Nigerian Pidgin Bible
Hebrews 11
1 Fate na wen wi dey sure sey wetin wi dey hope for go hapun and wi sure sey, di tins wey wi neva si, go kom.
2 Na fate awa gran-gran papa dem tak du tins wey mak God praiz dem.
3 Na tru fate wi tak undastand sey, God kreate evritin wit en wod. So di tins wey wi dey si so, na God mak dem from wetin dem nor dey si.
4 Na fate mak Abel giv God sakrifais wey beta pas Kain own and na tru dis fate Abel tak no sey God asept en ofrin, bikos God rili asept am. Ivun doh Abel don die, en blood stil dey tok for am, bikos of en fate.
5 Na fate nor let Enok die, bot God kari am tak and nobodi si-am. God wod sey, bifor God kari am, Enok don mak bele swit God.
6 Nobodi fit mak bele swit God witout fate, bikos enibodi wey dey kom mit am, must biliv sey, E dey alaif and E dey riwod pipol wey dey faind am si.
7 Na fate mak Noah build ark afta God warn am abaut wetin go hapun. E obey wetin God tok and na di ark save en and en famili. Na di same fate Noah tak kondem di wold, kon inherit di raitiousnes wey dey kom.
8 Na fate mak Abraham obey, wen God kol am mak e liv en haus, travol go anoda land wey God promis am, ivun doh e nor no wer e dey go.
9 Na fate mak am stay as stranja for di land wey God promis am. Na insaid canopi en, Izik and Jacob wey go inherit di same promis, stay.
10 Abraham du laik dis, bikos e dey wait for di tawn wey God ensef go build, wit strong foundashon.
11 Na fate mak Abraham born, ivun doh Sarah don tu old to get bele and Abraham don old tu, bot e no sey di Pesin wey promis am pikin, na Pesin wey e fit trust.
12 So from dis won man wey en bodi don die finish, shildren wey plenti rish stars for skai and sand for wotasaid kon ful evriwer.
13 All of dem fate stil strong wen dem die and dem nor get di tins wey God promis dem, bot dem si and welkom di tins from far and dem gri sey, dem diasef na strenja for dis wold.
14 Pipol wey tok laik dis, show evribodi sey dem dey espet dia own kontri.
15 Infact, if to-sey dem dey tink of di kontri wer dem from kom, dem for get maind to go bak.
16 Bot as tins bi so, dem dey espet kontri wey beta pas dia own and e dey kom from hevun. Naim mak God nor shame wen dem dey kol am dia God, bikos E don build big tawn for dem.
17 Na fate mak Abraham offa Izik wen God dey test am. Ivun doh na God gi-am di pikin, e stil redi to giv di onli pikin wey e get, bak to God.
18 God tel am bifor sey, "Tru Izik, yor famili go meni wel-wel."
19 Dis na bikos Abraham biliv sey, ivun if Izik die, God go raiz-am from deat and tru-tru Abraham rili kolet Izik bak from deat.
20 Na fate mak Izik bless Jacob and Esau abaut dia future.
21 Bifor Jacob die, na fate e tak bless Josef shildren and woship God as e res on-top en wokin stick.
22 Wen Josef life don dey end, na fate e tak tok abaut di long travol wey Izrel pipol go-go and e tel dem wetin dem go du wit en bones.
23 Na fate mak Mosis papa and mama hide am wen dem born am, bikos dem si sey di pikin fine and dem nor fear to disobey wetin di king komand.
24 Wen Mosis kon grow up, na fate mak am nor gri mak dem kol am Fero dota pikin.
25 Insted of am to enjoy tins wey go mak am sin, e kon shuz to sofa wit God shildren.
26 E feel sey e beta mak dem laff am, bikos of di Mezaya wey dey kom, insted of mak e dey enjoy di fain-fain tins for Egypt. E du laik dis, bikos e put en eye for God riwod.
27 Na di same fate mak Mosis komot from Egypt and e nor fear di king vesnashon, bikos e get hope for God wey ordinari eye nor fit si.
28 Na fate mak Mosis du di Passova and pour blood for pipol door-mot, so dat God angel wey dey kil all di first born for Egypt, nor go tosh dem.
29 Na fate mak Izrel pipol kros di Red Sea laik sey na dry land, bot wen Egypt pipol trai am, di wota swalow all of dem.
30 Na fate mak Jeriko wall fal afta Izrel pipol don mash roun am for sevun days.
31 Na fate mak Rahab, wey bi ashawo, eskape wen God distroi pipol wey nor obey am, bikos e welkom di pipol wey kom spy.
32 Wetin I go tok again? I nor get taim to tok abaut Gideon, Barak, Samson and di profets,
33 na fate dem tak win kindoms; du wetin gud for God eye; kon get di tins wey God promis dem; klose lion mout;
34 kwensh fire wey dey burn wel-wel and eskape wen dem won kil dem wit sword. God turn dia wiknes to pawa. Dem strong wel-wel for war front and sojas from oda kontris, dey run from dem.
35 Som wimen wey dia pipol don die, na fate mak dem risiv dem bak, alaif. Som pipol rejet fridom kon die for sofa, so dat dem go fit wak-up from deat and enta life wey beta pas dis won.
36 Pipol laff som; flog som; chain som and put odas for prizin.
37 Dem stone som; yuz saw kut som into tu; tak sword kil som; som dey hide waka insaid goat and ship skin wey dem wear and dem nor get enitin; dem sofa som and trit odas enihaw.
38 (Dis wold nor gud rish for dem); dem jos dey waka abaut for desert, on-top mountins, insaid rock and holes.
39 God praiz all of dem for dia fate, yet dem nor stil get wetin God promis.
40 Bikos God plan sey, witout us, dem nor go fit get di tins wey E promis dem.