Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Philippians 1

1 Dis leta na from Pol and Timoti, wey bi Jisos Kraist savant. To all God pipol for Filipai, wit dia bishops and lidas.

2 Mak God awa papa and Oga Jisos Kraist giv una grace and peace.

3 I dey tank my God evritaim I rimemba una.

4 Evritaim wen I dey pray for una, I dey du-am wit hapines,

5 bikos of haw una dey help mi prish di gospol from di first day wey una hear am kon rish today.

6 I dey sure sey, di Pesin wey start dis gud wok for una life, go mak am pafet ontil di day wen Kraist go kom.

7 So e dey gud for mi to dey tink abaut una laik dis, bikos una dey my heart. Una don folo mi share from God favor, ivun wen I dey prizin and wen I dey prish di trut abaut di gospol.

8 God no sey, bikos of Kraist luv wey dey my heart, I dey miss una wel-wel.

9 I pray mak una luv dey strong more-more for God tins wey una learn and mak E help una undastand,

10 so dat una go fit shuz wetin beta pas and as una dey du so, una go dey redi for di day wen Kraist go kom.

11 Mak di wok wey Kraist du for us and haw to please God, ful una maind. Den all di glori and praiz go bi God own.

12 My brodas and sistas, I wont mak una no sey my sofa na to mak di gospol stand.

13 Di sojas wey dey gaid di prizin and all di oda pipol don no sey, na bikos of Kraist, I dey prizin

14 and bikos of di prizin wey dem put mi so, almost all di brodas and sistas fate for Kraist, don strong wel-wel. And naw, dem don dey prish God wod witout fear.

15 Tru-tru, na jelosi and kworel mak som dey prish abaut Kraist, bot odas dey du-am wit beta maind.

16 I no sey dis wons na luv mak dem dey du-am, bikos dem no sey I dey here to difend wetin dem dey prish.

17 Doz oda wons wey dey prish abaut Kraist dey du so, bikos dem dey tink abaut diasef and bikos of wetin dem go gain. Dem nor dey du tins wit klin maind and dem tink sey dem fit kos more trobol for mi, bikos I dey prizin.

18 Bot dat won nor mata to mi. So, weda dem dey pritend or du-am wit klin maind, di mesage abaut Kraist dey kontinu and na dat won dey mak mi hapi. I go kontinu to hapi,

19 bikos I no sey na una praya and di help wey Kraist Spirit dey giv, dey save mi.

20 Di hope wey I get bi sey, shame nor go eva fit kash mi; my heart go strong wel-wel and as I dey du naw, na so I go always dey du. Evritin for my bodi go praiz Kraist, weda I dey alaif or don die.

21 Bikos to mi, to dey dis life, na to liv for Kraist and to die insaid Kraist, na dat won beta pas.

22 If I kontinu to dey liv insaid dis bodi, e min sey I go du beta wok, bot I nor no wish won I go laik pas;

23 Naw, I no wish won I go shuz, bikos I won go dey wit Kraist and na dat won beta pas.

24 Bot e go gud for una as I stil dey for dis bodi.

25 I dey sure of dis tins: I no sey I nor go die naw, so dat I go kontinu wit una and as una dey insaid di fate, una life go dey beta more-more.

26 So wen I go kom mit una again as una dey serv Kraist, una go get more rizin to dey hapi bikos of mi.

27 Mak una life dey show sey una biliv Kraist mesage, so dat weda I kom si una or not, I go dey hear sey una dey strong wit won spirit, won maind and dey fite togeda mak di gospol for stand.

28 Mak una nor fear una enimis, bikos dem go soon skata and dat na sign to show sey God go save una.

29 God don giv una dis sign, nor bi onli mak una for biliv Kraist, bot mak una for stil sofa for am,

30 bikos una dey face di same sofa wey una si mi dey face. And I wont mak una no sey, ivun naw, I stil dey sofa di same tin.

Open Bible reader