Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Acts 5

1 Won man wey dem dey kol Ananias wit en wife Safaira kon sel dia land.

2 Dem kon gri sey dem go kip som of di moni for demsef. So Ananias tak di rimainin moni go giv di apostols.

3 Bot Pita tel am, "Ananias, why yu alow Satan enta yor heart and yu kon dey lai giv di Holi Spirit? Why yu kip som of di moni wey una sel di land, for unasef?

4 "Bifor una sel di land, nor bi una own propati? Naw wen una sel am finish di moni nor stil bi una own to spend as una laik? Wetin mak una get dis kaind maind? Dis lai wey yu tok so, nor bi pesin yu du-am to, bot na God!"

5 Wen Ananias hear di wod wey Pita tok, e fal for groun at wons kon die. Dis tin mak fear kash evribodi wey hear wetin hapun.

6 So di young men wey dey der tak rapa kova en bodi kon kari am go bere.

7 Wen tiri hours don pas, en wife, Safaira waka kom, bot e nor no wetin don hapun to en husban.

8 Den Pita ask am, "Madam, tel mi di trut. Na dis bi di price wey una sel di land? Safaira ansa, 'Yes, na-im.'"

9 So Pita tel am, "Wetin mak yu and yor husban decide to trai God Spirit laik dis? Luk! Na di pipol wey go bere yor husban dey kom so and dem go kari yu go bere tu!"

10 At wons, di wuman fal for groun kon die for Pita front. So wen di young men enta insaid di haus kon si sey di wuman don die, dem kari am go bere near wer dem bere en husban put.

11 Fear kash pipol for di shosh and odas wey hear wetin hapun.

12 Na dis kaind mirakol and wonda God du tru di apostols for di pipol front and dem kon dey mit for Solomon Porsh.

13 Fear nor let enibodi wey nor dey among dem go join dem enihaw and e kon mak all di pipol dey respet dem wel-wel.

14 Bot plenti men and wimen wey biliv Jisos Kraist kon join dem,

15 sotey dem ivun dey kari sik pipol put for bed and mat for road, so dat as Pita dey pas, en shadow go heal dem.

16 Dem bring sik pipol and doz wey get evil spirit from all di tawns and vilage wey near Jerusalem and God heal all of dem.

17 Bot jelosi kon ful di High Prist and di Sadusi pipol maind,

18 so dem kon arres di apostols put for prizin.

19 Bot for dat nite, God angel opun di prizin door kon bring dem kom out and tel dem,

20 "Mak una go stand for di Tempol varanda bigin prish God wod wey dey giv pipol life."

21 Afta dem hear dis, dem enta di Tempol varanda for mornin kon start to dey tish di pipol. Den di prist oga dem and di pipol wey dey folo am kon kol di Sanhedrin, wey bi di big kansol for Izrel pipol. Dem kon send pipol go di prizin mak dem go bring di apostols kom, bikos dem won joj dia kase.

22 Bot di savant wey dem send go, nor si dem for di prizin, so dem go bak go ripot sey,

23 "Wi si sey dem lock di prizin wel and all di sojas stand for di front, bot wen wi opun di gate, wi luk insaid, bot wi nor si enibodi."

24 So wen di soja oga wey dey di Tempol and di prist oga dem hear dis tin, dem kon sopraiz wel-wel kon dey wonda wetin hapun to di apostols.

25 Na dat taim won pesin kon tel dem sey, "Si o-o, di men wey una put for prizin dey for di Tempol varanda dey tish pipol!"

26 So di soja oga wey dey di Tempol kon eskot di savant go bring di apostols, bot dem nor yuz fos, bikos dem dey fear sey di pipol wey gada der, fit stone dem.

27 Wen dem don bring dem insaid, dem kon sey mak dem stand for di kansol front and di prist oga dem kon dey kweshon dem.

28 E ask dem, "Wi komand una sey mak una nor tish pipol abaut dis name, bot si naw, di hol Jerusalem don ful wit di tins wey una dey tish. Una won put dis man blood for awa head?"

29 Bot Pita and di apostols ansa, "Wi go must obey God insted of humanbin"

30 "Di God wey awa gran-gran papa dem serv naim raiz-up Jisos Kraist wey una hang for tri.

31 "Bot God don promote am sey mak e sidan for en rite hand kon gi-am big posishon as Oga and di Pesin wey go save di wold, so dat Izrel shildren go turn from dia sin kom mit God mak e forgiv dem.

32 "All of us no sey dis tin na tru and di Holi Spirit wey God don giv to pipol wey dey obey am, dey stil bear witnes sey, dis tin na tru."

33 Wen di prist oga dem hear dis tin, dem kon ves wel-wel and won kil di apostols.

34 Den won Farisi wey dem dey kol, Gamaliel, wey dey tish di law and wey di pipol dey respet wel-wel kon stand-up tok, "Mak una send dis men go outsaid first."

35 Den e kon tok to di kansol, "Una Izrel oga, mak una tink wel bifor una du enitin to dis men.

36 "Bikos na so Teudas stil kom up bifor, dey tok sey en na pesin wey dey impotant and na abaut for ondred pipol folo am. Wen dem kil-am, all di pipol wey dey folo am skata and evritin kon end.

37 "Afta am, Judas wey kom from Galili kom out wen dem dey du census. E push pipol to join am opoz wetin dem dey du. Dem stil kil-am and all di pipol wey dey folo am skata tu.

38 "Naim mak I sey for dis mata so, mak una rimov una hand and liv all dis men alone, bikos if all di tins wey dem dey plan and du, na from dia maind, dem nor go succeed,

39 bot if na from God, una nor go fit stop dem, esept una won fite God."

40 So dem bring di apostols kom bak kon tel dia savant mak dem flog dem. Afta dem riliz dem, dem kon warn dem sey mak dem nor yuz Jisos Kraist name tak prish again.

41 So di apostols komot from der dey hapi wel-wel sey God don giv dem di shanse to sofa, bikos of Jisos Kraist.

42 So evriday for di Tempol kompond and from haus to haus, dem kontinu to dey tish and prish di Gud News sey, "Jisos Kraist naim bi di Mezaya."

Open Bible reader