Nigerian Pidgin Bible
Philippians 2
1 Gain dey to serv Kraist? Komfort dey for en luv? Feloship dey bitwin pipol and God Spirit? Una heart gud rish to show pipol mesi?
2 Den, mak una let my joy dey komplit, as una dey agri wit ish oda and dey luv and wok togeda wit won maind.
3 Mak una nor dey kari bodi up, bot mak una trit ish oda laik unasef. Insted, una dey du wetin una laik, bikos of di tins wey una go gain, so dat una go fit boast.
4 Mak una nor dey tink abaut unsef alone and wetin una wont, bot mak una dey tink abaut wetin gud for odas tu.
5 Mak una get di same maind wey Kraist get,
6 wey bi sey, ivun doh en wit God na di same, e nor boast abaut am.
7 Bot e liv evritin wey e get for hevun kon bi laik savant. So e kom dis wold as humanbin.
8 E put en bodi dan kon obey God, ontil Ju pipol kil and nail am for kros!
9 Bikos of dis, God raiz-am up kon gi-am di name wey big pas evri oda name,
10 so dat wen dem kol Jisos name, evribodi and evritin must nil dan, weda dem dey hevun, eart or for unda di eart
11 and evri tongue go konfes sey, "Na Jisos Kraist bi di Oga." Den all di glori go bi God own.
12 So, my frends wey I luv; pipol wey dey always obey mi, (nor bi onli wen I dey wit una, bot una dey obey wel-wel, ivun wen I nor dey wit una). Mak una kontinu to du God wok wit all una heart, so dat una salvashon go ful wel-wel,
13 bikos na God dey wok insaid una, so dat una go fit du gud tins and get di pawa wey go mak una hapi.
14 Mak una nor yuz vesnashon tak wok for God,
15 so dat una nor go get eni blame and una go dey klin. God Pikin nor get fault; ivun doh una dey liv for di wold wey bad pipol dey, una go dey shine laik stars,
16 bikos una get God mesage wey dey giv life. So, di day wen Kraist go kom, I go get rizin to boast sey I nor run dis race or wok for nor-tin.
17 Bot ivun if dem tak mi offa sakrifais for una, I go dey hapi,
18 so mak una kom folo mi rejoice.
19 As Jisos Kraist wont am, I go send Timoti kom mit una, so dat my heart go strong smol, wit di news wey I go hear abaut una.
20 Among all di pipol for here, na onli Timoti get di kaind maind wey I get for una and naim dey mak mi tink of una and haw una dey manage.
21 Di odas dey bizi wit dia own mata, bot nor bi mata wey konsan Kraist.
22 Una no haw mi and Timoti bi, sey as pikin dey wok wit en papa, na so e dey folo mi wok, so dat di gospol go stand.
23 I go soon send am kom mit una, so dat una go no haw my kondishon bi.
24 Aldoh I biliv Kraist sey, e nor go tey, bifor mi mysef go kom visit una.
25 Bot bifor dat taim, I don tink am sey, e gud mak I send Epafroditus kom mit una. En na my broda, co-woka and soja. Na una mesenja e bi and e dey help mi enitaim wey I nid enitin.
26 Tru-tru, e miss all of una wel-wel and en maind dey wori am, bikos una hear sey e nor wel.
27 E sik wel-wel sotey e nearli die. Bot God get mesi for am; nor bi onli for am, bot for mi tu, so dat I nor go krai join di won wey I dey so.
28 Na dis mak mi won rili send am kom mit una, so dat wen una si-am, una go dey hapi again and I nor go dey wori abaut una.
29 So mak una welkom and respet am as una broda for Kraist wit hapines,
30 bikos e nearli die bikos of Kraist. E put en life for danga, so dat e go fit help mi du wetin una for du, since una nor dey here.