Nigerian Pidgin Bible
Luke 22
1 Taim kon rish for Bread (wey nor get yist) Fist, wey dem dey kol Passova.
2 Di prist oga dem and di law tishas dey fine haw dem go tak kil Jisos, bot dem dey fear di pipol.
3 So, Satan kon enta insaid Judas Iskarot, won of Jisos twef disaipols.
4 E kon go tel di ofisa wey dey gaid di Tempol sey e go sel Jisos giv dem.
5 Dem hapi wel-wel kon promis am sey dem go giv am moni.
6 Judas gri and e kon bigin faind sikrit way to sel Jisos giv dem, so dat pipol nor go no.
7 Di day for di Bread (wey nor get yist) Fist, wen dem dey kil ship for sakrifais, kon rish.
8 Jisos tel Pita and Jon, "Mak una go priper di Passova fud wey wi go chop."
9 Dem kon ask, "Na for wer yu wont mak wi priper am?"
10 Jisos ansa dem, "Listin, wen una enta di tawn, una go mit won man wey kari wota pot, mak una folo am enta di haus wey e go enta,
11 mak una tel di pesin wey get di haus sey, "Di Tisha sey mak wi ask yu, 'Wer di room wey mi and my disaipols go for chop di Passova fud?'
12 "E go show una won big room wer tabol and chair dey for upstairs. Mak una priper evritin for der."
13 Wen dem go, dem kon si evritin as Jisos tel dem sey e go bi, so dem priper di Passova fud for der.
14 Wen di taim rish, Jisos sidan for wer dem dey chop and en disaipols kon join am.
15 Jisos tel dem, "I rili won chop dis Passova fud wit una bifor I go sofa.
16 "Bikos I tel una, I nor go chop am again, ontil evritin don komplit for God Kindom."
17 Den Jisos tak won cup wey get wine, afta e tank God, e kon sey, "Mak una tak dis cup and divide am among unasef.
18 "Bikos I tel una, from naw go, I nor go drink dis wine again, ontil God Kindom go kom."
19 Den Jisos tak bread, afta e tank God, e divide am kon gi-am to dem sey, "Na my bodi bi dis, wey God don giv una. Mak una dey always du dis tin to tak rimemba mi."
20 Laik dat, Jisos stil tak di cup afta dem don chop finish kon sey, "Dis cup wey God giv una, na di new agriment wit my blood."
21 "Una si, di pesin wey go sel mi giv my enimi dey chop wit mi for dis tabol.
22 "Bikos Man Pikin go die as God plan am, bot kos dey for di pesin head wey go sel am!"
23 So di disaipols kon bigin ask ish oda wish of dem go sel Jisos.
24 Dem kon dey kworel among diasef sey wish of dem big pas.
25 So Jisos tel dem, "Gentai kings dey giv dia pipol orda, yet di pipol stil dey kol dem, 'Pipol Frends.'
26 "Bot una nor sopoz to bi laik dat; di pesin wey important among una, must du laik sey naim smol pas and di lida, go bi laik savant.
27 "Na hu big pas? Di pesin wey sidan for tabol dey chop or di pesin wey dey serv am? Nor bi di won wey sidan for tabol? Bot I dey du laik savant among una.
28 "Na una stay wit mi wen I dey pas tru wahala.
29 "So, I giv una pawa to rule, jos as my Papa don giv mi.
30 "For my kindom, una go sidan chop and drink for my tabol and una go sidan for difren thrones dey joj di twef tribes for Izrel.
31 "Saimon! Saimon! Mak yu listin! God don alow Satan mak e test all of una, so dat God go fit seprate bad pipol from di gud wons.
32 "Bot Saimon, I don pray for yu mak yor fate nor for fail. Wen yu don turn bak kom mit God, mak yu help yor brodas tu."
33 Pita kon ansa, "Oga, I dey redi to folo yu go prizin and ivun die wit yu."
34 Jisos sey, "Pita, mak I tel yu di trut, fawo nor go du 'Kukuruku' dis nite ontil yu don tok tiri taims sey yu nor no mi."
35 Den Jisos tel dem, "Wen I send una go out, witout moni, bag or sandals, e get enitin wey una nid wey una nor get?" Dem ansa, "No!"
36 E kon tel dem, "Bot naw, pesin wey get moni or travolin bag must kari am. And pesin wey nor get sword must sel en klot kon yuz di moni by won. .
37 "Bikos I tel una, wetin dem rite for God wod abaut mi must hapun sey, 'Dem kount am join kriminas.' Bikos wetin God rite abaut mi dey hapun naw."
38 Di disaipols kon sey, "Oga, si tu sword for here." Jisos ansa, "E don du."
39 Den Jisos komot, kon waka as e dey always du, go Mount Olives and en disaipols folo am.
40 Wen dem rish der, Jisos kon tel dem, "Mak una pray so dat una nor go fal enta temtashon."
41 Den e liv dem, waka go far smol, kon nil dan dey pray,
42 "Papa, if Yu laik to du-am, mak Yu let dis sofa-cup pas mi. Bot mak e bi as Yu wont, nor bi as I wont am."
43 Won angel apier from hevun kon giv Jisos pawa.
44 Bikos Jisos dey strogol wel-wel for maind, e kon pray sotey en sweat kon bi laik blood.
45 Wen e pray finish, e go mit en disaipols kon si sey dem dey slip, bikos dem don taya wel-wel.
46 So Jisos tel dem, "Why una dey slip? Mak una get up pray, so dat una nor go fal enta temtashon!"
47 As Jisos stil dey tok, at wons som pipol kom and na Judas lid dem. E waka go mit Jisos kon kiss am for face.
48 So Jisos ask am, "Judas, na kiss yu tak sel Man Pikin?"
49 Wen doz wey dey near Jisos si wetin won hapun, dem ask, "Oga, mak wi yuz awa sword?"
50 Den won of dem atak di prist savant kon kut en rite ear komot.
51 Bot Jisos shaut for am mak e stop, den tosh di man ear kon heal am.
52 Den Jisos ask di prist oga dem, di offisas wey dey gaid di Tempol and di eldas wey kom mit am sey, "Una kari sword and wud laik sey una dey kom arres tif?
53 "Since wen I dey wit una for di Tempol una nor arres mi. Bot na una taim bi dis, di taim wey daknes pawa go rule."
54 Den dem arres Jisos, kari am go di High Prist haus. Bot Pita dey folo dem for bak-bak.
55 Wen dem don mak fire for di kompon senta kon sidan togada, Pita sidan wit di pipol tu.
56 Won savant girl si Pita sidan near di fire, e luk am for eye kon sey, "Dis man bin dey wit Jisos tu o-o.'
57 Bot Pita sey, "Wuman! Nor bi mi, I nor no am."
58 Afta somtaim, anoda pesin si-am kon sey, "Yu bi won of dem, nor bi so?" Bot Pita sey, "My frend! I nor bi won of dem o-o."
59 Wen won hour don pas, anoda pesin kon sey, "I sey dis man dey wit dem, bikos en tu kom from Galili."
60 Bot Pita sey, "Oga! I nor no wetin yu dey tok." At wons, as e stil dey tok, naim won fawo du, 'Kukuruku'.
61 Den Jisos turn luk Pita for eye and Pita kon rimemba di wod wey Jisos tel am, "Bifor fawo go du 'Kukuruku' dis nite, yu go don tok tiri taims sey yu nor no mi."
62 Den Pita kon go outsaid, bigin krai.
63 Di gaids bigin laff Jisos kon beat am enihaw.
64 Dem tie en eye kon dey ask am, "Oya profesai! Na hu nak yu so?"
65 Dem stil kos am wit difren wods.
66 Wen morinin rish, di eldas wit di prist oga dem and di law tishas kon gada. Den dem tak Jisos go dia kansol
67 kon tel am sey, "If yu no sey na yu bi Kraist, mak yu tel us." Bot Jisos ansa, "If I tel una, una nor go biliv mi
68 and if I ask una kweshon, una nor go gri ansa.
69 "Bot from naw go, Man Pikin go sidan for God rite hand wer pawa dey."
70 All of dem kon ask, "So, yu bi God Pikin?" Jisos ansa, "Na una tok am."
71 Den dem kon sey, "Why wi nid anoda witnes? Wi don hear am from en own mout!"