Nigerian Pidgin Bible
Romans 7
1 My brodas and sistas, I no sey I dey tok to pipol wey no di law. Na onli wen pesin stil dey for life, naim di law dey get pawa for en bodi.
2 As di law tok, wuman wey don mari dey unda en husban as long as di man dey alaif. Bot if di man die, di wuman don fri.
3 So if wuman mari anoda man wen en husban stil dey alaif, e min sey e don komit adultri. Bot if en husban die, e don fri from wetin di law tok and e go fit mari anoda man again.
4 So my brodas and sistas, na so e bi wit una tu. Una don bikom part for Jisos Kraist bodi and una don die to di law pawa. Naw, una dey fri to bi Kraist own; di pesin wey God raiz from deat mak una for dey serv am.
5 Wen wi stil dey di wold, di law dey mak us du bad tins wey awa bodi wont and all dis tins dey bring deat.
6 Bot naw, wi don fri from di law. Wi bi laik deat bodi and di law nor get pawa for awa bodi again. Naw wi sopoz to serv God wit di new life wey di Spirit dey giv, nor bi di old life, wey bi to obey di law wey pesin rite.
7 Dis min sey di law nor gud? No! Bot na di law mak mi no wetin sin bi. If to sey di law nor sey, "Nor get long-trot for anoda man tin," I nor for no sey I nor sopoz to du dat kaind tin.
8 Bot bikos of di law, di sin pawa wey dey insaid mi kon dey mak mi tink abaut tins wey nor gud and if law nor dey, sin nor for get pawa for my life.
9 Bifor I no di law, I dey alaif, bot wen I hear God komandment, sin jos enta my life
10 and I kon die. So di law wey sopoz giv mi life, don kil mi!
11 Since sin pawa yuz di law disiv mi, I kon die.
12 Bot di law dey holi, rite and gud.
13 So dis min sey na wetin gud kil mi? No! Bot na sin pawa wey dey insaid mi, na-im kil mi; bikos e yuz wetin gud bring deat and naw, wi dey si haw sin bad and wiked rish.
14 Wi no sey di law dey spiritual. Bot I bi humanbin and dem don sel mi giv sin.
15 I nor undastand wetin I dey du; bikos I nor dey du wetin I won rili du. Insted na wetin I nor laik, I dey du.
16 Since I dey du wetin I hate to du, e show sey di law dey koret.
17 Nor bi mi rili dey du wetin I dey du, bot na di sin pawa wey dey insaid mi.
18 I no sey wetin dey insaid mi nor go let mi du gud. Ivun wen I won du gud, I nor dey fit.
19 Insted of mak I du wetin dey gud, na bad tins I dey du.
20 So if I du wetin I nor won du, e show sey nor bi mi dey du-am again, bot na di sin pawa wey dey insaid mi.
21 So I si sey dis law dey wok, bikos wen I won du gud, na onli bad tins dey enta my maind.
22 I dey laik to obey God law wit my hol maind,
23 bot insaid mi, I kon undastand sey somtin dey fite against my maind and e dey mak mi bi sin savant, bikos e dey kontrol my bodi.
24 I nor dey hapi at-all! Hu go save mi from dis bodi wey dey push mi go die?
25 Tank God! Jisos Kraist don save mi. So, I go obey God law wit my maind, ivun doh sin pawa stil dey insaid mi.