Nigerian Pidgin Bible
Matthew 13
1 Dat same day, Jisos komot from di haus go sidan for Galili wotasaid.
2 Meni pipol gada round am, so e enta won boat and all di pipol stand for groun near di wota.
3 E kon yuz parabol tish dem meni tins: "Si! E get won farma wey go plants for en farm.
4 As e dey plant, som seed fal for road and bird kon chop dem.
5 Some fal for sand wey get big-big stone. Di sids kwik grow bikos di sand nor deep.
6 So wen sun kom out, e burn dem and bikos dia root nor deep wel, dem kon die.
7 Some sid fal for shuku-shuku. Dem grow bot di shuku-shuku, shuk dem die.
8 Bot som sid fal for beta groun. Dem grow wel kon bear oda sids, som bear rish ondred, som sisti and som tati.
9 Enibodi wey get ear, mak e hear!
10 Den di disaipols kom mit Jisos ask am, "Why yu dey tok to dis pipol wit parabol?
11 Jisos kon ansa dem, "God don mak una no all di sikrit tins abaut en kindom, bot dis pipol nor no.
12 Pesin wey get somtin, dem go gi-am more and wetin e get go kon plenti. Bot pesin wey nor get enitin, ivun di smol won wey e get, dem go tak am from am.
13 Naim mak I dey tok wit parabol sey: Dis pipol get eye, bot dem nor dey si, dem get ear, bot dem nor dey hear or undastand.
14 Na dis tin mak wetin Profet Isaia tok hapun, 'Una go listin wel-wel, bot una nor go undastand. Una go luk wel-wel, bot una nor go si enitin,
15' Dis pipol nor go fit undastand; dem nor won hear enitin, dem klose dia eyes mak dem nor for fit si and hear wit dia ear, dia maind don blok, so dem nor go fit undastand, bot if to sey dem fit turn kom mit mi, I for heal dem.'
16 Bot God go bless una eye, bikos dem dey si wel and una ear, bikos dem dey hear wod.
17 I tel una tru wod, meni profets and gud-gud pipol don wait taya mak dem for hear and si wetin una dey si, bot dem nor si or hear am.
18 So, mak una undastand wetin di farma parabol min:
19' Wen pesin hear God wod and e nor undastand am, di devol go kom tif di wod wey dem plant for en heart, dis na di sid wey fal for road.
20' Di sid wey fal for sand wey get big-big stone, na pesin wey hear di wod kon risiv am wit joy,
21 bot di sid nor get root, bikos di wod wey e hear nor strong for en heart, so wen trobol kom, e nor go fit bear-am.
22 Di sid wey fal for shuku-shuku, na pesin wey hear God wod, bot wahala, long-trot and to kwik get moni for dis wold kon shuk di wod die for en heart and e nor kon bear frut.
23' Bot di sid wey fal for beta groun, na pesin wey hear and undastand di wod. E kom bear frut wey rish ondred, sisti and tati."'
24 Jisos kon tel en disapols anoda parabol, "God Kindom bi laik wen pesin plant gud sid for en land.
25 Bot for nite wen evribodi dey slip, di enemi go plant grass join dem.
26 Wen di sids grow kon dey bear frut, di grass kon dey grow tu.
27 So di savants kon tel dia oga sey, 'Nor bi gud sid wi plant for yor farm? Na wer di grass from kom?'
28 Di oga kon ansa, 'Na enemi plant am.' So en savants sey, 'Yu wont mak wi go root dem komot?'
29 Bot e kon tel dem, 'No, if una go pul di grass komot, una fit mak mistak pul som from di gud sids tu.
30 Mak di gud sids and di grass grow togeda ontil havest. Dat taim, I go tel di pipol wey dey havest sey, 'Mak una first root all di grass, tie and burn dem, den gada di gud sids put insaid my store.'
31 Jisos kon tel dem anoda parabol: "God Kindom bi laik mustard sid wey won man plant for en farm.
32 Na di sid smol pas bot wen e grow, na di plant big pas oda plants for di farm and difren-defren birds kon build haus for en bransh.
33 Jisos stil tel dem anoda parabol: "God Kindom bi laik yist wey won wuman tak bake bread. E mix am wit plenti flawa and di smol yist kon mak di bread raiz wel-wel.
34 Jisos tok all dis tins for parabol to di pipol. Evritin wey e tel dem, na parabol e yuz.
35 E du-am so dat wetin di profet tok, go hapun: "I go opun my mout tok parabol, I go tok evritin wey bi sikrit since God kreate dis wold.
36 Den Jisos kon liv di pipol enta insaid haus. En disaipols kon tel am, "Tel us wetin di grass parabol for farm min.
37 Jisos ansa dem, "Di Pesin wey plant di gud sid na God Pikin;
38 di farm na di wold and di gud sid na di kindom pipol. Di grass na devol shildren,
39 and di enemi wey plant dem, na di devol. Di havest na di last days and di havest wokas na di angels for hevun.
40 Jos as dem gada di grass burn dem for fire, na so e go bi for di last day,
41 God Pikin go send en angels mak dem go rimov evritin insaid en kindom wey dey mak pipol sin and break God law.
42 Dem go trow dem insaid fire wey nor dey kwensh, wer dem go krai and grind dia tit.
43 Den, God pipol go shine laik sun insaid dia Papa Kindom. Enibodi wey get ear, mak e hear!
44 God Kindom bi laik gold wey dem bere for field. Won pesin wey si-am, kon hide am. Wit hapines, e go sel evritin wey e get buy di land.
45 Again, God Kindom bi laik trada wey dey luk for beta gold to buy.
46 Wen e si won gold wey dear wel-wel, e kon go sel evritin wey e get buy am.
47 Again, God Kindom bi laik net for sea wey kash difren-defren fish.
48 Wen di net ful, dem drag am komot from di wota, kon sidan bigin put di gud fish insaid difren kontaina and trowey all di bad won.
49 Na so e go bi for di day wen di wold go end. Angels go kom seprate evil pipol from di gud won
50 and dem go trow di evil pipol insaid hell fire, wer dem go krai and grind dia tit.
51 Jisos ask dem, "Una undastand all dis tins? Dem kon ansa, "Yes.
52 Den Jisos kom tel dem, "Enibodi wey dey tisha di law and e bi disaipol for God Kindom, go bi laik pesin wey get haus, kon bring new and old tins kom out from insaid di haus.
53 Wen Jisos tok di parabol finish, e kon komot for der.
54 Den e rish en vilage kon bigin tish di pipol for dia sinagog. Dem sopraiz wel-wel kon sey, "Wer dis man from get dis kaind sense and pawa wey e tak dey du mirakol sef?
55 Nor bi di karpenta pikin bi dis? Nor bi Mary bi en mama? James, Josef, Saimon and Judas, nor bi dia broda e bi?
56 Nor bi all en sistas dey stay here wit us so? Na from wer e for get all dis pawa?
57 So dem kon dey ves for am. Bot Jisos tel dem, "Profet dey get respet for evriwer, esept for en own vilage and among en famili.
58 So Jisos nor du meni mirakol for der, bikos dem nor biliv am.