Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Luke 6

1 Jisos dey waka pas wer dem plant corn put and en disaipols kon plok som corn dey chop.

2 Som of di Farisi pipol kon sey, "Why una dey du wetin awa law tok sey mak wi nor du for Sabat Day?"

3 Jisos ansa dem, "Una neva read wetin David du wen en and en men dey hungri?

4 "E enta God haus kon tak di bread wey holi wey onli prists sopoz chop and en and en men chop am."

5 So Jisos kon tel dem, "Na Man Pikin bi Sabat Oga."

6 For anoda Sabat day, Jisos enta di sinagog dey tish. Won man wey en rite hand don die dey der.

7 Di law tishas and di Farisi pipol dey luk Jisos wit kona eye weda e go heal pipol for Sabat Day, so dat dem go si wetin dem go tak akiuz am.

8 Bot Jisos no wetin dem dey tink, so e kon tel di man wey en hand die, "Get up, mak yu kom stand for here", so di man get-up, go stand near am.

9 Den Jisos ask dem, "E dey rite to du gud for Sabat" or "to save or distroi enibodi life?"

10 Afta Jisos luk dem roun, e kon tel di man, "Stresh yor hand out." So di man stresh en hand and di hand kon wel.

11 Bot di Farisi pipol and di law tishas kon ves sotey dem nor dey si road again, so dem kon bigin tel diasef wetin dem go du Jisos Kraist.

12 Jisos go mountin go pray kon stay der til day break dey pray to God.

13 Wen day break, Jisos kol en disaipols kon shuz twef among dem wey e kol apostols:

14 Saimon (wey bi Pita) and en broda Andru and James, Jon, Filip, Batlomi

15 Matiu, Tomas, James (Afius pikin) Saimon wey bi Zilot, (pesin wey dey fite for en kontri).

16 Judas (James pikin) and Judas Iskarot wey leta sel Jisos giv en enimis.

17 Den Jisos kom dan wit en apostols kon stand for groun wey level. Meni disaipols from Judea, Jerusalem and all di smol tawns wey near Tyre and Sidon gada kon hear am dey prish and e heal doz wey nor wel

18 and odas wey evil spirit dey wori.

19 Evribodi dey trai to tosh am, bikos pawa wey dey komot from en bodi, dey heal pipol.

20 Den Jisos luk en disaipols, tel dem, "Mak una hapi, una wey dey poor, bikos na una get God Kindom.

21 "Mak una hapi, una wey dey hungri, bikos una go beleful. Mak una hapi, una wey dey krai naw, bikos una go laff.

22 "Una wey pipol hate, dey rejet, kos and dey kol bad pipol bikos of Man Pikin, God go blees una

23 and una go dey hapi for dat day. Mak una hapi wel-wel, bikos di riwod wey una go get for hevun, go big wel-wel. Na so dia gran-gran papa dem tok abaut di profets tu.

24 "Bot kos dey una head, una wey get moni wel-wel naw, bikos una don alredi get una riwod.

25 "Kos dey una head, una wey don ova beleful, bikos una go hungri. Kos dey una head, una wey dey laff naw, bikos una go krai wel-wel.

26 "Kos dey una head, una wey pipol dey tok gud tins abaut, bikos na so dia gran-gran papa dem tok abaut di fake profets tu.

27 "Bot I dey tel una wey dey listin, 'Mak una luv una enimi and du gud to pipol wey hate una.'

28 "Mak una bless doz wey kos una and pray for doz wey dey trit una enihaw.

29 "If enibodi slap una for face, mak una turn di oda side gi-am tu. If enibodi yuz fos kolet una koat, mak una gi-am una shirt join tu.

30 "Mak una giv evribodi wey ask una for somtin and if enibodi tak wetin bi una own, mak una nor ask for am bak.

31 "Mak una du for pipol as una wont mak dem du for una.

32 "If una luv onli di pipol wey luv una, wetin go mak God bless una? Ivun sinas sef luv doz wey luv dem.

33 "And if una du gud for onli doz wey dey du gud for una, wetin go mak God bless una? Ivun sinas dey du di same tin tu.

34 "And if una borow pesin moni wen una no sey e go fit pay una bak, wetin go mak God bless una? Sinas sef dey borow moni giv sinas, so dat dem go pay dem bak dia koret moni.

35 "Bot mak una luv una enimis kon du gud and mak una nor espet enitin bak wen una borow enibodi somtin. Na dis go mak God pay una bak and una go bi en shildren, bikos God ensef dey du gud for wiked pipol and doz wey nor dey sey tank yu.

36 "So, mak una dey show mesi, jos as una Papa dey show mesi.

37 Mak una nor joj oda pipol, so dat God nor go joj una. Mak una nor kondem odas, so dat God nor go kondem una. Mak una forgiv odas and God go forgiv una.

38 "Mak una giv pipol wey nor get and God go giv una wetin rili big, E go pack am wel-wel and di tins go ova ful. God go pour all dis tins for una life. Bot na as una tak giv odas, na so God go tak giv una tu."

39 Jisos stil tel dem anoda parabol, "Pesin wey blind nor dey fit show anoda blind man road, abi e go fit? No! If na so, dem tu go fal insaid gutta.

40 "No student go fit big pas en tisha, bot wen e don learn finish, e go bi laik en tisha.

41 "Why yu dey luk di smol dirti wey dey yor broda eye, bot yu nor dey si di big wud wey dey yor own eye.

42 "Haw yu go tak tel yor broda sey, 'Broda, mak I rimov di dirti wey dey yor eye, bot yu nor dey si di wud wey dey yor own eye? Yu wey dey pritend, mak yu first komot di wud for yor eye, den yu go si wel to fit rimov yor broda own.'

43 "Bikos no beta tri dey bear bad frut and no bad tri dey bear gud frut,

44 bikos na frut wey tri bear, naim pipol dey tak no di kaind tri wey e bi. Pipol nor dey plok fig or grape from shuku-shuku tri.

45 "Wen pesin dey gud, na di gud tins wey dey insaid am, dey mak am bear gud fruts, bot bad pesin, na di bad tins wey dey insaid am, dey mak am bear bad fruts, bikos na from wetin ful insaid pesin maind, naim en mout dey tok.

46 "Why una dey kol mi, 'Oga' and una nor dey du wetin I tel una?

47 "Enibodi wey kom mit mi and listin to my wod kon du-am; I go show una wetin di pesin bi laik.

48 "E bi laik man wey dey build haus, wey dig groun kon lay di foundashon on-top strong rock. Wen big wota rush kom, e nor go fit shake di haus, bikos dem build am for beta rock.

49 "Bot di pesin wey hear my wod and e nor du-am, e bi laik man wey build haus wey nor get strong foundashon. Wen big wota kom, di haus go fal skata."

Open Bible reader