Nigerian Pidgin Bible
Luke 10
1 Afta, Jisos shuz sevunti-tu men kon send dem tu by tu go all di tawn and oda place wer e won go leta.
2 E tel dem, "Di frut wey dem won plok, plenti, bot pipol wey go plok dem, nor plenti rish. Mak una pray mak di Oga wey get di farm send wokas kon gada en frut.
3 "Mak una go! I dey send una laik smol-smol ship go mit wiked anima.
4 "Mak una nor tak bag or shu and nor grit enibodi for road.
5 "Wen una enta eni haus, mak una first sey, 'Mak peace dey dis haus!'
6 "If enibodi wey wont peace dey der, una peace go stay wit am, bot if e nor dey, una peace go kom bak to una.
7 "Mak una stay for dat haus, chop and drink enitin wey dem giv una, bikos enibodi wey dey wok, sopoz to get en pay. Mak una nor dey waka from won haus go anoda.
8 "Wen una enta eni tawn and dem welkom una, mak una chop di fud wey dem giv una
9 and heal di sik pipol for dat tawn, den tel di pipol wey dey der sey, 'God Kindom don kom mit una.'
10 "Bot wen una enta eni tawn and dem nor welkom una, mak una go road kon sey,
11 'Ivun di sand for una tawn wey dey awa leg, wi shake am komot mak e bi witnes against una. Bot mak una no sey: God Kindom don kom mit una.'
12 "I tel una tru wod, e go beta for Sodom for jojment day pas dat tawn!
13 "Korazin and Betsaida pipol, kos dey una head! Bikos if to sey na for Tyre and Sidon dem for du di mirakols wey dem du for una tawn, di pipol der for don turn from sin kom mit God since, dem for don sidan, wear sack-klot and put ashes for dia head kon dey beg God mak E forgiv dem.
14 "Bot e go beta for Tyre and Sidon pipol pas una for jojment day!
15 "Una Kapanum pipol, una tink sey God go jos kari una go hevun? No, E go trow una for hell fire."
16 Jisos tel en disaipols, "Enibodi wey listin to una, don listin to mi and enibodi wey rejet una, don rejet mi and God wey send mi."
17 Di sevunti-tu men kon kom bak wit hapines, dey sey, "Oga, ivun dimons dey obey us wen wi komand dem wit yor name!"
18 Jisos tel dem, "I si Satan wen e fal laik tunda-lite from hevun.
19 "Mak una listin, I don giv una pawa to waka on-top snake and skorpion and to ova kom all di enimi pawa, so nor-tin go fit wound una.
20 "Mak una nor onli dey hapi sey evil spirit dey obey una, insted mak una hapi sey God rite una name for hevun."
21 For dat taim, di Holi Spirit kon mak Jisos dey hapi, so e kon sey, "I praiz Yu, Papa wey bi Oga for hevun and eart, bikos Yu don hide dis tins from pipol wey get sense and wise, bot Yu show dem to yor shildren. Yes, Papa, na so Yu wont mak e bi.
22 "My Papa don giv mi evritin. Nobodi no hu di pikin bi esept di Papa and nobodi no hu di Papa bi esept di pikin and pipol wey di pikin won show."
23 Den Jisos kon face en disaipols tel dem smol-smol, "God don bless di pesin wey en eye si wetin una dey si so -o -o!
24 "I tel una tru wod, 'Meni profets and kings don trai to si wetin una dey si so, bot dem nor fit si-am and dem don won hear wetin una dey hear so, bot dem nor fit hear-am."
25 Won man wey sabi di law wel-wel kon get up test Jisos, "Tisha, wetin I go du to tak get life wey nor dey end?"
26 Jisos kon ask am, "Wetin yu undastand abaut Mosis law?
27 Di man ansa, "Mak yu luv God yor Oga wit all yor heart, yor soul, yor pawa and maind, den luv yor nebor as yu luv yorsef."
28 Jisos kon tel am, "Yor ansa koret, mak yu du dem and yu go get koret life."
29 Bot di man won show sey en no wel-wel, so e kon ask Jisos, "Hu bi my nebor?"
30 Jisos tel am dis stori, "Won man dey travol from Jerusalem go Jeriko and tif kon atak am for road, dem naked am, beat am til e nearli die, den kon waka liv am.
31 "Afta, won prist dey pas der, wen e si di man, e waka pas for di oda side for di road.
32 "Na so tu, won woka for di tempol stil waka rish wer di man dey, bot e waka pas di oda side for di road.
33 "Bot won Samaria man wey dey travol for dat road kon rish wer di man dey, as e si di man, e sori for am.
34 "E waka go mit di man kon rob wine and olive oil for en sore and bandage am. Den e put di man on-top en horse kon kari am go won hotel and e kare for am dat nite.
35 "Di next day, di Samaria man giv di hotel manaja tu silva koins kon tel am, 'Mak yu kare for dis man, wen I kom bak, I go pay yu eni extra moni wey yu spend.'"
36 Jisos kon ask di man wey e dey folo tok sey, "Among dis tiri men, wish won yu tink sey bi nebor to di man wey tif atak?"
37 Di man wey sabi di law wel-wel kon ansa, "Na di won wey kare for di man." So, Jisos kon tel am, "Mak yu go du di same tin."
38 As Jisos and en disaipols stil dey travol, dem rish won vilage and won wuman wey en name bi Marta kon welkom dem for en haus.
39 Mary, wey bi Marta sista, sidan near Jisos leg dey listin to wetin e dey tish.
40 Bot Marta nor hapi, bikos of all di wok wey e dey du, so e mit Jisos kon sey, "Oga! Si, my sista don liv all di wok for mi. Abeg, tel am mak e kom help mi."
41 Jisos ansa am, "Marta! Marta! Yu dey tu wahala yorsef abaut meni tins,
42 na onli won tin dey important and Mary don shuz di koret tin and nobodi go fit tak am from am."