Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Romans 2

1 Pesin wey dey joj odas nor get eskuze for wetin e dey du and e nor mata hu e bi. Bikos wen yu joj odas and yu dey du di same tin wey dem dey du, yu dey kondem yorsef.

2 Wi no sey God nor dey lai wen E dey joj pipol wey dey du bad tins.

3 Yu wey dey du tins wey yu sey mak odas nor du! Yu tink sey yu go eskape God jojment?.

4 May bi una dey tak God kindnes, patient and endurance as yeye tins. Una nor no sey God dey kaind, bikos E wont mak una turn from sin kom mit am?

5 Bot una stubornes and strong heart nor let una turn from sin kom mit God, so una dey mak una ponishment meni more-more, for di Day wen God go joj di wold, bikos en na joj wey nor dey sopot bad tins.

6 God go pay evri man akordin to wetin e du.

7 God go giv life wey nor dey end to di pipol wey dey du gud, wey wont glori, onor and long life.

8 Bot E go show en vesnashon and ponish doz wey bikos of long-trot rejet di trut kon dey du bad tins.

9 Enibodi wey dey du bad tin, weda e bi Ju or Gentai, must sofa and risiv ponishment.

10 Bot God go giv glori, onor and peace to enibodi wey dey du gud, weda e bi Ju or Gentai,

11 bikos God go joj evribodi di same way.

12 Ivun doh Gentai pipol nor get Mosis law, God stil dey ponish dem wen dem sin, so Ju pipol wey get di law, wen dem sin, na di law go joj dem.

13 Bikos yu dey hear di law nor min sey yu gud for God eye, bot na wen yu du wetin di law tok.

14 Gentai pipol nor get di law, bot dem dey yuz dia sense du wetin di law tok and dat won don turn law for dem, ivun doh dem nor no Mosis law.

15 Di way dem dey bihav show sey wetin Mosis rite for di law, dey dia heart and dia maind dey tel dem sey, "Dis tins dey rite and e go kondem or fri us from wetin wi du."

16 So jos as I prish giv una, na so e go bi for dat day, wen God go joj all di sikrit tins wey dey pipol heart tru Jisos Kraist wey bi en pikin.

17 Wot of yu wey sey yu bi Ju? Yu wey put yor hope for di law kon dey yuz God dey boast;

18 yu no wetin God wont mak yu du and yu don learn haw to du gud tins, bikos yu no di law.

19 Yu dey show blind pipol road and dey help doz wey dey for daknes si lite,

20 and yu dey tish foolish pipol and smol shildren wey nor no enitin, bikos yu no sey, di trut and evritin wey man nid to no, dey for di law.

21 Why e bi sey yu wey dey tish odas nor fit tish yorsef? Yu wey dey prish sey mak pipol nor tif, yu sure sey yu nor dey tif?

22 Yu wey sey mak pipol nor komit adultri, yu nor dey komit adultri? Yu wey sey yu hate juju, yu nor dey tak tins wey dem kip for juju haus?

23 Yu wey dey tak di law boast, yu dey bring shame to God name, bikos yu dey disobey di law!

24 Jos as God wod sey, "Bikos of una wey bi Ju pipol, Gentai pipol kon dey tak God name mak yeye."

25 Sekonsishon get value onli if yu dey du wetin di law tok, bot if yu nor dey obey di law, yu and di pesin wey dem neva sekonsaiz na di same.

26 So if Gentai pipol wey dem nor sekonsaiz dey obey evritin for di law, yu nor tink sey God go tak dem as pipol wey dem sekonsaiz?

27 Yu nor no sey di pesin wey dem nor sekonsaiz go joj yu wey bi Ju, since yu dey break di law?

28 Pesin nor bi Ju bikos of wetin pipol si from outsaid. Di ril sekonsishon nor bi wetin pipol dey si,

29 bot di ril Ju na pesin wey bi Ju for insaid en heart, bikos sekonsishon nor dey tosh pesin heart. Na di Holi Spirit dey du dis kaind wok, nor bi di law wey dem rite dan and dat pesin go dey risiv praiz from God, ivun doh humanbin nor praiz am.

Open Bible reader