Nigerian Pidgin Bible
Mark 12
1 Jisos kon tok to dem wit parabol: "Won man plant grape for en farm. E fence am roun, dig wer dem go dey press di wine put, den kon build big haus wey gaid go dey stay. E haya am giv tenants wey go dey kare for di place kon travol go far.
2 "Wen havest taim rish, e send won of en savant go mit di tenants mak dem gi-am en own share for di havest.
3 "Bot di tenants seize di savant, beat am kon send am go bak wit empti hand.
4 "Di man stil send anoda savant go mit dem. Dem nak en head kon beat am enihaw.
5 "E send anoda won again, dem kon kil-am. Na so dem beat and kil oda savants wey e send tu.
6 "Di man get won pikin wey e luv wel-wel and na dis won rimain for am to send. At last, e kon send am go mit dem dey tok for en maind sey, 'As dis won bi my pikin, dem go respet am.'
7 "Bot wen di tenants si-am dey kom, dem kon sey, 'Na di owna pikin dey kom so. Mak wi kil-am, so dat wi go get all di propati for awasef.'
8 "So dem seize am, kil-am kon trow en bodi outsaid di farm.
9 "Na wetin una tink sey di farm owna go du? E go distroi doz tenant kon giv di farm to oda pipol.
10 "Una neva read God wod wey sey, 'Di stone wey di buildas rejet, don turn to di main stone?'
11 "Dis na wetin God du and e gud for awa eye wel-wel.'"
12 Naw, dem won kon arres am, bot dem dey fear di pipol, bikos dem no sey Jisos tok dis parabol against dem. So dem kon waka liv am.
13 Dem send som Farisi and Herod pipol, mak dem faind way to kash Jisos wit wetin e go tok.
14 Wen dem mit am, dem kon ask am, "Tisha, wi no sey yu dey tok trut, yu nor dey du wayo and yu dey tish di trut abaut God way. E gud mak wi dey pay tax giv Caesar, abi mak wi nor pay?"
15 Bot Jisos no dia wayo, so e tel dem, "Why una dey test mi? Mak una bring won koin mak I si."
16 So dem bring won koin and Jisos ask dem, "Wish pesin face and name dey di moni so?" Dem ansa, "Na Caesar own."
17 Jisos tel dem, "Mak una giv Caesar di tins wey bi Caesar own and mak una giv God di tins wey bi God own." Dem sopraiz wel-wel for wetin Jisos tok.
18 Di Sadusi pipol (wey nor biliv sey pipol go wak-up from deat) kom mit Jisos tel am,
19 "Tisha, Mosis rite giv us sey: 'If man broda die and en wife nor born for am, en broda must mari di wuman, mak dem for born shildren for di broda wey don die.'
20 "E get sevun brodas. Di first won mari and wen e die, e nor get shildren.
21 "Di sekon won kon mari di wuman and e nor stil get pikin bifor e die and na so e hapun for di ted won.
22 "No won for di sevun brodas wey mari di wuman get pikin. At last, di wuman tu kon die.
23 "For di taim wey pipol go wak-up from deat, na wish pesin wife di wuman go kon bi, as e bi sey all di sevun brodas mari am?"
24 Jisos ansa dem, "Una nor no sey una dey disiv unasef, bikos una nor no God wod and en pawa.
25 "Wen pipol wak-up from deat, dem nor go mari again, insted dem go bi laik angels for hevun.
26 "Naw, for di mata abaut pipol wey go wak-up, una neva read for di book wey Mosis rite abaut di bush wey fire dey burn and haw God tel Mosis, 'Na Mi bi Abraham, Izik and Jakob God'?
27 "God nor bi God for di pipol wey don die, bot na for di pipol wey dey alaif. Na big mistak una dey mak so!"
28 So, won man wey sabi di law kon dey hear dem dey argue. Wen e si sey Jisos dey ansa dem wel, e kon ask am, "Wish komandment big pas?"
29 Jisos ansa am, "Na dis bi di komandment wey big pas: 'Mak una listin, Izrel pipol, di Oga, awa God na won e bi.
30 'Mak una luv God una Oga wit all una heart, soul and all una pawa.'
31 "Di sekon won na, 'Mak una luv una nebor as una luv unasef.' E nor get eni komandment wey big pas dis tu."
32 Di man wey dey tish di law kon tel Jisos, "Na tru, Tisha. Yu dey koret for wetin yu tok, na onli God bi Oga and no oda god dey apart from am.
33 "To luv God wit all awa heart, maind and pawa and to luv awa nebor as awasef big pas all di sakrifais and ofrins wey pesin fit giv God."
34 Wen Jisos si sey di man tink wel bifor e ansa, e kon tel di man, "Yu nor dey far from God Kindom." From dat taim, nobodi get di maind to ask am eni kweshon again.
35 As Jisos dey tish for di Tempol varanda, e kon sey, "Why e bi sey di law tishas dey sey Kraist na David pikin?
36 "Di Holi Spirit pawa mak David tok sey, 'God tel my Oga, sidan for my rite hand ontil I go put yor enimis unda yor leg.'
37 "If David ensef kol Kraist, 'Oga,' haw Kraist go kon tak bi en pikin again?" Di pipol wey gada kon dey listin to am wit hapines.
38 Wen Jisos dey tish, e kon sey, 'Mak una dey kareful abaut di pipol wey sabi di law. Dem laik to dey waka abaut wit long klot and dem laik loud gritin for market,
39 di chair wey beta pas for sinagog and high tabol for parti, na der dem dey laik sidan put.
40 "Wuman wey en husban don die, dem dey kolet en propati and dem dey pray long praya mak pipol for si dem. Na dia ponishment go wos pas."
41 Den, Jisos sidan face di ofrin box, dey luk as pipol dey put moni insaid. Meni rish pipol kon dey put plenti moni insaid.
42 Won poor wuman wey e husban don die kon kom, put tu koins wey nor rish won penni for insaid di box.
43 Jisos kon kol en disaipols sey, "I tel una tru wod, dis poor wuman wey e husban don die put moni wey pas di oda pipol own.
44 "Bikos di oda pipol giv dia ofrin from di plenti moni wey dem get, bot dis wuman, as e poor rish, put evritin wey e get for life."