Nigerian Pidgin Bible
John 5
1 Jisos kon go won fist wey dem dey du for Jerusalem.
2 Won pool dey der wey near di Ship Gate, di name na Betsaida for Aramaic language. Na faiv roads pipol tak dey enta insaid.
3 Pipol wey nor wel, wey blind and wey nor fit waka dey laidan for di difren roads.
4 From taim-to-taim, won angel dey kom shake di wota and enibodi wey first enta di wota afta di angel don shake am, go wel.
5 Won man dey der wey nor fit waka for tati-ate years.
6 Wen Jisos si-am laidan for der, e kon no sey di man neva fit waka for long taim. So, Jisos kon ask am, "Yu won waka?"
7 Di man ansa am, "Oga, I nor get enibodi wey go put mi insaid di pool wen di wota dey shake. Enitaim I dey trai to enta di wota, anoda pesin go kwik enta bifor I rish der."
8 Jisos tel am, "Mak yu get up! Kari yor mat mak yu bigin waka."
9 At wons, di man get up, kari en mat kon bigin waka. (Dat day na Sabat).
10 Den di Ju oga dem kon tel di man wey dey waka naw sey, "Today na Sabat, yu nor sopoz to kari yor mat dey waka."
11 Naim e ansa dem, "Di man wey mak mi wel, tel mi sey, 'Mak I kari my mat and mak I bigin waka.'"
12 Dem kon ask am, "Hu bi di man wey sey, 'Mak yu kari yor mat, mak yu dey waka?'"
13 Bot di man nor no hu e bi, bikos Jisos don komot der and plenti pipol dey for dat place.
14 Afta dis, Jisos kon si di man insaid di Tempol. So e kon tel am, "Luk, yu don wel naw, mak yu nor komit sin again, oda-wise, di tin wey bad pas wetin du yu bifor, go hapun to yu."
15 Di man kon go tel di Ju oga dem sey, "Na Jisos bi di pesin wey mak mi wel."
16 Bikos Jisos dey du all dis tins for Sabat Day, di Ju oga dem kon dey mak trobol wit am.
17 So e tel dem, "My Papa dey wok evritaim and na so mi tu dey wok."
18 Bikos of dis, di Ju oga dem kon dey trai to kil-am, bikos dem sey e dey break di Sabat law and e dey kol God en papa, laik sey en and God na mate.
19 Naim Jisos ansa dem, "Mak I tel una tru wod, di Pikin nor fit du enitin wit en own maind, esept di tins wey e si en Papa dey du. And na enitin wey e si en Papa dey du, naim e dey du tu.
20 "Bikos di Papa get strong luv for en pikin, e dey always show am evritin wey e dey du and e go show am plenti tins wey pas dis won and una go sopraiz.
21 "As di Papa get pawa to tak wak pesin wey don die, na so tu di pikin get pawa to giv life to enibodi wey en won giv.
22 Di Papa nor dey joj enibodi, bot e don giv en pikin pawa to joj evribodi,
23 so dat evribodi go bow dan for di pikin as dem dey bow dan for di Papa. If enibodi nor bow show respet for di pikin, e nor go get di maind to respet di Papa wey send di pikin kom.
24 "I tel una tru wod, di pesin wey tak wetin I tok and biliv sey na di Papa send mi, go get life wey nor dey end and e nor go enta hell fire, bot e go get life wey nor dey end.
25 "I tel una tru wod, di taim dey kom and e don ivun rish groun naw, wen doz wey don die go hear Man Pikin vois and wen dem hear am, dem go wak-up and dem nor go die again.
26 "Bikos as di Papa get life for insaid am, na so e giv en pikin life tu.
27 "Di Papa don giv en pikin di pawa to joj pipol.
28 "So, mak dis wod nor sopraiz una, bikos di taim dey kom, wen all doz wey dey insaid grave go hear di pikin vois,
29 and di angels go kon seprate di pipol wey du gud tins, mak dem enta life wey nor dey end, bot God go kondem di pipol dem wey dey du bad tins.
30 "I nor go fit du enitin wit my own pawa, bot na wetin I dey hear from my Papa, naim I dey yuz tak joj. Eni jojment wey I giv, na tru won, bikos I nor dey du my own tin, bot I onli dey du as my Papa send mi.
31 "If I tok abaut mysef, e fit bi sey wetin I tok nor bi tru",
32 bikos anoda pesin dey wey go tok abaut mi and I no sey wetin e tok abaut mi, na tru.
33 "Una don send mesage go mit Jon and e don tel una tru wod.
34 "( I nor dey trust wetin pipol tok, bot I dey tel una dis wod mak God for save una.)
35 Jon lite shine wel-wel for smol taim and una hapi wen una si en lite."
36 Bot I get pesin wey go bear witnes abaut mi wey big pas Jon, bikos di wok wey my Papa giv mi mak I du, naim I dey du so; so di wok dey bear witnes sey, na my Papa send mi.
37 And my Papa wey send mi, en ensef don bear witnes abaut mi. Una neva hear my Papa vois or si-am bifor.
38 En wod neva stil dey insaid una, bikos una nor biliv sey na-im send mi.
39 Una dey read God wod wel-wel, bikos una biliv sey na wetin una read go giv una life wey nor dey end and na dis same wod dey tok abaut mi,
40 bot una nor redi to kom mit mi, so dat una go get life wey nor dey end.
41 "I nor laik mak pipol dey praiz mi,
42 bikos I no sey, una nor luv God for insaid una heart.
43 "I kom wit my Papa name and una nor gri asept mi, bot if anoda pesin kom wit en own name, una go asept am.
44 "Haw una go fit biliv wen una dey praiz ish oda and una nor kare for di praiz wey onli God fit giv.
45 "Mak una nor tink sey I go akiuz una bifor my Papa. Di tin wey go stand against una na di law wey Mosis rite, wey una dey put hope for.
46 "If una biliv wetin Mosis rite for di law, una sopoz to biliv mi tu, bikos na mi e rite abaut.
47 "Bot if una nor biliv wetin Mosis rite, haw una go tak biliv wetin I dey tel una naw?"