Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Acts 3

1 Won day, Pita and Jon dey go di Tempol go pray for tiri o' klok for aftanun.

2 Som pipol dey always kari won man, wey nor fit waka since en mama born am, kom di Tempol domot wey dem dey kol, "Beautiful Gate", so dat e go dey beg for moni from pipol, wey dey enta insaid di Tempol.

3 As di man si Pita and Jon wen dem won enta di Tempol, e kon dey beg dem for moni,

4 bot dem luk am strate for eye kon sey, "Mak yu luk us!"

5 So di man wey nor fit waka kon luk dem wel-wel, bikos e tink sey dem won gi-am moni.

6 Pita kon tel am, "I nor get silva or gold to giv yu: bot na wetin I get, I go giv yu. Wit Jisos Kraist name wey kom from Nazaret, stand-up mak yu bigin waka!"

7 Pita hol di man for en rite hand kon drag-am up and at wons, di man legs kon strong.

8 Di man jump up kon bigin waka, e folo dem enta di Tempol dey waka, dey jump up and dan, dey praiz God.

9 Pipol si-am dey waka dey praiz God

10 and dem rimemba en face kon sey, dis na di man wey dey sidan for di Tempol domot dey beg moni, bifor. Di pipol sopraiz wel-wel, bikos of wetin hapun.

11 Di man stil dey jump folo Pita and Jon wit hapines and di pipol stil dey sopraiz. Den di pipol run go mit Pita and Jon for di place wey dem dey kol "Solomon Porsh".

12 Wen Pita si sey all di pipol gada, e kon start to dey prish, "Izrel pipol, wetin mak dis mirakol dey sopraiz una laik dis? Why una dey luk us laik sey na wit awa own pawa or holines wi tak mak dis man waka?

13 "Na Abraham, Izik, Jakop and awa gran-gran papa dem God, naim kari en savant Jisos Kraist go up, di won wey una rejet kon gi-am to Pilate mak e joj am, ivun wen e won fri am.

14 "Una sey una nor wont Jisos Kraist, di Holi and Raitious Pesin, insted una sey mak dem riliz anoda pesin wey dey kil pipol giv una.

15 "Una kil di pesin wey dey giv pipol life, bot God raiz-am from deat and wi bear witnes sey dis na tru.

16 "Dat Jisos Kraist name wey wi biliv, naim mak dis man wey una dey si and no wel-wel, strong. Yes! Naim name don heal dis man as una dey si so.

17 "So my brodas, I no sey una and una oga dem nor no wetin una du.

18 "God don tok bifor-bifor tru all en profet sey, di Mezaya go sofa and E don mak am hapun, tru wetin una du.

19 "So mak una turn from sin kom mit God, mak E for forgiv una,

20 so dat una go fit get fridom wey God dey giv and E go send Jisos Kraist, di Mezaya wey E don priper dan, kom mit una.

21 "Dis Jisos Kraist go stay for hevun til di taim wey God go mak evritin beta again as E don tok tru en holi profets.

22 "Ivun Mosis sef tok bifor sey, "Jehova wey bi una God go send won profet to una, jos as E send mi and e go bi una famili memba. Una must obey evritin wey e sey mak una du.

23 "Enibodi wey nor obey dat profet, dem go distroi am and dem go rimov am from God famili.

24 "God don tok abaut all dis tins wey dey hapun so, from Profet Samuel taim go rish di profets wey kom afta am.

25 "All of una get share for insaid di promis wey God mak wit una gran-gran papa dem tru di profets. Na so E tel Abraham sey, 'Na tru di pikin wey yu go born, naim I go tak bless all di famili wey dey di wold.'

26 "So God don raiz en savant and E don send am giv una, mak e for bless and help una turn from sin kom mit am."

Open Bible reader