Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

John 18

1 Afta e don tok finish, Jisos and en disaipols komot kros go Kidron Vali kon enta won big farm.

2 (Judas, wey sel Jisos, no di place, bikos Jisos don go der wit en disaipols meni taims).

3 So Judas kon eskot meni soja, som Tempol polish and Farisi pipol enta di farm. Dem hol lamp, tosh and som hol sword and stick for hand.

4 Bikos Jisos no evritin wey go hapun to am, e kon ask dem, "Hu una dey faind?"

5 Dem ansa am, "Na Jisos wey kom from Nazaret." E kon tel dem, "Na mi bi di pesin." (Judas wey sel am, stand der wit dem).

6 So wen Jisos don tel dem sey, "Na mi bi di pesin", dem dress go bak kon fal for groun.

7 Den Jisos ask dem again, "Hu una sey una dey faind?" Dem ansa, "Na Jisos wey kom from Nazaret."

8 Jisos kon sey, "I don tel una sey na mi bi di pesin. Since na mi una dey faind, mak una alow dis men go."

9 (E tok dis wod mak e bi sey wetin dem rite for God wod na tru, "I nor loss enibodi wey Yu giv mi.")

10 Den Saimon Pita bring en sword out kon kut di High Prist savant rite ear komot. (Di savant name na Malkus).

11 Jisos kon tel Pita, "Mak yu put yor sword bak for wer e dey bifor! Yu nor no sey I go drink from di sofa cup wey my Papa giv mi?"

12 Den di sojas wit dia oga and di Ju oga dem tak Jisos kon tie-am wit rope.

13 Dem tak am go mit Annas, Kaifas fada-en-law, wey bi di High Prist for dat year.

14 (Dis na di Kaifas wey advise di Ju oga dem sey, "E gud mak won man die for evribodi").

15 Saimon Pita wit anoda disaipol kon folo dem as dem dey tak Jisos go mit Annas. (Di oda disaipol no di High Prist wel-wel, so e folo Jisos enta insaid di High Prist kompoun).

16 Bot Saimon Pita stand outsaid di kompoun near di door. Den di oda disaipol wey no di High Prist kom out tok to di savant girl wey dey gaid di gate and e kon alow Pita enta insaid.

17 Di girl wey dey di gate kon ask Pita, "Yu nor bi won of dis man disaipol?" At wons, Pita kon ansa, "I nor bi won of dem."

18 For dis taim, all di savant and gaids gada roun shakol fire wey dem mak to warm demsef, bikos kold strong wel-wel. Pita folo dem stand der dey warm ensef tu.

19 As dem dey der, di High Prist bigin dey ask Jisos kweshon abaut en disaipols and wetin e tish.

20 Jisos kon ansa am, "Na for publik I tok wetin I tish. Na insaid sinagog and Tempol wer all di Ju pipol dey gada, na der I for dey tish. I nor tok enitin for sikrit.

21 "Why yu dey ask mi? Mak yu ask di pipol wey hear mi. Dem no wetin I tok."

22 Afta Jisos don tok finish, won of di High Prist savant, wey stand near am slap am for face kon ask am, "Na di High Prist yu dey tok to laik dis?"

23 Den Jisos sey, "If wetin I tok nor koret, mak yu tel mi, bot if e koret, why yu slap mi?"

24 Den Annas kon send am as dem stil tie am wit rope, go mit Kaifas, wey bi di High Prist.

25 As Saimon Pita stand for insaid di kompoun dey warm ensef, dem kon ask am, "Yu tu nor bi won of en disaipol?" Pita denai sey, "I nor dey among dem."

26 Won High Prist savant, wey bi di same famili wit di man wey Pita tak sword kut en ear kon sey, "I nor si yu wit am for insaid di farm?"

27 Pita denai again for dia front and fawo kon du "Kukuruku."

28 Den, dem tak Jisos komot from Kaifas place go di Roman Govnor palise. (By dis taim, mornin don rish). Dem nor gri enta insaid di govnor haus, mak dem nor for dirti as dia tradishon tok, so dat dem go fit chop di Passova fud.

29 So Pilate kom mit dem for outsaid kon ask dem, "Wetin una sey dis man du?"

30 Dem ansa, "If to sey dis man nor bi krimina, wi nor for bring am kom mit yu."

31 Den Pilate tel dem, "Mak una go joj am as una law tok." Di Ju Oga dem kon sey, "Awa law nor giv us pawa to kil enibodi."

32 (Dis tin hapun to show sey wetin Jisos tok abaut haw e go die, na tru).

33 So Pilate go insaid en haus for di palise, kon kol Jisos ask am, "Na yu bi di Ju pipol king?"

34 Jisos ansa am, "Na from yor maind yu ask dis kweshon, abi pipol don tel yu abaut mi?"

35 Pilate ansa am, "Yu no sey I nor bi Ju, abi? Na yor pipol and prist oga dem bring yu kom mit mi. Wetin yu du sef?"

36 Jisos ansa, "My kindom nor dey dis wold. If to sey my kindom dey dis wold, my savants for fite mak I nor for kom mit di Ju oga dem. Bot as e bi so, my kindom nor dey here."

37 Den Pilate ask am, "So yu bi king?" Jisos ansa, "Na yu tok so and yu dey koret sey, I bi king." Na dis mak dem born mi and naim mak mi kom dis wold kon tok di trut. Enibodi wey wont hear di trut, go listin to wetin I dey tok."

38 Pilate stil ask am, "Wetin bi di trut?" Den e go outsaid again go mit di Ju oga dem kon tel dem, "I nor si eni bad tin wey dis man du o-o.

39 "Bot as una kustom sey mak I fri won prizina for una for Passova, una wont mak I fri Jisos, wey bi di Ju king?"

Open Bible reader