Nigerian Pidgin Bible
Acts 7
1 Di prist oga dem kon ask Steven, "All dis tins wey dem tok abaut yu so, na tru?"
2 Steven ansa, "My brodas and fadas, mak una listin to wetin I won tok so. Na wen Abraham, awa gran-gran papa dem dey for Mesopotamia, bifor e go stay for Haran, naim God wey get pawa, apier to am
3 kon tel am sey, "Mak yu liv yor kontri and yor pipol kon go di land wey I go show yu.
4 "So Abraham liv Kaldian kontri kon go stay for Haran. Afta en papa die, God kon tel am mak e stay for dis land wey una dey naw.
5 "Dat taim, God neva giv am eni part for di land and e neva born eni pikin, bot God promis am sey E go gi-am di land and en and en shildren go stay der foreva.
6 "God tel am, 'Di shildren wey yu go born go bi strenja for anoda kontri and di pipol for dat kontri go sofa dem kon yuz dem as slave for for ondred years.'
7 "Bot God sey, 'I go ponish di pipol wey go yuz dem as slave and afta all dis tins, dem go komot for der kon woship mi for dis place.'
8 "So God mak kovenant wit Abraham tru sekonsishon. Abraham kon born Izik and sekonsaiz am afta ate days. Izik born Jakop and Jakop born di twef brodas, wey bi awa gran-gran papa dem.
9 "Jakop shildren wey bi awa gran-gran papa dem, bikos dem dey jelos Josef dia broda, dem kon sel am as slave go Egypt, bot God dey wit am
10 kon save am from all en wahala and from Fero wey bi Egypt king, E gi-am favor wit wisdom and Fero kon mak am oga for di hol Egypt and ova evritin wey e get.
11 "Hunga kon dey for di hol Egypt and Kanan and awa gran-gran papa dem nor si fud chop.
12 "So wen Jakop hear sey fud dey for Egypt, e kon send awa gran-gran papa dem go shek if na tru.
13 "Afta dem don go tu taims, Josef show ensef giv en brodas and Fero kon no Josef famili.
14 "Josef send mesage go giv en papa Jakop sey mak en and all di pipol wey dey wit am kom Egypt and dem bi sevunti-faiv wey go.
15 "So Jakop and awa gran-gran papa dem go Eygpt and dem die for der.
16 "Dia bone dey der til dem kari dem go bere for Shekem for di grave wey Abraham buy from Hamor shildren.
17 "Bot as taim dey near wen God go fulfil di promis wey e mak wit Abraham; Izrel pipol kon dey meni insaid Egypt,
18 til anoda Fero wey nor no Josef kon dey rule.
19 "E disiv and sofa awa pipol sotey e fos dem to liv dia shildren mak dem die.
20 "Na dat taim dem born Mosis and God kon laik am wel-wel. Mosis stay for en papa haus for onli tiri monts
21 and wen dem trowey am for riva, Fero dota kon tak and train am as en own pikin.
22 "So dem tish Mosis all di wise tins wey Egypt pipol dey du and e kon get wisdom for haw e dey tok and wetin e dey du.
23 "Bot wen forti years don rish, e kon tink am sey e gud mak e go visit en own Izrel pipol.
24 "Wen e si won man from Egypt dey opres won Izrel pesin, Mosis kon difend and kil di Egypt man.
25 "E tink sey en own pipol go undastand sey God won yuz am tak save dem, bot dem nor undastand.
26 "Di next day, Mosis si tu Izrel men dey fite and e won trai setol dem. So e tel dem, 'My pipol, una bi brodas, why una kon dey fite unasef laik dis?'
27 "Bot di man wey dey opres en broda kon sey, 'Hu giv yu pawa to rule and joj us?
28 'Hope yu nor won kil mi di way yu kil dat Egypt man yestiday?'
29 "Wen di man tok laik dis, Mosis run go Midian, anoda land wer e stay as strenja kon born tu boys for der.
30 "Afta forti years don pas, won angel apier to am for insaid desert for Mount Sinai, wer won bush for dey burn.
31 "As Mosis si dis tins, e sopraiz wel-wel and wen e waka near mak e si-am wel, e hear God vois wey sey,
32 'Na mi bi di God wey yor gran-gran papa Abraham, Izik and Jakop dey woship.' Mosis start to shake and fear nor let am luk tu mush.
33 "Bot God tel am, 'Mak yu pul yor shu komot from yor leg, bikos di place wey yu stand so, na Holi Groun.
34 'I don si as my pipol dey sofa for Egypt and I don hear as dem dey krai, so I don kon save dem. Mak yu kom, bikos I won send yu go Egypt bak. '
35 "Dis Mosis wey dem rejet and ask sey, 'Hu mak yu awa oga and joj', naim God kon send mak e bi oga and savior tru di angel wey apier to am for bush.
36 "Na dis Mosis lid dem komot from Egypt. E stil du plenti mirakols for Egypt, di Red Sea and insaid di widanes for forti years.
37 "Na dis Mosis tel Izrel pipol sey, 'Na from among una God promis sey, E go raiz-up won profet wey go lid una. '
38 "Na dis same man dey wit di pipol for widanes, wit di angel wey tok to am for Mount Sinai, wit awa gran-gran papa dem and e kon risiv God wod for una.
39 "Bot una papa nor gri obey am. Insted, dem nor ansa am, bot dem shange dia maind sey dem won go Egypt bak.
40 "Dem kon tel Aaron, 'Mak yu du juju for us wey go lid us bikos, wi nor no wetin don hapun to Mosis!'41"So dem mak image wey bi laik melu, sakrifias gi-am kon bigin serv di melu wey dem tak dia own hand mak.
42 "God liv dem mak dem woship stars to mak wetin Profet Amos tok, hapun sey, 'Izrel pipol, una tink sey na mi una dey serv wen una dey sakrifais anima for insaid widanes for forti years? '
43 'Na bikos of di haus wey una build for "Molech and Refan", wey bi una god and juju wey una dey woship, naim mak mi send una go bi slave for Babylon. '
44 "God giv di tabanako to awa gran-gran papa dem, di haus wer dem go for woship am, jos as E sey mak Mosis build am.
45 "Afta, awa gran-gran papa dem kari di tabanako wey God giv dem wit Joshua kon driv all di oda tribes and tak dia land til di taim wey David bigin rule Izrel.
46 "God favor David wel-wel and e sey e go build haus for God
47 bot na Solomon en pikin kon build am.
48 "Wi no sey God nor dey stay for haus wey humanbin build, jos as di profet tok,
49 'Hevun na my chair and na di eart I dey put my leg, so wish kaind haus una go fit build for mi or wish kaind place I go stay?
50 'Nor bi mi mak all dis tins by mysef?'
51 "Si haw una stuborn! Jos as una gran-gran papa dem bi, na so una stil bi tu, bikos una don mak una heart strong to disobey God!
52 "E get eni profet wey una gran-gran papa dem nor kil? Dem ivun kil di mesenja wey tok bifor sey, 'Di Raitious Man go kom and una go gi-am to wiked pipol and dem go kil-am.
53 "Na una risiv God law wey E send tru en angels, bot una nor obey am."
54 As di kansol membas hear all di tins wey Steven tok, dem kon dey ves wel-wel.
55 Bot Steven, wey God dey yuz wel-wel, luk strate go hevun kon si God glori and Jisos Kraist wey stand for God rite hand.
56 Naim e shaut, "Luk! I si hevun wey opun and I si Jisos Kraist, God Pikin, stand for en rite hand."
57 Bot di pipol klose dia ear bigin shaut and all of dem kon rush am.
58 Wen dem don drag am go outsaid for di Tempol, dem kon start to dey stone am, den dem kon pul all dia klot giv won man wey dem dey kol Sol, mak e hol.
59 As dem dey stone Steven, e kon pray, "Oga, Jisos Kraist, mak yu risiv my spirit."
60 So e fal for groun kon shaut, "My Papa, abeg, mak Yu nor kount dis sin against dem." Wen e tok so finish, e kon die.