go turn desert for ever, a place where only fox dey live. No one go live for there again. I, the LORD, don talk.
34 Soon after Zedekiah become king of Judah, the LORD Almighty follow me talk about the country of Elam.
35 He talk say, I go kill all the bowmen wey don make Elam powerful.
36 I go make wind blow against Elam from all directions, and I go scatter her people for everywhere, until country no dey again wey her people wey run commot never go.
37 I go make people of Elam fear their enemy, wey wan kill them. I go destroy people of Elam with my great anger and I go send armies against them until I don destroy them finish.
38 I go destroy their king and leaders, and set up my throne for there.
39 But later on I go make people of Elam prosper again. I, the LORD, don talk.