Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Colossians 1

1 Dis leta na from mi Pol, Jisos Kraist apostol and Timoti my broda, bikos na so God wont am.

2 To all God pipol for Kolosey, wey bi awa brodas and sistas for Kraist. Mak God awa Papa giv una grace and peace.

3 Wi dey always tank God wey bi Jisos Kraist Papa, enitaim wen wi dey pray for una,

4 since wi hear abaut haw una biliv Kraist and di luv wey una get for God pipol.

5 Wen una first hear abaut di Gud News wey bring trut, una kon get luv and fate for wetin God priper for una for hevun and na dis gospol

6 kom mit una. Dis gospol dey bear frut for di hol wold and since di day wey una hear am, una don undastand as God grace big rish and e don dey bear frut and grow among una.

7 Awa broda Epafras, wey dey wok for Kraist wit all en maind, ivun doh wi nor dey der, na-im tish una di gospol

8 and e kon tel us abaut di luv wey di Spirit giv una.

9 Bikos of dis, wi tu, since wi hear abaut una, wi neva stop to dey pray for una. Wi dey tel God mak E show una wetin E wont, so dat una go dey wise and undastand God Spirit,

10 den una life go beta jos as Kraist wont. For all di gud tins wey una dey du, mak una dey bear frut and learn to no God more-more.

11 Wi stil dey pray sey una go dey strong wit God pawa wey get glori. Una go show sey una dey patient and get strong maind for God wok wit hapines.

12 Mak una dey tank God, bikos E don mak una share from wetin en pipol get for en kindom wey dey giv lite.

13 E save us from daknes pawa and put us for di kindom wey E giv di pikin wey E luv.

14 Dis na di pikin wey pay for us, so dat wi go dey fri and God go forgiv us awa sins.

15 God wey wi nor dey si, na Jisos bi en image and for evritin wey E kreate, na Jisos bi di first.

16 Bikos God kreate evritin for hevun and eart tru en pikin; both fisica and spiritual tins; weda dem get pawa or dey rule for difren-difren place; God kreate dem tru am and E kreate dem for am.

17 Kraist dey bifor evritin and bikos e dey, evritin stil dey wer dem dey.

18 Na-im bi head for di bodi wey bi di shosh and from di biginin, na-im bi di firstborn wey raiz-up from grave, so dat e go bi numba won for evritin.

19 God dey hapi sey evritin wey dey insaid am, dey insaid en pikin tu20and tru Kraist blood wey e pour out for us for di kros, God go draw evritin bak to ensef, afta E don mak peace wit tins for hevun and eart.

21 Bifor-bifor, bikos of di wiked tins wey una dey du and tink, una dey far from God and una bi en enemi.

22 Bot naw, wit en pikin blood, E don draw una klose kom en present, so dat E go mak una en frends wey nor get stain or fault and wey dey holi.

23 If tru-tru una get fate and una leg strong for groun, den una go get hope kon hol di gospol wey una hear. Dem don prish dis gospol giv evribodi for di wold and mi, Pol, I don kon bi di gospol savant.

24 I dey hapi for di sofa wey I dey sofa for una and for di shosh wey bi Kraist bodi, so I dey tak my bodi komplit wetin rimain for Kraist sofa.

25 I bi savant for di shosh, bikos of di wok wey God sey mak I du for una and I dey du-am to komplit God wok.

26 So di sikrit wey E hide from awa gran-gran papa dem and evribodi wey dey di wold bifor, E don opun am mak en pipol si.

27 God wont mak dem no di rishis wey dey en glori; wey di sikrit get for evribodi and na-im bi Kraist wey dey insaid una. So una get hope sey una go share for God glori.

28 As wi dey tel evribodi wetin dem go du, wi dey prish Kraist and tish wit wisdom, so dat wen wi go show una to Kraist, una go don dey pafet.

29 So na dis tins I dey strogol and wok for, akordin to en pawa wey dey wok insaid mi.

Open Bible reader