Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Hebrews 12

1 Since wi get meni witnes wey soroun us, e gud mak wi drop evri load and sin wey dey mak us fal, so dat wi go yuz awa maind liv di life wey God wont.

2 Mak wi dey luk Jisos Kraist wey giv us awa fate and e go help us kip am. Bikos of di joy wey Jisos dey espet, e sofa for kros and nor maind di shame wey folo am. Bot naw, e don sidan for di rite hand side for God throne.

3 If una dey tink of haw Jisos sofa for wiked pipol hand and haw dem hate am, una maind go strong for fate.

4 As una dey strogol mak una nor for sin, una strogol neva rish to kil una, as Kraist die.

5 Abi una don forget di advise wey God tel una as en shildren? "My pikin, mak yu listin wel-wel wen God dey koret yu and nor ves wen God ponish yu.

6 "Bikos na di pesin wey God luv, na-im E dey koret and E dey ponish all di shildren wey bi en own."

7 So mak una bear as una dey sofa, since e bi sey na una Papa dey ponish una; dat won go show sey God dey trit una laik en shildren. Abi e get pikin wey en papa nor dey ponish?

8 Bot if God nor ponish yu as e dey ponish all en shildren, dat min sey yu nor bi beta pikin and yu nor get papa.

9 If awa papa for eart ponish us and wi dey respet dem, e nor gud mak God ponish us, so dat awa life go beta?

10 Awa papa dey ponish us for dis wold as e gud for dia eye, bot God dey ponish us for awa own gud, so dat wi go folo am share en holines.

11 No ponishment dey swit pesin wen dem dey ponish am, bikos e dey pain. Bot di pesin wey God ponish, go get life wey nor dey end.

12 So una hands and knees wey don taya, mak una mak dem strong.

13 And mak una waka for strate road, so dat una leg wey don taya, go strong.

14 Mak una trai to liv for peace wit evribodi and dey holi, bikos enibodi wey nor dey holi, nor go si God.

15 Mak una mak sure sey nobodi turn bak from God grace and mak nobodi get bad bele and kause trobol wey go mak pipol sin.

16 Mak una mak sure sey nobodi dey du bad tins or nor dey fear God, jos laik Esau wey sel en rite as first born, bikos of fud.

17 Una no haw e trai to get-am bak leta, bot e nor fit, ivun doh e beg and krai giv en papa.

18 Una don rish Mount Sinai, wer God for tok to Izrel pipol. For der, fire burn, daknes dey der and storm and

19 trumpet kon dey mak nois. Izrel pipol hear God vois, so dem beg am mak E stop,

20 bikos dem nor fit bear en komand wey sey, "Mak una kil eni anima wey tosh di mountin."

21 Wetin hapun dey mak pesin fear, so Mosis kon sey, "I dey fear and dey shake."

22 Insted, una don kom Mount Zion; di tawn wer God dey stay; di Jerusalem for hevun wer tazon angels dey. Una don enta di assembli,

23 di place wer all di first born gada and dis na di pipol wey God rite dia name for hevun. Una don kom mit God wey go joj evribodi and na-im dey mak pipol pafet.

24 Una don kom mit Jisos, di pesin wey God yuz tak start di new kovenant wit en pipol and una don kom mit di blood wey dem spray and dis blood dey tok beta wod wey pas Abel own.

25 Mak sure sey una dey obey di Pesin wey dey tok to una! Bikos if Izrel pipol, wey nor gri hear dia oga Mosis wod for eart nor eskape, haw wi go fit eskape, if wi nor gri hear di Pesin wey dey tok to us from hevun?

26 For dat taim, en vois dey shake di eart, bot naw, E don promis sey, "Nor bi onli dis eart I go shake, bot I go shake di hevuns tu."

27 Dis min sey di tins for eart go shake komot and na onli di tins wey God nor won shake, go rimain.

28 Since wi don risiv di kindom wey dem nor fit skata, mak wi tank and woship God wit respet and fear. Mak wi gi-am di kaind woship wey go mak bele swit am.

29 Bikos awa God na big and strong fire wey dey distroi tins.

Open Bible reader