Nigerian Pidgin Bible
Luke 12
1 Plenti pipol gada aroun Jisos kon dey waka jam won anoda, so Jisos kon tel en disaipols, "Mak una shine una eye wel-wel, bikos of di Farisi pipol wey dey pritend.
2 "Enitin wey pipol hide naw, go kom out for publik and enitin wey dey sikrit naw, God go bring am out.
3 "So enitin wey pesin du for daknes, go kom out for lite and enitin wey pesin tok for sikrit, pipol go shaut am from on-top haus.
4 "I tel una wey bi my frends, mak una nor fear pipol wey fit kil pesin, bot dem nor fit du pas dat.
5 "Bot mak I tel una hu una must fear: Mak una fear di Pesin wey get pawa to trow una insaid hell fire afta E don kil una. Yes, I tel una tru wod, na-im una must fear!
6 "Nor bi tu koins dem dey sel faiv sparo bird? Bot God nor dey forget eni won of dem.
7 "Si, God no di numba of hair wey dey una head. So mak una nor fear, bikos una beta pas meni sparo bird.
8 "I tel una tru wod, enibodi wey stand-up for publik sey en no mi, mi tu go stand-up for am, for wer God angels dey.
9 "Bot pesin wey rejet mi for wer pipol dey, mi tu go rejet am for wer God angels dey.
10 "And enibodi wey tok bad abaut Man Pikin, God go fit forgiv am, bot pesin wey tok bad abaut di Holi Spirit, God nor go forgiv am.
11 "Wen dem kari una go sinagog or go mit govnors and pipol wey get pawa to joj una kase, mak una nor wori abaut haw una go difend unasef or wetin una go tok,
12 bikos di Holi Spirit go tel una wetin to tok, wen dat taim rish."
13 Den won pesin among di pipol kon sey, "Tisha, tel my broda mak e divide di propati wey awa papa die liv for us."
14 Bot Jisos ask am, "My frend, na hu mak mi joj for una tu mata?"
15 Den Jisos tel dem, "Mak una gaid against longtrot, bikos nor bi wetin pesin get for dis life go save am."
16 So Jisos kon tel dem won parabol: "Won rish man plok plenti fud from en farm,
17 so e kon tink for en maind sey, 'Wetin I go du naw? Bikos I nor get eniwer to kip all dis fud wey I plok so.'
18 'Den di man sey, 'I no wetin I go du: I go skata my stores kon build new big-big won wey I go kip all my fud and oda tins wey I plok.'
19 'Den I go tel mysef, "Yu get plenti fud wey go last yu for meni years, so mak yu go slip, chop and drink, dey enjoy yorsef!'"
20 "Bot God kon tel di man, 'Yu bi fool! Dis nite, yu go die, den hu go kon get all dis tins wey yu don gada for yorsef?'
21 "Na so e go bi wit pesin wey dey gada moni kip for ensef, bot en heart nor dey wit God."
22 Jisos tel en disaipols, "Naw I dey tel una, mak una nor wori abaut una life, wetin una go chop or klot wey una go wear for bodi.
23 "Bikos life gud pas fud and awa bodi beta pas klot.
24 "Mak una tink haw birds bi: Dem nor dey plant or plok, dem nor get wer dem dey kip fud put, bot God dey giv dem fud chop. If God dey kare for dem, wot abaut una wey beta pas dem?
25 "Wish of una go fit add won hour join en life, bikos e dey wori?
26 "So, if una nor fit du dis simpol tin, why una dey wori abaut di odas?
27 "Mak una tink of haw flawas dey grow: Dem nor dey wok or mak klot for demsef. Bot I tel una tru wod, ivun Solomon for all di glori wey e get, nor dress fine rish flawas!
28 "If God dey dress grass, wey dey today and pipol go kut am trow for fire tomoro, dat God nor go fit kare for una? Una fate smol wel-wel-o-o!
29 "Mak una nor dey wori abaut wetin una go chop or drink.
30 "Na bikos of all dis tins, pipol wey nor no God dey wori demsef, bot una Papa for hevun no sey una nid dem.
31 "Insted mak una first strogol to enta God Kindom and God go giv una all di oda tins."
32 "Mak una nor fear, una wey bi smol ships, bikos una Papa go hapi to giv una di kindom.
33 "Mak una sel evritin wey una get and giv di moni to poor pipol. Bag wey nor go tear, mak una tak am gada beta tins for hevun, wer tif nor go fit rish and ant nor go fit spoil dem.
34 "Bikos na wer yor propati dey, na der yor heart go dey tu.
35 "Mak una redi to serv God and mak una lite dey shine evritaim.
36 "Mak una bi laik pipol wey dey wait for dia oga to kom bak from parti, so dat wen e nok, una go kwik opun door for am.
37 "Di savant wey en oga go kom bak kon mit am dey wok, mak e hapi wel-wel bikos di oga go priper ensef mak e for serv di savant fud for tabol.
38 "Mak doz savant hapi wel-wel, ivun if di oga kom for nain or tiri oklok for nite kon si sey dem neva slip.
39 "Bot mak una no dis. If di owna of di haus no wen tif dey kom, e nor go let di tif break enta en haus.
40 "Una must dey redi tu, bikos Man Pikin go kom wen nobodi dey espet am."
41 Den Pita kon ask, "Oga na onli wi yu dey tel dis parabol, abi na evribodi?"
42 Jisos ansa, "Hu bi di manaja wey get sense and nor dey du wayo? Na pesin wey di oga put mak e kare and giv di oda savants dia fud for di rite taim?
43 "Di savant wey en oga kom bak kon mit am dey du en wok, mak e hapi wel-wel.
44 "I tel una tru wod, di oga go sey make e kare for all en propati.
45 "Bot if dat savant tink for en maind sey, 'My oga go tey smol and e bigin beat di oda savants, weda na man or wuman; e kon dey chop, dey drink enihaw,
46 den di oga kon kom bak for di day wen di savant nor tink sey e go kom. Di oga go ponish di savant kon lock am for wer dem dey kip wiked pipol.'
47 "Di savant wey no wetin en oga wont and e nor du-am, dem go flog am wel-wel.
48 "Bot di savant wey nor no wetin en oga wont and e du tins wey go mak dem beat am, dem go beat am smol. Pesin wey God giv plenti tins to, E go ask plenti tins from am and di won wey God giv plenti, E go ask doubol from dem."
49 "I bring fire kom dis wold and I wish sey di fire don dey kash!
50 "E get won baptizim wey dem go baptaiz mi and my maind nor go fit res ontil e hapun!
51 "Una tink sey na peace I bring kom dis wold? No, I kom divide una!
52 "From naw go, famili wey bi faiv go divide, tiri go dey against tu, tu go dey against tiri.
53 "Papa go dey against en son and son go dey against en papa, mama go dey against en dota and dota go dey against en mama, husban-mama go dey against en pikin wife and wife go dey against en husban-mama."
54 Jisos tel di pipol, "Enitaim una si sey di kloud dey go West, una dey no sey, heavi rain won fal and tru-tru, e go fal.
55 "And wen una si briz dey blow from East, una go sey, 'Heat go dey today' and na so e go bi.
56 "Una wey dey pritend! Una fit tok haw di weda go bi, bot why una nor fit tok wetin dey hapun so?"
57 "Why una nor dey tok wetin dey gud for pipol to du?
58 "If yu and pesin get kase and una dey go kourt, mak yu trai setol wit am for road, so dat e nor go drag yu go mit di joj, wey go giv yu to polis and dem go trow yu insaid prizin.
59 "I tel una tru wod, yu nor go komot for der ontil yu pay all di moni wey yu dey hol!"