Nigerian Pidgin Bible
Genesis 1
1 For beginning wey God create heaven and earth,
2 earth no get shape and e dey empty. Darkness come cover water and the Spirit of God con dey move on top the face of water.
3 God con say make light show, light con show.
4 God con see say light dey good. He come seperate light from darkness.
5 He call light day, and darkness night. Evening con pass and morning come na hin make am the first day.
6 God con say make space dey between the water wey dey for heaven and the water wey dey for earth. Naso e take happen,
7 the space come seperate the water wey dey for earth from the water wey dey for heaven.
8 God con call space sky. Evening come pass, morning come na hin make am the second day.
9 God con say make the water wey dey under sky gather together for one place so that dry ground go show and naso e take happen.
10 God con call the dry ground land, and He call the water sea. God see say e dey good.
11 God con say plant wey dey get seed and tree wey dey get fruit wey get seed inside make dem comot from ground and their seed go dey produce the kind fruit and plant wey dem comot from.
12 Naso e take happen plant wey dey get seed and tree wey dey get fruit wey get seed inside, dem comot from ground and their seed dey produce plant and tree wey be like their own. God see say e dey good.
13 Evening pass and morning come, na hin make am the third day.
14 God con say make light appear for sky make e seperate day from night make the light be sign to dey mark season, day, and year.
15 Make the light wey dey for heaven shine on top earth. And as e take happen,
16 God con make two big light, the bigger one dey control day and the smaller one dey control night. He come make stars too.
17 God come set this lights for sky make dem dey shine light on top earth,
18 make them dey control day and night, make dem seperate light from darkness and God see say e dey good.
19 Evening pass and morning come, na hin make am the forth day.
20 God come say make water dey full of fish and life wey dey swim and make sky dey full of different kain bird.
21 Naso God create big fish and every other things wey dey live inside water and different kain birds each of them dey produce pikin wey be like them. God come see say e dey good.
22 He come bless them, He say make them dey multiply. Make fish full inside sea and make birds dey multiply on top earth.
23 Evening come pass and morning come. Na hin make am the fifth day.
24 God con say make earth produce different kind of animal, make each of them dey produce pikin wey be like them. Animal wey dey for house, small animal wey dey crawl for ground, and terrible animals wey dey inside bush. Naso e take happen.
25 God make different kind of animal each of them dey produce pikin wey be like them. And God see say e dey good.
26 God come say make we make human being make dem be like us. Dem go dey control fish wey dey inside sea, birds wey dey for sky, and animals wey dey for house and even terrible animals wey dey on top earth and small animals wey dey crawl for ground.
27 Naso God create human being for him own image. Na for him image him create them, man and woman.
28 God come bless them. He say make them dey born pikin make them dey multiply, make dem full earth make dem dey control am. make dem control fishes wey dey inside sea, make dem control birds wey dey for sky, and make dem dey control animals wey dey crawl for ground.
29 God come say I don give you every plant wey get seed and every tree wey get fruits make you dey chop am.
30 I don give every green plant as food to all animal make dem dey chop am. Naso e take happen.
31 God come look everything wey him don make and He see say dem dey good. +Evening come pass, morning come, na hin make am the sixth day.