Nigerian Pidgin Bible
Ezekiel 20
1 Na tenth day of the fifth month of seventh year wey we dey strange land. Some of leader of Israelite community come consult me about will of God, and dem sit down for my front.
2 then God speak to me.
3 He talk say, "Mortal man," "speak to these leaders and tell dem the Almighty God dey talk say: una don come to ask my will, no be so? As surely as I be living God, I no go allow una ask me anything I, the Almighty God, don speak.
4 Mortal man, say you don ready to pass sentence on top them? So do am. Remind dem of the disgusting things wey their ancestor don do.
5 Tell them wetin I dey talk, say. When I chose Israel, I make promise with them. I reveal myself give them for Egypt and I tell dem say: I be the LORD una God.
6 Na then I come make promise say I go take them commot for Egypt and I lead to land wey I don chose for them, a rich and fertile land, and land wey fine pass others.
7 I tell them make dem throw away the disgusting idols wey dem love and say make dem no make their self unclean with false god of Egypt, because I be the LORD their God.
8 But dem provoke and no gree listen to me. Dem no throw their disgusting idol away or give up on top the god of Egypt. I don ready for them make dem feel force of my anger for there in Egypt.
9 But I no do am, since that go dishonour to my name, because I don announce to Israel for front of people wey dem dey live with say I go lead dem commot for Egypt.
10 "And so I lead dem commot from Egypt go desert.
11 I give dem my command and teach them my law, wey bring life to anyone wey obey them.
12 I don make keeping of Sabbath sign of agreement between us, so to remind them say I, God, make them holy.
13 Even dem provoke me for desert. Dem break my laws and reject my command. Wey dey bring life to anyone wey obey them. Them make the Sabbath no dey holy completely. I don ready to let dem feel force of my anger for the desert and I don ready to destroy them.
14 But I no do am, since that go brin dishour to my name among nation wey don see me dey lead Israel commot for Egypt.
15 Naso I make promise for the desert say I no go take them go land wey I don promise them, rich and fertile land, the land wey fine pass other land.
16 I make the promise because they don reject my command, break my law, and make the Sabbath unholy- dem prefer to dey worship ther idol.
17 "But I get pity on top tem, I decide say I no go kill them for there for desert.
18 Instaed, I warn the young people wey dey among them: make una no keep the law wey una ancestor don make; make una no follow their way or make una self unholy with their idol.
19 I be the LORD una God. Obey my law and my command.
20 Make una make Sabbath holy day, so e go be sign of agreement wey we make and go remind una say I be the LORD una God.
21 "But the generation don also provoke me. Dem break my law and no gree keep my command, wey dey brig life to anyone wey obey them. Dem defy the Sabbath. I don reday to make dem feel force of my anger there for desert and kill all of dem.
22 But I no do am, since that go dishonour my name among the nation wey don see me dey bring Israel commot for Egypt.
23 Naso I make another promise for desert. I swear say I go scatter all of them for the world.
24 I do this one because they don reject my command, break my law, no make the Sabbath important, and dey worship the same idol wey their ancestor don serve.
25 "Then I come give them law wey no good and command wey no bring life.
26 I make dem pollute their self with their offering, and I let dem sacrifices their firstborn son. This na to punish them amd show dem say I be God.
27 "Now, Mortal man, tell the Israelite wetin I, the Almighty God dey tell them. This na another way wey their ancestor insult me as they no dey faithful.
28 I bring the come land wey I don promise them. When dem see high hill and gree tree, dem offer sacrifice give all of them. They make me vex with the sacrifice wey dem burn and by the wine wey dem bring as offering.
29 I ask them say: wetin be these high places where una dey go? So they do dey call dem "High places since.
30 Now tell the Israelite wetin I, the Almighty God, dey say: why una must commit the same sin una ancestor don sin and go run after their idol?
31 Even today una offer the same gift and mak una self unholy with the same idol by sacrificing una children give dem for fire. And you Israelite still come ask me wetin my will be! As surely as I, the Almighty God, be the living God, I no go allow una ask me anything.
32 una don make una una mind say una wan be like other nation, like people wey live for other country dey worship tree and rock. But dem no go ever be.
33 "As surely as I, the Almighty God, be the living God, I warn una say in my anger I go rule over una with strong hand, with all my power.
34 I go show una my power and my anger when I gather una together and bring back una from all the country wey una don scatter.
35 I do bring una come "Desert of the nation", and I go condemn una there for una face,
36 Almighty God talk say, I go condemn una as I condemn una ancestor for Sinai desert.
37 "I go control una and make una obey my covenant.
38 I go take those people wey dey sin and no dey obey away from among una.i go take them commot for the land where dem dey live now, but I no go let them return go land of Israel. Then una go know say I be God."
39 The Almighty God talk say, "And now, all you Israelite, do as una like! Continue to dey serve una idol! But I warn una say after this una go obey and stop to dey dishonour my holy name by offering gift to una idol.
40 There for the land , on top my mountain, the mountain of Israel all of una people of Israel go worship me. I go be happy with una and I go expect say make una bring una sacrifice to me,una best offering, and una holy gift.
41 After I don commot una from country where una don scatter and gather una together, I go accept the sacrifice wey una burn, and the nation go see say I dey holy.
42 When I bring una come back Israel, the land wey I promise say I go give una ancestor, then una go know say I be God.
43 Then una go remember all the disgraceful thing wey una don do and how una don pollute una self. Una go dey ashame of una self because of evil things wey una don do.
44 When I wan protect my honour, you Israelite go know say I be God, because I no do to una as una wicked, evil action deseve." The Almighty God don speak.
45 God speak to me.
46 He talk say, "Mortal man", "Look south. Speak against am and prophesy against forest for south.
47 Tell the south forest make E hear wetin the Almighty God dey talk: Look! I dey start fire, and E go burn every tree wey dey inside you, whether green or dry. Nothing go fit pull am out. E go spread from south go north and everyone go feel the heat of the fire.
48 All of them go see say na me, God, dey burn am and that no one fit put am out."
49 Then I talk say, "oh, Almighty God! if I say this, people go talk say I just dey tell them story."