Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Philippians 3

1 Finali, my brodas and sistas, mak una hapi bikos una get Kraist. I dey rite di same tin giv una again, bikos e go help una.

2 Mak una shine una eye, bikos of doz wey dey bihav laik dogs and wiked pipol wey dey ponish dia bodi!

3 Na wi bi di ril sekonsishon; di pipol wey dey woship God tru en Spirit; pipol wey dey hapi insaid Kraist and wi nor dey put awa hope for wetin pipol dey du.

4 Aldoh my own rizin important tu. If enibodi tink sey e get beta rizin to put hope for wetin humanbin dey du, mi Pol, get pas dem.

5 Dem sekonsaiz mi, ate days afta dem born mi. I kom from Izrel, Benjamin tribe and I bi Hebrew man. I bin dey liv akordin to di law, bikos I bi Farisi.

6 Bikos I rili won du God wok, I kon dey kause serious wahala for di pipol wey dey di shosh. I du evritin jos as di law sey mak wi du, so dat wi go dey gud for God eye. So, I nor get eni fault.

7 Bot all dis tins wey I si as gain, I kon kount dem to bi nor-tin, bikos of Kraist.

8 Nor bi onli doz wons, bot naw, I dey luk evritin as nor-tin, wen I kompare am wit Kraist, my Oga wey I no and I trowey evritin, bikos of am. Tru-tru, I dey luk all doz tins as yeye, so dat I go fit gain Kraist,

9 kon bi won wit am. My raitiousnes nor kom from di law, bot I dey raitious tru my fate for Kraist. Bikos na tru fate God tak mak us dey raitious wit am.

10 Wetin I wont na to no am and di pawa wey wak Kraist from deat; to sofa wetin e sofa; to bi as e bi wen e die,

11 so dat mi tu go stil wak-up from deat, as e wak.

12 Nor bi sey I don get evritin wey I wont or God don mak mi pafet, bot I dey trai mak I get di prize kon hol am as Jisos Kraist hol mi.

13 My brodas and sistas, I nor luk mysef laik sey I don get evritin wey I wont. Bikos I dey tink of onli won tin wey bi: to forget di tins wey don pas kon dey porshu di wons wey dey front

14 and as I put my maind for dis tins, I dey trai to get di prize wey bi life for hevun; prize wey mak God kol us tru en pikin, Jisos Kraist.

15 So doz of us wey don mature for Kraist, mak wi get dis kaind maind. Bot if una dey tink difren tins, I biliv sey God go show una di trut.

16 So, mak wi kontinu to folo di rules wey wi dey folo.

17 My brodas and sistas, mak una dey liv laik mi and dey learn from odas wey dey folo us as ezampol.

18 Bikos l don tel una bifor and I dey tok am again wit tears for my eye sey, di way meni pipol dey bihav, dey show sey dem bi enimis to Kraist kros.

19 Dem go end for hell; na dia bele bi di god wey dem dey serv. Tins wey sopoz mak dem shame, naim dey mak dem hapi and na onli tins for dis wold dem dey tink abaut.

20 Bot wi bilong to hevun and wi dey wait awa Savior wey kom from der, wey bi Oga Jisos Kraist.

21 E go yuz en pawa wey mak am Oga for evritin, tak shange dis awa ordinari bodi and awa bodi go kon bi laik en own wey get glori.

Open Bible reader