Nigerian Pidgin Bible
Mark 2
1 Afta som days, wen Jisos go bak to Kapanum, news spread sey e dey haus.
2 Meni pipol kon gada and di haus ful sotey space nor dey to enta or stand near di door. So Jisos kon bigin prish God wod giv dem.
3 Som pipol kon kari won man wey paralaiz kom.
4 As dem nor si road pas kom mit Jisos, bikos pipol plenti der, dem kon rimov di zink on-top di haus for wer Jisos sidan, den dem kon smol-smol drop di bed wey di man laidan put til e rish groun.
5 Wen Jisos si as dia fate strong rish, e kon tel di man wey paralaiz, "My pikin, I forgiv yu all yor sins."
6 So som law tishas wey sidan der kon dey tink wetin Jisos tok for dia maind dey sey,
7 "Why dis man dey tok laik dis? E dey shalenge God! Hu fit forgiv sins esept God?"
8 At wons, Jisos no wetin dem dey tink for dia maind, so e kon ask dem, "Why una dey tink laik dis?
9 "Wish won eazi pas to tok? 'I forgiv yu yor sins,' or 'Get up, kari yor bed mak yu waka?'
10 "Bot mak dem for no sey Man Pikin get pawa for dis wold to forgiv sins, Jisos kon tel di man wey nor fit waka,
11'I tel yu, get up, kari yor bed, mak yu go yor haus.'"
12 At wons, di man get up, kari en bed kon waka komot for dia front. Dem sopraiz wel-wel kon dey praiz God dey sey, "Wi neva si dis kaind tin bifor!"
13 Jisos kon go di wotasaid again and pipol kom mit am for der, so e kon start to tish dem.
14 As e dey waka for road, e kon si Levi, Afius pikin, sidan for wer dem dey kolet tax. E tel am, "Mak yu folo mi." So Levi get up kon folo Jisos.
15 As Jisos dey chop for Levi haus, meni tax koletors and sinas dey chop wit en and en disaipols, bikos di pipol wey folo am, plenti.
16 Wen di law tishas and di Farisi pipol si sey e dey chop wit sinas and tax koletors, dem kon ask en disaipols, "Why una oga dey chop wit tax koletors and sinas?"
17 Wen Jisos hear dis, e kon tel dem, "Pipol wey wel nor nid doktor, bot na doz wey nor wel nid am. Nor bi gud pipol I kom kol, bot na sinas I kom for."
18 Naw, Jon di Baptist disaipols and di Farisi pipol dey fast. So dem kom mit Jisos sey, "Why Jon disaipols and di Farisi pipol dey fast, bot yor disaipols nor dey fast?"
19 Jisos ansa dem, "Pipol wey kom marage nor sopoz to fast wen di man wey dey mari dey wit dem, abi dem sopoz to? So-far di man wey dey mari dey wit dem, dem nor nid to fast.
20 "Bot di taim dey kom wen dem go tak di man wey dey mari from dem, by dat taim, dem go fast.
21 "Nobodi dey tear new klot tak pash old won, oda-wise di pash go tear di klot more and di hol go big pas as e bi bifor.
22 "Nobodi dey pour new wine insaid wine bag wey don old; if not, di new wine go tear di bag, di wine go trowey and di bag go spoil. Insted, na insaid new wine bag dem dey pour new wine put."
23 Jisos kon dey waka pas di farm wer dem plant corn put for Sabat Day and en disaipols kon plok som corn as dem dey pas.
24 So di Farisi pipol kon tel am, "Si, why yor disaipols dey break awa law for Sabat Day?"
25 Jisos ansa dem, "Una neva read wetin David doh wen en and en men nor si fud chop?
26 "Haw en and en men enta God haus wen Abiata bi High Prist kon chop di holi bread wey onli prists sopoz chop?"
27 Jisos kon tel dem, "God mak Sabat Day to help pipol, bot nor bi sey mak Sabat kontrol pipol life.
28 So, na God Pikin bi Sabat Oga."