Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Acts 17

1 Afta dem pas Amfipolis and Apollonia, dem kon rish Tesalonika wer won Ju sinagog dey.

2 Pol go mit di Ju pipol for di sinagog as e dey du bifor and for tiri Sabat Day, e kon dey tish dem God wod,

3 dey show dem haw God wod sey Kraist must sofa and e go raiz from grave. E tel dem, "Dis Jisos Kraist wey I dey tel una abaut so, naim bi di Kraist."

4 Som of dem wey biliv kon join Pol and Silas and meni Greek pipol wey dey fear God and som big-big wimen, join dem tu.

5 Bot di Ju pipol kon dey jelos, naim dem gada aria boys wey dey waka abaut for market, tak form gang to skata di tawn. Dem atak Jason haus, bikos dem tink sey Pol and Silas dey der, so dat dem go bring dem out kon tak dem go di tawn hall.

6 Wen dem nor si dem, dem kon drag Jason and som of en brodas go mit di tawn oga, dey shaut, "All dis pipol wey don start wahala for di wold, don rish here tu

7 and Jason put dem for en haus laik visitor! Dem dey du wetin dey against Caesar law, dey tok sey anoda king dey wey en name bi Jisos Kraist!"

8 Dem kause konfushon among di pipol wey gada and di tawn oga dem wey hear all dis tins.

9 Afta di oga dem don kolet moni from Jason and di brodas, dem kon alow dem go.

10 At wons, di brodas send Pol and Silas go Berea for nite. Wen dem don rish der, dem kon go di Ju sinagog.

11 Dis Ju pipol get beta maind pas di wons wey dey for Tesalonika, bikos dem opun maind tak biliv di mesage and dem dey read God wod evriday to shek weda all di tins wey dem hear, na tru.

12 Na so meni of dem tak biliv, ivun wit som big-big men and wimen wey bi Greek.

13 Bot wen di Ju pipol wey dey for Tesalonika hear sey Pol don rish Berea dey prish God wod, dem kon go der go kause wahala and spoil di pipol maind.

14 Naim di brodas send Pol go di wotasaid, bot Silas and Timoti stil stay for Berea.

15 Di pipol wey folo Pol, eskot am go rish Atens and afta, e orda dem sey mak Silas and Timoti kom mit am kwik-kwik for der, so dem kon go bak.

16 As Pol dey Atens dey wait for dem, e kon dey ves for en spirit, bikos e si sey na so-so juju ful di tawn.

17 So e tok to di Ju and Gentai pipol wey dey fear God wey dey insaid di sinagog and e stil tok to evribodi wey dey di market.

18 Na so som wise men wey dey folo Epikorian and di wons wey bi Stoik dey folo am tok and som dey ask ish oda, "Wetin dis mumu and toku-toku tink sey e no wey e won tel us?" som stil sey, "E bi laik sey e dey prish abaut som gods from anoda tribe." (Dem tok so, bikos e dey prish di Gud News abaut Jisos Kraist and en resureshon.)

19 So dem tak Pol go Areopagus kon tel am, "Wi beg, mak yu tel us abaut dis new tin wey yu dey tish so?

20 "Bikos di tins wey yu dey tok, wi neva hear am bifor and wi laik to no wetin dem min."

21 (Atens pipol and odas wey dey der, nor get eni oda wok pas mak dem sidan dey tok stori abaut eni new tin wey dey hapun.)

22 So Pol stand for Areopagus front kon sey, "My pipol wey dey for Atens, I si sey una laik God mata wel-wel.

23 "Bikos as I waka roun dey luk all di tins wey una dey woship, I ivun si won shrine wey dem rite put sey: 'To di god wey pipol nor no.' So wetin una dey woship wey una nor no, naim I kon tel una abaut today.

24 "God wey mak di wold and evritin wey dey insaid, wey bi di Oga for hevun and eart, nor dey stay insaid haus wey humanbin build

25 and E nor wont mak humanbin gi-am somtin laik sey E nid enitin, bikos naim dey giv life and air wey wi dey breat.

26 "Na tru won man E mak all di tribes wey dey for di wold and E tok di taim and boundari wer dem go stay rish,

27 so dat dem go luk for God kon si-am, ivun doh E nor dey far from all of us.

28 "Bikos na insaid am wi dey liv, waka, get life and som of una wey dey rite poem tok sey, 'Wi tu na God pikin.'

29 "So, as e bi sey wi bi God pikin, mak wi nor tink sey God bi laik image wey humanbin yuz gold, siliva or stone tak mak.

30 "God don forgiv us for di taim wen wi nor no wetin wi dey du, bot naw, E dey komand pipol for evriwer sey mak dem turn from sin kom mit am,

31 bikos E don shuz won day wey E go tak joj di wold wit raitiousnes tru di man wey E shuz and show evribodi wen E raiz-am from deat."

32 Wen di pipol hear sey pipol go raiz from deat, som kon dey laff, bot odas kon sey, "Wi go hear dis mata from yu anoda day."

33 So Pol kon komot from Areopagus.

34 Bot som pipol wey biliv Kraist kon join am. Insaid dis pipol wey biliv so, na Dionysius wey bi memba for Areopagus and won wuman wey dem dey kol Damaris, wit oda pipol wey join dem.

Open Bible reader