Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

John 1

1 From wen taim bigin naim di Wod dey and di Wod dey wit God and na God ensef bi di Wod.

2 Di Wod dey wit God from wen taim bigin.

3 Naim mak evritin and if to sey E nor mak dem, dem nor for dey dis wold at-all.

4 Na insaid am life dey and na dat life bi di lite wey pipol get.

5 Di lite dey shine insaid daknes, bot daknes nor gri wit am.

6 E get won man wey en name bi Jon, wey God send kom dis wold.

7 E kom bear witnes for di lite, mak evribodi for fit get di shanse to biliv wetin God tok tru en wod.

8 Nor bi Jon ensef bi di lite, bot e kom tel pipol abaut Jisos wey bi di lite.

9 Na Jisos bi di tru lite wey go shine for evribodi for dis wold.

10 E kom insaid di wold wey ensef mak, bot di pipol nor no am.

11 E kom mit en own pipol, bot dem nor wont am.

12 Bot evribodi wey risiv and biliv en name, e go giv dem di rite to bi God pikin.

13 Dem go bi God shildren, nor bi as dia mama and papa tak born dem from bele, or bikos sombodi mak dem so, bot bikos God ensef mak dem en own shildren.

14 Den di Wod kon shange to pesin and e stay wit us for dis wold. Wi si en glori wey show sey, naim bi di onli pikin wey get koret favor and trut, wey God send kom mit us.

15 Jon kon bigin shaut sey, "Dis na di pesin wey I tel una abaut sey, 'Di pesin wey go kom afta mi, big pas mi, bikos e dey bifor mi.'"

16 Evribodi for dis wold don risiv plenti gud tins from am.

17 Na tru Mosis God giv us di law, bot God giv us favor and trut, tru Jisos Kraist.

18 Nobodi don fit si God face bifor. Bot Jisos, wey bi God ensef, wey en and en Papa bi tait frend, na-im kom show us haw God bi.

19 Di Ju oga dem send prists and Levi pipol mak dem go ask Jon sey, "Hu yu bi sef?"

20 E ansa dem, "I nor dey lai, bikos nor bi mi bi di Kraist."

21 Den dem ask am, "So, na hu yu bi? Abi yu bi Elija?" E kon sey, "No, I nor bi Elija." Dem kon ask am again, "Yu bi di profet?" E ansa, "No-o-o!"

22 Again, dem ask am, "Hu yu bi sef? Mak yu tel us, so dat wi go no wetin to tel di pipol wey send us. Hu yu sey yu bi?"

23 Jon kon sey, "Na mi bi dat vois wey dey shaut insaid widanes sey, 'Mak una mak di road wey pipol go pas go mit God strate wel-wel', as Profet Isaia tok bifor.'"

24 (Na di Farisi pipol send dis pipol go mit Jon).

25 Dem kon ask Jon sey, "Why yu dey baptize pipol, if yu nor bi di Kraist or Elija or di Profet?"

26 Jon kon tel dem, "I dey baptize pipol wit wota, bot among una, won pesin dey wey una nor no.

27 "E go kom afta mi. I nor rish to luz di rope wey dey en shu."

28 All dis tins hapun for Betani wer pipol dey kros Jordan Riva kom mit Jon, mak e baptize dem.

29 Wen day break, Jon si Jisos dey waka kom mit am, den Jon sey, "Mak una luk! Dis na di Ship wey God send kom die, mak God for forgiv us awa sins".

30 Na dis pesin I tel una sey, "Afta mi, won man wey big pas mi go kom, bikos e dey bifor mi.

31 "Misef nor no am bifor, bot I dey baptize pipol wit wota, so dat God go show Izrel pipol hu Jisos bi."

32 Den Jon bear witnes sey, "I si God Spirit wey kom dan laik dove from hevun kon stay for Jisos head.

33 "I nor no am bifor, bot di pesin wey send mi kom baptize wit wota tel mi sey, 'Di pesin wey yu go si God Spirit kom stay on-top en head, na-im go baptize pipol wit Holi Spirit.'

34 "I don si-am and I bear witnes sey, 'Dis man na di pesin wey God shuz.'"

35 Wen day break, Jon wit en tu disaipol stand for outsaid.

36 Dem kon dey luk Jisos wen e dey waka pas, den Jon kon sey, "Mak una luk! Na dat pesin bi God Ship."

37 Wen Jon tu disaipols hear wetin e tok, dem kon folo Jisos.

38 Jisos luk bak kon si di disaipols dey folo am. Den e ask dem, "Wetin una wont?" Dem ansa am, "Oga, (wey min Tisha) wer yu dey stay?"

39 Jisos ansa dem, "Mak una kom si-am." So dem go si di place wey e dey stay kon stay wit am dat day. Dat taim na abaut for o' klok for aftanun.

40 Andru, Saimon Pita broda, na won of di disaipols wey hear wetin Jon tok and wey folo Jisos.

41 E first go faind en broda Saimon kon tel am, "Wi don si di Mezaya", (wey min Kraist).

42 Andru kon bring Saimon kom mit Jisos. Wen Jisos si-am, e kon tel am, "Yu bi Saimon, Jon pikin, na Sefas (wey min Pita) pipol go dey kol yu from today go."

43 Wen day break, Jisos kon plan to go Galili. Wen e si Fillip, e tel am, "Mak yu folo mi."

44 Fillip na from Betsaida, wey bi Andru and Pita home-tawn.

45 Wen Fillip si Nataniel, e tel am, "Wi don si di pesin wey Mosis and di profets rite abaut for dia book sey, 'En name na Jisos, wey en home-tawn bi Nazaret and na Josef pikin e bi.'"

46 Nataniel kon sey, "Beta tin go fit kom out from Nazaret?" Fillip ansa am, "Mak yu kom si."

47 Wen Jisos si Nataniel dey waka kom mit am, e kon sey, "Mak una luk! Dis na beta pesin wey kom from Izrel, wayo nor dey en bele."

48 Nataniel kon ask am, "Haw yu tak no mi." Jisos ansa, "Bifor Fillip kol yu wen yu dey unda di tri, I don si yu."

49 Nataniel sey, "Tisha, tru-tru, yu bi God Pikin and na yu bi Izrel king."

50 Jisos kon tel am, "Bikos I tel yu sey I si yu unda di fig tri, yu biliv wetin I tok? Bikos yu biliv, yu go si wetin big pas dis won."

51 Den e kon sey, "Wetin I dey tel una na tru wod, una go si hevun opun and God angels go dey waka up-and-dan on-top God Pikin."

Open Bible reader