Nigerian Pidgin Bible
Romans 3
1 Haw Ju pipol tak beta pas Gentai pipol sef? Or beta tin dey bikos dem sekonsaiz pesin?
2 E rili dey gud to sekonsaiz pesin! And wi no sey na Ju pipol God first giv en mesage.
3 Bot wot if som of dem nor gri biliv? Dat min sey God dey lai?
4 Ivun doh evri humanbin dey lai, God nor fit lai. God wod sey: "Mak yu dey tok wetin bi trut; so dat yu go fit win yor kase wen dem dey joj yu."
5 If God nor ponish us for di bad tins wey wi dey du, e min sey God dey sopot us? No! So if God ponish us, wi go sey E dey wiked? (Na so som pipol dey tok).
6 Wi nor fit tok so at-all! If God nor dey rite, na haw E go kon tak joj di wold?
7 If my lai-lai life dey show sey God wod na trut, wetin go mak am kondem mi sey I bi sina?
8 Den e go dey rite if wi sey, "Mak wi dey du bad tins so dat gud tins go kom out from wetin wi dey du?" Bot som pipol dey lai for my head, bikos of wetin I tok and God go ponish dem.
9 So wetin wi go tok? Wi go sey na wi wey bi Ju beta pas? Dat na lai! Bikos as I don alredi show una, Ju and Gentai pipol dey komit sin.
10 Jos as God wod sey, "Nobodi dey raitious.
11" Nobodi dey wey wise or undastand God.
12" Evribodi don turn liv God, all of dem don bi yeye for God eye. Nobodi dey du wetin gud at-all.
13" Na lai wey fit kil pesin ful dia mout and wiked wods ful dia tongue.
14" Bad bele dey dia maind and na so-so swear dem dey swear.
15" Dem go fit kwik kil pesin.
16" Eniwer dem go, dem must fite skata di place
17 and dem nor no haw to dey kwayet.
18" Dem nor dey fear God at-all."
19 Wi no sey wetin di law tok, na for di pipol wey dey unda di law. Di law tok laik dis, so dat nobodi go get eskuze wen God go joj di wold.
20 Nobodi dey gud for God eye, bikos e dey obey di law. Bot na tru di law, wi tak no wetin sin min.
21 Naw, God don show us haw wi go tak dey gud for en eye and nor bi tru di law, ivun doh na so Mosis law and di profets tok.
22 Na di fate wey pesin get for Jisos Kraist go mak am dey gud for God eye. Enibodi wey biliv Jisos, God dey mak en fate strong, weda e bi Ju or Gentai pesin.
23 Evribodi don sin and wi don fal komot from God glori,
24 bot God don mak us dey rite wit am tru en fri gift wey E giv us, bikos of Jisos Kraist wey save us.
25 Na God giv us Jisos Kraist, so dat tru en blood, E go forgiv us awa sins wen wi biliv Kraist. God du dis to show sey bifor-bifor, E dey patient to forgiv pipol dia sins.
26 Dis stil show sey God dey rite wen E asept pipol wey biliv Jisos Kraist. E dey ponish sinas, so dat wi go no sey en na God wey nor laik sin. Laik dis, God show sey en dey rite and enibodi wey biliv Jisos Kraist, E dey mak dem dey rite tu.
27 So, wetin mak us dey boast? Wi nor fit boast at-all! Why e bi laik dis? Na bikos wi dey obey di law? No! Na bikos wi biliv Jisos Kraist.
28 So, na tru fate pesin go dey rite wit God, nor bi as e obey di law rish.
29 Abi na onli Ju pipol God dey dia side? E nor dey Gentai pipol side tu? Tru-tru, God dey Gentai pipol side.
30 Since na onli won God dey, E dey for Ju and Gentai pipol, bikos of dia fate.
31 So mak wi trowey di law bikos of fate? No way! E nor go wok! Insted, wi go mak di law strong wel-wel.