Nigerian Pidgin Bible
John 19
1 Den Pilate kon sey mak dem flog Jisos wit koboko.
2 Den di sojas go kut tri bransh wey get shuku-shuku mak krawn put for en head and dem kon wear am klot wey dear wel-wel.
3 Dem kon dey laff am, dey tak am mak ye-ye, dey sey, "Mak una kon si di Ju pipol king." Dem slap am for face meni taims.
4 Pilate kom out again kon tel di Ju oga dem sey, "I won bring am kom out for una, to let una no sey I nor si enitin bad wey e du."
5 So Jisos kom outsaid, wit di shuku-shuku krawn for en head and di fine klot wey dem gi-am wear. Den Pilate kon sey, "Na di man bi dis!"
6 Wen di prist oga dem and di Tempol polish dem si-am, dem kon dey shaut, "Nail am for kros! Nail am for kros!" Den Pilate sey, "Mak onli una go nail am. Bot as for mi, I nor si eni bad tin wey e du."
7 Di Ju oga dem ansa, "Wi get law and di law sey, e sopoz to die, bikos e sey en na God Pikin."
8 Wen Pilate hear wetin dem tok, fear kon kash am wel-wel.
9 So e enta di haus bak kon ask Jisos, "Na wer yu from kom sef?" Bot Jisos nor ansa am.
10 So Pilate kon sey, "Yu nor won tok to mi? Yu nor no sey I get pawa to fri or kil yu?"
11 Jisos ansa, "Yu nor get pawa at-all for my life, esept God gi-am to yu. So, na di pipol wey bring mi kom mit yu, na dia sin big pas yor own."
12 From dat taim, Pilate kon bigin faind way to fri Jisos, bot di Ju oga dem kon dey shaut, "If yu fri dis man, yu nor bi Caesar frend. Enibodi wey sey en bi king, na Caesar enimi e bi."
13 Wen Pilate hear wetin dem tok, e bring Jisos kom out kon sidan for di chair for wer e dey joj kase, (dem dey kol di chair, 'Di Stone Pavement', bot na Gabata dem dey kol am for Aramaic language.)
14 (Dat taim na aftanun for di day wen dem dey priper for Passova Fist). So, Pilate kon tel di Ju oga dem, "Mak una luk, na una king bi dis!"
15 Den, dem kon bigin dey shaut, "Kil am trowey! Kil am trowey! Mak yu kil-am!" Pilate kon ask dem, "Una wont mak I nail una king for kros?" Di High Prist dem kon sey, "Di onli king wey wi get na Caesar."
16 So Pilate kon gi-am to dem mak dem go kil-am. Den dem kon tak Jisos komot for der.
17 As Jisos kari en kros dey go, e kon rish di place wey dem dey kol "Di Skul" (na Golgota dem dey kol di place for Aramaic language.)
18 For der, dem kon nail Jisos for kros. Dem stil nail tu oda pipol for kros, won for en rite and di oda for en left.
19 Pilate kon rite for sign-board wey dem nail on-top Jisos kros, wey sey, "Dis na Jisos wey kom from Nazaret, wey bi di Ju pipol king."
20 Since di place wer dem kil Jisos near tawn, meni of di Ju pipol wey dey for Jerusalem kom read di sign-board, bikos dem rite am for tiri language wey bi Aramaic, Latin and Greek.
21 Den di chief prists kon tel Pilate, "Mak yu nor rite sey, dis na Ju pipol king", bot rite sey, dis man sey, 'I bi Ju pipol king.'"
22 Bot Pilate ansa dem, "Wetin I don rite finish, na so e go bi."
23 Wen di sojas don nail Jisos for kros, dem tear en klot and dem for kon divide am. Bot dem liv di fine koat (bikos e nor get wer dem join am, since dem weave-am from top go rish botom).
24 So di sojas tel ish oda sey, "Mak wi nor tear am, bot mak wi gambol to si hu go tak am. Dis tin hapun to show sey, wetin dem rite for God wod na tru sey, "Dem go divide my klot, afta dem don gambol for am".
25 By dis taim, di onli pipol wey stand near di kros wer dem nail Jisos, na-im mama; en aunti, Mary wey bi Klopas wife and Mary Magdalin.
26 So wen Jisos si en mama and Jon, di disaipol wey e luv wel-wel stand for der, e kon tel en mama, "Mama, luk, dis na yor pikin."
27 Den e tel di disaipol, "Mak yu luk, dis na yor mama." From dat taim, di disaipol kon tak Jisos mama go en own haus.
28 Wen Jisos si sey evritin don finish, e kon sey, "Wota dey hungri mi", (dis show sey wetin God tok, rili hapun).
29 Di sojas soak sponge insaid wine wey bita, wey dey won kontena for der kon put am for di bransh of won plant wey dem dey kol hyssop kon stresh am put for Jisos mout.
30 Wen e don taste di wine, Jisos kon sey, "Evritin don finish." Den e bend en head dan, kon die.
31 Dis tin hapun for di day wen dem dey priper for di Passova Fist and bikos dem nor wont mak di dead bodi dem stay for kros for Sabat Day, (bikos dat Sabat Day na special won for dem), di Ju oga dem kon tel Pilate mak dem break dia leg, to mak sure sey dem don die, so dat dem go fit bring dia dead bodi kom dan.
32 So di sojas break di oda tu pipol leg wey dem kil wit Jisos.
33 Bot wen dem rish di kros wey Jisos dey and si sey e don die, dem nor kon break en leg.
34 Bot won soja kon tak spear shuk di kona of en bele, den blood and wota kon dey rush kom out.
35 All dis stori na tru, (bikos na di pesin wey si dem hapun, naim tok abaut dem and wetin e tok na tru), so dat una go fit biliv.
36 All dis tin hapun to show sey, wetin dem rite for God wod na tru sey, "Dem nor go break won singol bone for en bodi."
37 And God wod stil sey, "Dem go stand dey sopraiz as dem dey luk di pesin wey dem shuk en bodi."
38 Afta dis taim, Josef wey kom from Arimatia, wey bi Jisos sikrit disaipol, (bikos e dey fear di oda Ju oga dem), kon ask Pilate mak e alow am kari Jisos dead bodi komot for der. Pilate gri for am and e go kari Jisos bodi komot.
39 Nikodimos, di man wey hide go si Jisos for nite, kon folo Josef. E kari perfume wey heavi rish sevunti-faiv pounds, wey dem tak myrrh and aloe spice mak.
40 Den dem pour di perfume for Jisos bodi kon rap am wit linen klot akordin to di way Ju pipol dey priper dead bodi for beria.
41 Won garden dey near di place wer dem kil Jisos and won new grave wey dem neva bere enibodi put bifor, dey insaid di garden.
42 Since dat day na di day wey Ju pipol dey priper for di Passova Fist and bikos di new grave dey near der, dem kon bere Jisos insaid di grave.