Nigerian Pidgin Bible
John 13
1 Bifor dem du di Passova Fist, Jisos no sey en taim don rish wen e go komot for dis wold go mit en Papa. Bikos e luv di pipol wey dey di wold, e kon show dem haw en luv for dem strong rish.
2 Bifor dem start to chop evenin fud, devol don alredi enta Judas Iskarot maind, wey bi Saimon pikin, sey, mak e sel Jisos giv en enemi.
3 Bikos Jisos no sey en Papa don gi-am pawa to kontrol evritin and as e bi sey e kom from God and e dey go bak go mit am,
4 e kon stand-up for wer dem dey chop, rimov en big koat kon tie towel for en waist.
5 E kon pour wota for basin, bigin dey wosh en disaipols leg and dey dry dem wit di towel wey dey en waist.
6 Wen e rish Saimon Pita turn, Pita kon tel am, "Oga, yu won wosh my leg?"
7 Jisos ansa, "Yu nor go fit undastand wetin I dey du naw, bot yu go undastand am leta."
8 Pita kon tel am, "I nor go gri mak yu wosh my leg!" Den Jisos ansa, "If I nor wosh yor leg, mi and yu nor go get enitin togeda again."
9 So Saimon Pita tel am, "Oga, mak yu nor wosh onli my leg, bot mak yu wosh my hand and head tu!"
10 Jisos ansa, "Di pesin wey don baff, onli nid to wosh en leg, bikos e don dey klin. Una dey klin, bot nor bi all of una."
11 (Bikos Jisos no di pesin wey go sel am, naim mak am sey, "Nor bi all of una dey klin.")
12 So wen Jisos don wosh dia leg finish, e kon wear en big koat bak. Den e go sidan for di tabol kon ask dem, "Una undastand wetin I du for una so?
13 "Una dey kol mi 'Tisha' and 'Oga', una koret, bikos na so I bi.
14 "So, if mi, wey bi una oga and tisha, wosh una leg, e gud mak una wosh ish oda leg tu.
15 "I don giv una ezampol wey una go folo. So mak una du for ish oda as I don du for una."
16 "Mak I tel una tru wod, savant nor dey big pas en oga, jos as di pesin wey bi mesenga nor dey big pas di oga wey send am.
17 "Since una no wetin I dey tok, God go bless una, if una du dem."
18 "Wetin I dey tok so nor konsan all of una, bikos I no di pipol wey I shuz. Dis show sey God wod na tru, sey, 'Di pesin wey folo mi chop don turn to my enemi.'
19 "I don tel una bifor e go hapun, so dat wen e hapun, una go biliv sey na mi bi Kraist.
20 "I dey tel una tru wod, enibodi wey risiv di pesin wey I send, don risiv mi and enibodi wey risiv mi, don risiv God wey send mi kom."
21 Wen e don tok dis tin finish, en heart kon heavi wel-wel, den e sey, "I dey tel una tru wod, won of una go sel mi giv my enemi."
22 Di disaipols luk ish oda kon dey wori and tink for dia maind sey, "Wish pesin e dey tok abaut?"
23 Jon, di disaipol wey Jisos luv wel-wel, sidan for en rite hand wen dem dey chop.
24 So, Saimon Pita kon yuz eye tel am sey mak e ask Jisos wish pesin e dey tok abaut.
25 Den Jon bend en head near Jisos chest kon ask am, "Oga, hu yu dey tok abaut?"
26 Jisos ansa, "Na di pesin wey I go giv dis bread afta I don shuk-am insaid di pot." Den e shuk di bread insaid di pot kon gi-am to Judas Iskarot, wey bi Saimon pikin.
27 Afta Judas tak di bread, devol enta en maind. Jisos kon tel am, "Di tin wey yu won du, mak yu go du-am kwik-kwik."
28 (None of dem wey sidan for di tabol undastand why Jisos tok to Judas laik dat.
29 Som of dem tink sey, since na Judas dey kip di moni, Jisos tel am sey mak e go buy wetin dem go yuz for di fist or mak e giv poor pipol moni).
30 Wen Judas don tak di bread, e huri komot for di place. (By dis taim, day don dak.)
31 Wen e don komot, Jisos kon sey, "Naw, di taim don rish wen God go onor en pikin and en pikin go onor am tu.
32 "Wen di pikin don onor God, God sef go onor am bak.
33 "My shildren, na smol taim rimain wey I go dey wit una. Leta, una go dey faind mi and as I tel di Ju oga dem bifor sey, 'Wer I dey go una nor go fit kom der', na di same wod I dey tel una naw.
34 "I dey giv una new komand: Una must luv ish oda, as I luv una,
35 so dat evribodi go no sey una bi my disaipols, if una luv ish oda."
36 Saimon Pita kon tel am, "Oga, wer yu dey go?" Jisos ansa, "Una nor go fit folo mi go di place wey I dey go naw, bot una go kom mit mi for der leta."
37 Pita ask am, "Oga, why wi nor go fit folo yu naw? I redi to die bikos of yu!"
38 Jisos ansa am, "Yu rili redi to die for mi? Mak I tel yu tru wod, bifor fawo go du 'Kukuruku' dis nite, yu go tok tiri taims sey, yu no mi."