Nigerian Pidgin Bible
Zechariah 9
1 Na the message of God against land of Hadrach and city of Damascus be this. Tribes of Israel no be the only people wey know about God. Everybody dey look to him for help.
2 This message also dey against city of Hamath wey dey near Damascus. And this message also dey against Tyre and Sidon even though dem wise and dem get skill.
3 Tyre don build war army for herself. People wey dey there don collect silver wey plenty like dust and gold wey plenty like common clay.
4 But God go take everything wey dem get. He go destroy their powerful army and use fire destroy the city!
5 The city of Ashkelon go see this and dem go fear. The city of Gaza go shake with fear, and people of Ekron go lose their hope when dem see wetin happen. Gaza no go get king again. Nobody go dey live for Ashkelon again.
6 The people of Ashdod no go even know who their real fathers be. God talk say, I go fully destroy Philistines wey dey proud.
7 Dem no go eat meat wey get blood or any other food wey dem no suppose eat again. Any Philistine wey remain alive go become part of my people; dem go just be one more tribe for Judah. People of Ekron go become part of my people, as Jebusites don do.
8 I go protect my country. I no go allow army pass through am. I no go allow them hurt my people again. I don see how my people don suffer with my own eyes.
9 People of Zion, make una rejoice! People of Jerusalem, make una shout for joy! Look, una king dey come to una! Him na good king wey win victory, but he dey humble. He dey ride on top donkey, on top young donkey wey work animal born.
10 I go remove war chariots commot for Zion and take horse soldiers commot for Jerusalem; I go destroy the bows wey dem dey use for war. Una king go bring peace among nation. He go rule from sea to sea, from Euphrates River take reach end of the earth.
11 Jerusalem, because of the agreement wey I get with una through my blood, I go set una people free free commot from pit wey no get water for foreign land.
12 Return, you prisoners wey don get hope; make una return to una place of safety. I dey tell una, I go repay una double blessing for all una don suffer.
13 I go use Judah like soldier bow and use Israel like arrows. I go use men of Zion like sword, take fight men of Greece.
14 God go show on top of him people; he go shoot him arrow like lightning. The Almighty God go sound the trumpet; and go march inside storm from south.
15 Almighty God go protect him people, and dem go destroy their enemy. Dem go shout for battle like men wey don dey drunk and dem go shed the blood of their enemies; e go flow like blood of sacrifice wey dem pour from bowls on top alter.
16 God go safe him people when that day come, like shepherd dey save him flock from danger. Dem go shine for him hand like jewel of crown.
17 Everything go dey good and beautiful! Wonderful crops go dey, but e no go be food and wine only. E go be all young men and women!