Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Hebrews 6

1 E don rish wen wi go stop to learn onli di first tins wey Kraist tel us, so mak wi dey grow kon no Kraist more-more. Wi nor nid to stil dey tish una abaut tins wey dey kause deat; why wi must biliv God;

2 wetin baptism min; to put hand for pipol head; to wak pipol from deat and abaut God final jojment.

3 As God dey help us, na new-new tins wi go dey tish una abaut di fate.

4 Wen pesin don first no di trut; taste God gift from hevun; no di Holi Spirit;

5 don taste God gud wok and di beta wey dey kom,

6 den e kon start to sin, dat pesin nor go fit turn from sin kom mit God, since e don kil God Pikin for di sekond taim and disgrace am for publik.

7 Wen rain don sock groun and e bear beta fruts for di farma, dat min sey God don bless di man.

8 Bot if na so-so shuku-shuku and grass di groun dey bear, dat min sey e dey yuzles. So God go kos and distroi am wit fire.

9 Bot as for una wey bi my frends, ivun doh wi dey tok to una laik dis, wi no sey dis tins nor go hapun to una, bikos una don undastand God salvashon.

10 God nor dey sopot pipol enihaw. E go rimemba haw una help en pipol bifor-bifor and haw una stil dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di luv wey una show en shildren.

11 As una stil dey dis wold, wi wont mak una kontinu to luv won anoda, so dat wetin una dey hope for, go kom.

12 So mak eni of una nor taya, bot mak una dey patient and biliv, so dat una go gain God promis.

13 Nobodi big pas God, bikos God swear wit en name wen E promis Abraham sey,

14 "Na mi bi Oga, I go bless yu wel-wel and yor shildren go plenti."

15 Bikos Abraham get patient, God kon gi-am wetin E promis am.

16 Wen pipol won setol mata, dem dey swear wit pesin wey big pas dem and di agriment wey dem mak, dey end di mata.

17 So wen God won show en pipol sey E nor go break en promis, E kon swear wit ensef.

18 God nor dey lai! So di promis wey E mak and ensef wey E tak swear, na tu tins wey nor go shange. Since wi don run go mit God mak E gaid us, e gud mak awa maind strong, so dat wi nor go fear as wi biliv en promis.

19 Dis hope strong for awa heart laik ship wey dem tie mak e nor for move, bikos di hope wey wi get dey kam-kpe and strong gidigba. Di promis go tak us pas di kurtain for hevun, ontil wi rish wer God dey;

20 di place wer Jisos don enta for us and don bikom High Prist foreva, jos as Melkizedek bi.

Open Bible reader