Nigerian Pidgin Bible
Acts 28
1 Afta wi don rish land and nobodi die, wi kon hear sey, na Malta dem dey kol di island.
2 Di pipol wey dey stay for der trit us wel. Dem mak fire for us, bikos rain don start to dey fal and kold dey kash us.
3 Wen Pol dey gada plenti stick mak e put insaid di fire, won snake wey dem dey kol, "Viper", kom out bikos of di heat kon put e mout for Pol hand.
4 Wen di pipol wey dey stay der si sey di snake put e mout for Pol hand, dem kon dey tel demsef, "E bi laik sey dis man hand nor klin! Ivun doh e nor die insaid sea, hand don stil tosh am for here!"
5 Bot Pol shake di snake komot from en hand enta di fire and nor-tin du-am at-all.
6 Bot dem dey tink sey en bodi go swel-up or e go fal for groun die. So afta dem don wait for somtaim kon si sey nor-tin hapun to am, dem kon shange maind sey, �Pol na god. ��
7 Dat taim for dat aria, Publius, wey bi di oga, get som land. E welkom us kon giv us fud for tiri days.
8 Publius papa kon get fiva and en bele dey pain am. Pol go si-am kon heal am.
9 Afta dis don hapun, meni pipol wey nor wel for der kon stil kom and e heal dem.
10 Dem kon dey praiz us wel-wel and wen wi won go, dem giv us evritin wey wi nid.
11 Afta wi don dey der for tiri monts, wi kon enta ship from Alexandria wey stop for di island for kold taim and sign wey dey di ship front, na "Twins god".
12 Wi stop for Syracuse kon stay der for tiri days.
13 From der wi kon rish Regium and afta won day, won kaind briz from sout kon start to dey blow and di sekon day, wi kon rish Puteoli.
14 For der, wi si som brodas and dem kon beg us to stay wit dem for sevun days. Na so wi tak rish Rome.
15 Wen di brodas for Rome hear abaut us, dem waka ontil dem rish "Appius Forum" and di "Tiri Taverns" kom mit us. Wen Pol si dem, e tank God and di tin kon mak en heart strong wel-wel.
16 Wen e enta Rome, dem alow Pol stay e own haus wit di sojas wey dey gaid am.
17 Afta tiri days, Pol kol all di Ju pipol oga dem togeda. Wen dem don gada, e kon tel dem, "My pipol, ivun doh I nor du enitin against awa pipol or awa gran-gran papa dem tradishon, from Jerusalem naim dem turn mi to prizina kon kari mi giv Rome pipol.
18 "Wen dem don kweshon mi, dem won riliz mi, bikos dem nor si enitin wey go mak dem kil mi.
19 "Bot wen di Ju pipol nor gri mak dem fri mi, di tin kon mak mi sey, I won go Rome mak Caesar for joj my kase, nor bi bikos I get enitin wey I dey komplain against my pipol.
20 "Bikos of dis, I kon sey I won si and folo una tok first sey, na bikos of di hope wey Izrel get, naim mak dem yuz dis chain tie my hand so."
21 Di pipol ansa, "Dem nor send us eni leta abaut yu from Judea and no won for awa brodas don kom from der kon sey yu dey du bad tins.
22 "Bot wi go laik to hear wetin yu dey tish from yor own mout, bikos wi no sey evribodi for di hol wold dey tak mout kondem dis grup wey yu dey insaid."
23 Dem kon gri for di day wen dem go mit am and dem plenti wey kom en haus kon mit am. So, from mornin til evenin, Pol kon dey explain tins giv dem. E dey tok abaut God kindom and dey trai to show dem wetin Mosis law and di profets tok abaut Jisos Kraist.
24 Som of dem biliv wetin e tok, bot som nor biliv.
25 So dem kon go, bot dem nor gri among demsef afta Pol sey, "Di wod wey di Holi Spirit tok tru di Profet Isaia na tru
26 sey, 'Una go mit and tel dis pipol sey, "Una go dey hear, bot una nor go undastand, una go dey luk, bot una nor go fit si.
27 'Una heart nor dey undastand, una ear nor dey hear wel again. Devol don klose una eye, mak una nor for fit si; hear wit una ears or undastand wit una heart, so dat una nor go fit turn kom mit God, mak E for heal una.'
28 "So mak una no sey, dis salvashon wey God bring, dem don kari am go mit Gentai pipol, bikos dem go asept am!"
29 Wen e tok finish, di Ju pipol kon liv der dey ves among demsef.
30 So for tu ful years, Pol stay der for en own haus wey e rent and e welkom all di pipol wey kom mit am
31 kon dey tel dem abaut God Kindom. E tish dem wit strong heart abaut Oga Jisos Kraist and nobodi fit stop am.