Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Acts 26

1 So Agrippa tel Pol, "Mak yu tok for yorsef naw." Den Pol raiz en hand kon start to tok.

2 "King Agrippa, abaut all dis tins wey di Ju pipol dey akuiz mi sey I du, I tank God sey I won difend mysef giv yu today,

3 bikos yu no all awa tradishon and di mata wey di Ju pipol dey akuiz mi abaut. So, I beg, mak yu listin to wetin I won tok.

4 "Naw, all di Ju pipol no sey na from smol pikin I dey liv my life wit my own pipol for Jerusalem.

5 "Since dem no mi, if dem go gri kon tok, dem go gri sey na haw wi dey serv God, naim I tak liv as Farisi.

6 "Naw, I stand mak dem joj mi, bikos I put hope for di promis wey God mak giv awa gran-gran papa dem

7 sey, awa twef tribes go gain as dem dey yuz all dia maind dey serv God, both day and nite. My king, na bikos of dis hope wey I get, naim mak di Ju pipol dey akuiz mi so!

8 "Why una tink sey God nor fit raiz pipol wey don die?

9 "Ivun mi mysef, I biliv bifor sey mak wi fite Jisos Kraist wey kom from Nazaret.

10 "And na wetin I du for Jerusalem bi dat. Nor bi onli sey I put meni of di bilivas for prizin wit di pawa wey di prist oga dem giv mi, bot I ivun dey sopot wen dem sey mak dem kil dem.

11 "I ponish dem meni taims for all di sinagog and I trai to fos dem mak dem kos God. Bikos dat taim, I dey ves for dem wel-wel, I ivun travol go oda tawns go sofa dem, bikos of wetin dem biliv.

12 "Bot won day, as I dey du all dis tins, I kon dey go Damaskus wit ful pawa wey di prist oga dem giv mi.

13 "My king, aroun aftanun for road, I kon si won kaind lite from hevun wey shine pas di sun. Di lite shine roun mi and di pipol wey dey folo mi travol.

14 "Wen wi don fal for groun, I hear won vois wey yuz Aramaic language tel mi, 'Sol, Sol, why yu dey ponish mi? Yu dey fite yorsef, bikos na stone yu dey kick so.'15"So I ask am, 'Oga! Hu yu bi?' Di Oga ansa, 'I bi Jisos Kraist wey yu dey ponish.

16 'Bot mak yu get up, bikos I don show mysef to yu and don shuz yu as my savant and witnes to di tins wey yu don si and di wons wey I go show yu.

17 'I go save yu from yor own pipol and from Gentai pipol wey I dey send yu go mit, so dat

18 yu go opun dia eyes mak dem for waka komot from daknes enta lite. Mak dem komot from Satan hand, go mit God, so dat God go forgiv dem dia sins and dem go folo di pipol wey God don mak klin, bikos dem biliv am.'

19 "So King Agrippa, I nor du strong head wen I risiv dis vishon wey kom from hevun,

20 bot I first go Damaskus, go tel di pipol wey dey der and den, I kon go mit di pipol wey dey for Jerusalem and Judea. Afta, I go mit Gentai pipol sey, mak dem turn from sin kom mit God and mak dem du tins wey go show sey, dem don rili turn from sin kom mit God.

21 "Bikos of dis, di Ju pipol seize mi for di Tempol front, won kon kil mi.

22 "Bot God don dey help mi til today, so I stand dey tel evribodi, weda dem bi smol pikin or big pesin. So, wetin di profets and Mosis tok sey go hapun, naim I dey tel una so,

23 sey Kraist sofa and e go bi di first to raiz from deat, so dat e go show di lite to awa pipol and ivun Gentai pipol."

24 As Pol dey difend ensef, Festus kon shaut, "Yu dis Pol, yu don dey krase o! All di plenti book wey yu no don dey won mak yu mad!"

25 Bot Pol ansa am, "I nor dey mad oga Festus, bot na beta wod wey mak sense naim I dey tok so.

26 "Ivun di king wey I dey tok to so, I biliv sey e no abaut all dis tins, bikos dem nor hapun for sikrit.

27 "King Agrippa! Yu biliv di tin wey di profets tok?"

28 So Agrippa ask Pol, "So yu tink sey jos naw-naw, yu fit turn mi to Kristen?"

29 Pol ansa, "I pray to God sey, weda na naw or leta, nor bi onli yu, bot evribodi wey dey here, go bi laik mi, bot mak una nor sofa, as I dey sofa so."

30 So di king, di govnor and Bernice kon get up

31 and as dem dey go, dem kon tel ish oda, "Dis man nor du enitin wey go fit mak dem kil-am or put am for prizin."

32 Agrippa kon tel Festus, "Wi for fit riliz dis man, if to sey e nor sey mak Caesar joj en kase."

Open Bible reader