Nigerian Pidgin Bible
Matthew 2
1 Afta dem born Jisos Kraist for Betlehem wey dey Judea, for di taim wey Herod bi king, som wise men from east, kon go Jerusalem
2 dey ask, "Wer di Ju king wey dem jos born dey? Wi si di star wey tok abaut am, so wi kom woship am.
3 Wetin dem tok so, ves King Herod and Jerusalem pipol.
4 So, di king gada all di prist oga dem and di pipol wey sabi di law, kon ask dem, "Wer una tink sey dem go for born Kraist?
5 Dem kon ansa, "Na for Betlehem, wey dey Judea, jos as Profet Isaia rite sey:
6' Betlehem pipol, una wey smol pas for all di pipol wey dey rule Juda, na from among una di pesin wey go lid all my pipol for Izrel, go from kom.'
7 Den Herod kon kol di wise men go kona, mak dem for tel am wen dem si di star.
8 E kon sey, "Mak una go luk for di pikin wel-wel. Wen una don si-am, mak una kom tel mi, so dat mi tu, go-go woship am.
9 Wen di king tok finish, di wise men kon dey go and di star wey dem si bifor, kon dey lid dem ontil e stop on-top di haus wer di pikin dey.
10 Wen dem si di star, dem kon dey hapi.
11 Dem enta di haus, si di pikin wit en mama kon nil dan woship am. Den dem opun dia bag kon gi-am som gifts wey bi, gold, frankincence and myrrh.
12 Bikos God warn dem for dream mak dem nor go bak go mit Herod, dem kon pas anoda road go dia haus.
13 Wen di wise men don go, God angel kon tel Josef for dream, "Get up, kari di pikin and en mama run go Egypt, mak una stay der ontil I go tel yu wetin una go du, bikos Herod won kil di pikin.
14 Dat same nite, Josef wak-up, kari di pikin and en mama kon run go Egypt.
15 Dem stay der til Herod die. Dis tin mak wetin God profet tok hapun sey, "I kol my pikin komot from Egypt.
16 Wen Herod si sey di wise men disiv am, e ves wel-wel, so e send sojas mak dem go kil all di boys wey don rish tu years kom dan, bikos e don rish tu years wen di wise men kom mit am sey, dem si di star.
17 Dis won mak wetin Profet Jeremia tok hapun sey,
18 Pipol hear krai and shaut for Rama. Rashel dey krai for en pikin dem wey don die and nortin wey pipol tok fit mak en heart strong.
19 Afta Herod die, God angel apier to Josef for dream wen e stil dey Egypt,
20 kon tel am, "Mak yu get up, kari di pikin and en mama go Izrel, bikos di pesin wey won kil-am, don die.
21 So, e kari di pikin and en mama go bak to Izrel.
22 Bot wen e hear sey Arkelaus dey rule for Judea, afta Herod en papa don die, Josef kon fear to go der. Afta God don warn am for dream, e kon go Galili.
23 Wen e rish Nazaret, e kon stay der. Dis won mak wetin Profet Jeremia tok hapun sey, "Dem go sey Jisos Kraist, na Nazaret e from kom."