Nigerian Pidgin Bible
Luke 11
1 Won day Jisos dey pray for won place. Wen e pray finish, won of en disaipols kon tel am, "Oga! Mak yu tish us haw to pray, jos as Jon tish en disaipols.
2 So Jisos kon tel dem, "Wen una dey pray, mak una sey: 'Awa Papa wey dey for hevun, wi grit Yu, Mak yor kindom kom.
3 'Giv us di bread wey wi go chop today,
4 Mak Yu forgiv us awa sins, as wi dey forgiv doz wey du us bad. Nor let us enta temtashon.'"
5 Den Jisos tel dem, "Laik sey won of una go mit en frend for mid-nite sey, 'My frend, abeg giv mi tiri bread,
6 bikos won of my frend wey dey travol stop for my place and I nor get enitin to giv am chop.'
7 "Den yor frend kon ansa from insaid haus, 'Mak yu nor disturb mi. I don lock my door and mi and my shildren dey slip. I nor go fit get up giv yu enitin naw.'
8 "I tel yu tru wod, ivun if di man insaid, nor won get up bikos yu bi en frend, e go get up giv yu enitin wey yu wont, bikos yu nor let am res.
9 "So, I tel yu tru wod: Mak yu ask and God go giv yu, faind and yu go si wetin yu dey luk for, mak yu nok and di door go opun for yu.
10 "Bikos pesin wey ask, go get, pesin wey faind, go si wetin e dey faind and di pesin wey nok, di door go opun for am.
11 "Wish of una wey bi papa go giv en pikin snake, if e ask for fish?
12 "Or if di pikin ask for egg, una go gi-am skorpion?
13 "Since una fit giv una pikin gud tins, as una bad rish, wot of una Papa for Hevun wey go giv di Holi Spirit to enibodi wey ask am!"
14 Won day, Jisos kon driv dimon wey dey mak pesin nor fit tok komot for won man bodi. Wen di dimon don komot, di man bigin tok and di pipol sopraiz wel-wel.
15 Bot som of dem sey, "Belzibub wey bi dimon oga, na en pawa Jisos dey yuz tak driv dimons."
16 Bot oda pipol kon dey ask for sign from hevun, bikos dem won test Jisos.
17 Jisos no wetin dey dia maind, so e kon tel dem, "Eni kindom wer pipol dey fite ish oda nor go last and famili wey divide, go fal.
18 "So, if Satan kindom divide, haw en kindom go tak last? I dey ask una dis tin, bikos una dey sey na Belzibub pawa I tak dey driv dimons.
19 "If na Belzibub pawa I tak dey driv dimons, den na wish pawa una pikin dem dey yuz? So, na una pikin go joj una.
20 "Bot if na God pawa I tak dey driv dimon komot, naim bi sey God Kindom don rish wer una dey.
21 "Wen pesin wey get pawa redi wel-wel gaid en own haus, all en tins go dey safe.
22 "Bot wen pesin wey get pawa pas am atak and win am, di pesin go kari all di tins wey di man tak dey protet ensef kon divide di propati wey rimain.
23 "Enibodi wey nor dey wit mi, dey against mi and enibodi wey nor dey help mi gada, dey skata.
24 "Wen evil spirit komot for pesin bodi, e go dey waka enihaw, dey fine wer e go res, bot e nor go si. Den e go tel ensef, 'Mak I go bak to di haus wey I from komot.'
25 "Wen e kom bak kon si sey dem swip evriwer klin, arange am and nobodi dey stay der.
26 "E go-go bring sevun oda spirits wey wiked pas am join ensef and dem go stay for der, so di pesin kondishon go wos pas as e bi bifor."
27 As Jisos tok dis tins, won wuman for der kon shaut, "God go bless di bele wey born yu and di breast wey yu sok!"
28 Den Jisos sey, "Pipol wey hear God wod and du wetin e tok, na dem God don bless!"
29 As pipol dey plenti more-more, Jisos kon sey, "Pipol wey dey dis wold naw wiked wel-wel; dem dey luk for sign, bot God nor go show dem eni sign, esept di tin wey hapun for Jona taim.
30 "Jos as Jona bi profet for Nineve pipol, na so Man Pikin go bi sign for di pipol wey dey dis wold naw.
31 For Jogment Day, Sheba Queen go bear witnes against pipol wey dey dis wold naw and God go kondem dem, bikos di queen travol from far place kom hear di wise tins wey Solomon tish. Bot naw, pesin wey big pas Solomon dey here!
32 For Jogment Day, na so tu Nineve pipol go bear witnes against pipol wey dey dis wold naw, bikos dem turn from sin kom mit God, wen Jona prish giv dem. Bot naw, pesin wey big pas Jona dey here."
33 "Nobodi dey lite lamp put for unda basket or for wer pipol nor go fit si-am, bot dem go put am for wer pipol go si-am wen dem enta di haus.
34 "Na eye bi di lamp wey bodi get. If yor eye wel, lite go ful yor hol bodi, bot wen yor eye nor wel, na daknes go ful yor bodi.
35 "So mak sure sey wetin dey insaid yu, na lite, nor bi daknes.
36 "If lite ful yor bodi and daknes nor dey insaid at-all, e go shine wel-wel laik wen lamp dey shine for yor face."
37 As Jisos dey tok, won Farisi kol am kom en haus kon chop, so Jisos go sidan for wer dem go for chop.
38 Di Farisi sopraiz wel-wel wen e si sey Jisos nor first wosh hand, bifor e bigin chop.
39 Bot Jisos tel am, "Una wey bi Farisi pipol dey wosh outsaid cup and plate, bot insaid una bele, longtrot and wikednes ful am.
40 "Una bi fool! Nor bi God wey mak di outsaid stil mak insaid?
41 "Bot mak una from una heart giv to pipol wey nor get, so dat evritin go dey klin for una.
42 "Kos dey una head! Una wey bi Farisi pipol! Una dey giv God won out of evri ten tins wey una get! "Bot una dey forget pipol wey nor get.
43 "Kos dey una head! Una wey bi Farisi pipol! Una dey won sidan for beta chair for sinagog and una dey laik mak pipol dey grit una for market.
44 "Kos dey una head! Una bi laik grave wey pipol dey mash pas and dem nor no sey na grave."
45 Won of di men wey no di law wel-wel kon ansa, "Tisha, yu dey kos us as yu dey tok laik dis so o-o."
46 Bot Jisos ansa am, "Kos dey una head! Una wey sabi di law wel-wel! Una kari heavi load put for pipol bak and una nor won ivun tak hand tosh di load!
47 "Kos dey una head! Una dey build profets grave, di profets wey una gran-gran papa kil.
48 "Dis show sey una sopot di tins wey una gran-gran papa dem du, bikos dem kil di profets and una build dia graves!
49 "Na dis won mak God tok wit en wisdom sey, 'I go send profets and apostols go mit dem and dem go sofa and kil som of dem.'
50 "So di profets blood wey dem don kil since di wold start, di pipol wey dey dis wold naw, go tak dia head kari am.
51 "From wen dem kil Abel go rish di taim wen dem kil Zekaraya for di alta insaid di Tempol, dia blood dey dis pipol head and God go joj dem.
52 "Kos dey una head! Una wey no di law wel-wel! Una don sieze di key wey dey mak pipol no di trut! Since una nor gri enta, una nor wont mak oda pipol enta tu."
53 Wen Jisos komot from der, di pipol wey no di law wel-wel and di Farisi pipol kon dey ves, so from dat taim, dem kon bigin ask Jisos yeye kweshon abaut meni tins
54 and dem kon dey plan, so dat dem go fit faind wod for en mout, wey dem go tak hol am.